+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Karey BBC To Court For Report Of Tinubu Certificate – Atiku’s Aide

Peoples Democratic Party and Atiku Abubakar say dem wan karey BBC go court cus of di report wey dem give about di certificate of President Bola Tinubu.

Na Phrank Shaibu wey be di special assistant for Public Communication to Atiku Abubakar wey dem dey do 2023 election take tok so for on Channels TV program.

Shaibu say dem don take up di mata with BBC top management to know di next step.

“Wey dem say na BBC report, I just laugh. Di three young pipo wey write di report, no dey even work with BBC. Dem own just be like to check fact. Like one of dem na Olaronke Alo wey dey work with TVC for 2019 and na President Bola Ahmed Tinubu nai get am.

“We nor nid dem story to know where to put am. Only di first paragraph don you say na from Phrank Shaibu hand dem take get am, na one of di reporters nai tell me to send am to her.

“Na disame report nai say wey dem dey try to reach Atiku team, we nor gree ansa. We don take di mata up with dem top management and don write petition to BBC cus na dem allow dem to use dem platform for dis kind tin.”

[Channels TV/SA]

 

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM