The National Emergency Management Agency (NEMA) don start to dey share relief items dey give victims of 2020 flood disaster for Ndokwa East and Ndokwa West Local Government Areas of Delta State. Na the Director General of NEMA, Muhammed Mohammadu wen be retired Air Vice Marshal nia flag off the exercise for Kwale for Ndokwa West local government area of d state. Meanwhile, the NEMA Edo Operations Office before go soji the affected areas to really know d impact and amount of properties wen destroy beocs of the flood.
Release the barber wen una arrest-Abba Moro
The Senator wen dey represent Benue South Senatorial District for the National Assembly, Abba Moro don begin dey ask for the unconditional release of Elijah Odeh, one young barber from him constituency wen dem hold for Kano State becos of hairstyles wen he barb. Wen Moro dey yarn for one statement thru him media office for Abuja on Sunday, he come talk say dem arrest the barber becos he barb different hairstyles for him customers, when according to dem na offence to Islam. Moro come talk say na one group of muslims nia arrest Elijah some few days back becos the hairstyle wen he design for d head of two of him customers na insult to Islam and the Holy Prophet Mohammed (SAW). He come talk say dem no gree give d man bail undermining say the Governor of Benue State, Samuel Ortom, and Kano state Governor, Abdullahi Ganduje don shook mouth put for d matter.
Ebola don show face for Congo again
The Democratic Republic of Congo (DRC) don announce one new case of the Ebola virus, months after them declare say d outbreak don over for the Central African country. The DRC ministry of health announce on Sunday say the patient, when don mod since kpake the virus for Butembo, one city for North Kivu province. The World Health Organisation WHO come talk say e no dey unusual for cases to increase after any major outbreak”.
Covid-19: New cases drop for Naija
Naija daily count of coronavirus infections drop go e lowest for more than one month with 506 new cases wen dem confirm on Sunday. The Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) say dem record the new cases for inside 20 states. The last lowest daily count na on January 2, when dem confirm 576 samples wen dey positive for the virus. Meanwhile, the 506 fresh cases don carry the total number go 139,748. Whereas na 20 people nia legoo within 24 hours, and dis one so come carry the number of deaths go 1,667.
Ministry of Agriculture don flag off rabies vaccination
The Ministry of Agriculture and Natural Resources wen collabo with the Federal Ministry of Agriculture and Rural Development don flag off the 2020/2021 Rabies Vaccination Campaign and the distribution of biosecurity inputs to pig farmers and poultry marketers for across Delta State. Delta State Commissioner for Agriculture and Natural Resources, Hon. Julius Egbedi when perform the flag off for Asaba come talk say the programme come dey necessary in order to stop the outbreak of different animal diseases like rabies for dogs and cats and other animals for the State. Hon. Egbedi come still talk say the State Government don provide some disinfectants and motorized spraying machines wen dem go share give pig farmers for the state after the outbreak of African Swine Fever for the second and third quarter of 2020. He come talk say dem go distribute d inputs through the Area Veterinary Officers for across the 25 local government areas of the State becos of the COVID-19 preventive protocols, and dis one na even as he say poultry farmers and marketers go benefit from the level. Meanwhile, the Delta State Director of Veterinary Service, Dr Charles Diai wen yarn for d occasion come talk say the World Health Organization (WHO), don propose the end of rabies by the year 2030, even as he come tell the beneficiaries to make use of the input wen dem dey receive den he come still Deltans to bring their dogs and posi for vaccination.
Brighton sama Liverpool 1 kondo
Brighton blast Liverpool 1 kondo on Wednesday night for d game wen shele for Anfield. Na Steven Alzate nia down d only goal for the Seagulls, when don play four league matches now without losing any.
University workers start strike today
Senior Staff Association of Nigeria Universities and the Non-Academic Staff Union of Educational and Associated Institutions don write their branches to start strike from TODAY (Friday). One copy of the notice touch news people hand on Thursday. Meanwhile, dis latest development show becos d recent talk wen play between the leadership of the unions and government no get head.
Buhari dey wit herdsmen- Ortom
Based on d tension wen dey continue to dey dey becos of the famers and herders gbege for some parts of the country, Samuel Ortom wen be d governor of Benue state don talk say President Muhammadu Buhari promise to be for all Nigerians but say wit d way things dey now, e clear say na d Fulani herders nia he dey wit. You go remember say for oga Buhari inaugural speech when he enter power for d year 2015, talk say he dey for everybody and he belong to nobody”. But wen Ortom come dey address one press conference for Makurdi on Wednesday, he come talk say nothing dey show say the president dey represent the interest of all Nigerians.
Buhari don Extend IGP tenure with 3 months
President Muhammadu Buhari don extend the tenure of Mohammed Adamu as the inspector general of police (IGP) by three months. Na Mohammad Dingyadi wen be d Minister of Police affairs nia confirm the development give state house correspondents on Thursday for the presidential villa, Abuja. According to the minister, the president say he extend the tenure so dat dem go fit get enof time to take select d right person wen go take over.
Internet subscribers don reduce for Naija
Naija mobile internet subscribers decrease by 563,837 for December, with the total number of Internet users wen drop go 153.87 million from 154.43 million for November 2020. Latest figures from the Nigerian Communications Commission still show say broadband subscription fall by 0.12 per cent, from 86 million for d month of November go 85.9 million for December. The NCC mobile Internet subscriber data come still talk say na MTN mobile Internet subscriber base nia reduce pass go 65.35 million for December from 65.76 million for November, and wit dis record so, dem lose 408,444 subscribers.