+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Stop to look dem one kind-Uroye

Chairmo for d House Committee on Health for Delta State House of Assembly, Dr. Augustine Uroye don talk say him and 24 other members of the House, sponsor the Delta State Anti Discrimination and Protection Bill 2020, to end stigmatization and discrimination against people wen dey live with HIV / AIDS for the state.

Wen Dr. Uroye, d member wen dey represent Warri South Constituency 1 for the State House of Assembly dey yarn for one interview, he come talk say d way wen people take dey treat and d look people wit d disease one kind, don make dem no dey see better result for d gbege against HIV / AIDS for the country.

The lawmaker, when present the bill during their meeting come talk say Naija get the second largest HIV / AIDS status for the world unto say we get 1.8 million positive cases, according to survey.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM