+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We No Want Make Niger, Mali, Burkina Faso Suffer Nai Make we Komot Ban – ECOWAS

Na cus of say wey want make peace, unity and security dey for di region nai make we sorry for Mali Burkina Faso and Niger Republic to komot di sanction from dem head.

Dis na di new update wey di Economic Community of West African States, ECOWAS  drop on Saturday from di mouth of di President of di Commission, Dr Omar Touray afta all Govimet of ECOWAS and Heads of state do meeting finish for Abuja.

Touray say since na period of Lent nai be dis and Ramadan go soon come e nor go good make dem still punish di teree kontris, plus say top leaders like Dem Gen. Yakubu Gowon come still beg dem.

He say as di kontris dem komot e go hard for dem to get anytin from international community where dem take dey get epp and e go dey very bad for di region.

And nor be only that one, di teree kontris nor go dey use  ECOWAS passports again and brown card vehicle insurance. Though say wetin dem dey contribute to ECOWAS market no too big e go still make di market small wey dem komot.

Ontop of that one Touray say all dis tins wey ECOWAS resin come lift di ban na to make dem fit sell wey and projects like di Regional Food Security so that di teree Sahel nation go benefit from di projects.

If dem nor komot di ban from Mali, Burkina Faso and Niger and di work wey ECOWAS wan do wey pas 500 million dollars go just lost like that.

Make di 130 pipo wey dem get work with ECOWAS nor come dey go tik of where dem wan take find work, cus e go hard for di 77 pipo wey dey work with ECOWAS from Burkina Faso, 23 of dem from Mali and 32 from Niger.

All dis na wetin Touray epp di bloc list wey make dem reconsider to komot di ban from Mali Burkina Faso and Niger.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM