+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Melu Owner Bring Police To Arrest Committee Seketary For Kwale

Police headkwata for Abuja send dem men to go arrest one Mr Ikechukwu Ezechi wey be di Seketary of Delta State Livestock Management Committee (DSLMC), for Kwale, inside Delta State.

Na wey Alhaji Musa wey dey train melu for di community nai go meet police make dem arrest Ezechi afta di community tell am to pack komot from dem village.

Pipo say Ezechi and Musa nor dey see eye cross di same road cus dem don tell Musa make hin komot from Umusam Ogbe community for Kwale cus of di way he nama dey destroy pipo farm, but he still not gree hear.

Na base on law wey govimet put two years ago so that gbege nor go dey happen with farmers and pipo wey get melu, nai di seketary take tell Alhaji Musa make he dey cage he melu.

Even di coordinator for DSLMC for Delta North Senatorial District, Mr Matthew Ujene, confirm say Musa go complain give police for Abuja nai dem take come arrest their seketary.

He say, “We dey Nigeria Security and Civil Defense Corps (NSCDC) office for Kwale wey Musa call say he wan bring one of hin boys wey tiff e melu. Nai I tell am to bring am say I go tell di Divisional Officer of NSCDC make  e handle di mata.

“I dey inside while di seketary, Ezechi, dey outside. Then one Siena come drive enta before you know, some officers don come down arrest di seketary.

“Di officers say dem be from force headkwata Abuja, come enta di civil defence office dey look everywhere.

“Dem say na me dem  come arrest cus na me dey mobilize di community to come kill di melu and dey tell di village pipo to purse Musa komot from di town.

“But e get other pipo wey dey train melu wey gree say dem go pay for di scatter wey di melu destroy pipo farm for Umusam or dem go komot if dem nor fit pay. But instead Musa go bring police to scatter di whole arrangement.

“Dem say na di anti-open grazing law nai I dey use oppress dem, but now na dem dey bring police from Abuja to oppress us,” Na wetin Ujene coordinator of DSLMC tok.

Seketary of Umusam Ogbe Community Development Committee, Mr George Enubuzor, say dem don call Musa tire for peace but e nor dey gree come.

Enubuzor say dem get agreement with Musa say make hin komot from di community and he gree but he come back for meeting wey dem do for Okpala-Uku’s palace to come beg dem, only for am to come back with police to come arrest di seketary.

NSCDC confirm di arrest, then tokpesin of Delta State Police Command, Bright Edafe, say na Abuja headkwatas nai come do di arrest not be dem.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM