+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Viral Debate Against Govimet, We Go Punish Di Teacher and Principal Wey Allow Am — Niger Govt

Di video of that boy wey do debate about di way voting be for Nigeria wey every bodi dey salute hin courage, di Govimet of Niger State say why di skool principal and teacher go allow that kind debate wey dey caise Nigeria leaders.

Di govimet say dem wan do investigation to and set discipline action to punish di skool.

Di student name na AbdulKabir AbdulKadir from Kasim Primary Skool wey dey for Agaie. Last week di boy video fly for e debate as he dey use vex take dey drop points of wetin dey happen for di kontri.

AbdulKadir tok on opposition to compulsory voting for di nation, say pipo don even lost hope for voting cus of corrupt leaders.

But wetin di skool boy tok, pitch govimet for bodi nai di Ministry of Basic and Secondary Education for Niger State send statement tru dem tokpesin, Jibrin Usman-Kodo say dem nor like that kind debate.

Di govimet say na di kind of raw word wey di boy use nai make dem dey vex.

“We shock to see di kind word wey dey come out from di boy mouth inside di video, e just show say na harsh word dem take coach di boy to use for di presentation.

Di commisoner come say dem must investigate to know di pipo wey teach di boy how to use those kind harsh strong word and dem go punish di pesin.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM