+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Warri Concert: Mata Never Rest For Monie Wey Davido Kolet But Nor Sing

With all di fight wey dey happen with Brown Hill Event wey organise Warri again show and singer David Adeleke aka Davido wey nor gree come perform,  pipo don tok both good and bad full ground say make di singer return di $94,600 wey dem pay am.

Some pipo dey argue say wetin Davido do not make sense while some dey say wetin hin do nor bad.

Di tin don so waka for social media sotay one pesin write dey bomblast Davido say if na US e take happen weda he nor go return di monie.

“If say awa Nigeria Judiciary dey work, Davido nor for get mouth dey make for social media. I doubt say he for nor even fit open he mouth dey tok if na US he take miss show. But he knows say na Nigeria and notin go happen. Na shame be dis. How pesin go pay you for work you nor gree do am and wey dem call you, you start to dey threaten di pesin. Na shame you dey rob for awa judicial system? Cus Naija don be man know man.”

Anoda pesin come still write say “Nigerian artists dey always feel say dem big law. Naw he Davido don dey tok rubbish about say he go dash di monoe two times to charity. David you make big mistake for dis one.”

[Vanguard/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM