+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Bring All Students Wey Bandits Tiff, Govinor Sani Uba Assure Kaduna Community

Na 312 students nai bandits don kidnap from LEA Primary and Junior Secondary School located wey dey for Kuriga, Chikun Local Government Area for Kaduna State.

Nor be only di students nai di bandits tiff as di skool principal still dey with di bandits according to reports.

125 secondary students with 187 from primary section nai di bandits tiff on Thursday.

One teacher, Sabi Abdullahi wey run from di hand of di kidnap nai come dey narrate wetin hapun give Govinor Una Sani of di State how he and 25 students take run come back.

He say as he enta office to sign time wey he take come nai dem start to hear noise of bandits before dem know, di terrorists don match all of dem enta bush, na as some of dem dey di bush nai dem take luk for way run .

As di teacher escape nai he run enta community go tell di local vigilante group, dem start to find di pipo and that process bandits kill one of di vigilante.

Wey Govinor Sani hear everytin , nai he tell di community say make dem nor fear again as di children wey bandits tiff go come back by God’s grace since di National Security Adviser (NSA), Malam Nuhu Ribadu dey on di rescue mata.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM