Based on the gas wen explode dis past weekend for Agbor, the Delta State government don talk say dem go rub mind with state House of Assembly to put law wen go regulate where people dey put gas plant for across the state. Governor Ifeanyi Okowa yarn dis one dis past weekend even as he confirm am say na four people nia kpeff from d gas explosion den nothing less than 11 people nia dey for hospital becos of d burns wen dem get from the explosion. He come talk say the fire okamuka na very painful something.
Bello statement no be true- NGF
The Nigeria Governors’ Forum (NGF) don talk say d tin wen Yahaya Bello, d governor of Kogi talk say COVID-19 vaccines dey “meant to kill” no be true. Bello wen dey steadily dey lock up COVID-19 protocol becos to am the virus no dey exist, clear one crowd for one viral video say make dem reject the vaccines. But wen Kayode Fayemi, wen be d governor of Ekiti state and the NGF chairmo dey yarn for inside one statement after the forum first online meeting for 2021 on Thursday, he come talk say Bello comment no just get head.
Naija record 1,964 new koro cases
Nigeria reach their latest single-day record on Thursday with 1,964 fresh coronavirus infections wen dem confirm for across 23 states and the federal capital territory (FCT). The development dey happen less than one week after the previous highest daily record. The Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) confirm the new positive samples for their update for January 21, 2021, and dis one so don make am the 18th day back to back wen the country don record more than 1,000 new cases.
I dey satisfied with the work-Ovuzere Macaulay
As the new rainy season don dey come, Director General of the Warri Uvwie Environmental Development Agency WUEDA, Comrade Ovuzere Macaulay don talk say he dey satisfied wit the level of Work wen d contractors wen dey handle the Underground and surface derange system for the Warri, Effurun and environs dey do. Wen Macaulay dey yarn after he don visit the project sites for 3rd Marine gate, Esisi road, Ugbolokposo plus including Commissioner road on Thursday, he come complain about the time wen don loss becos of the COVID-19 lockdown in 2020. He come sha talk say the project go surely address the issue of flooding. Macaulay come las las talk say the state governor Dr. Ifeanyi Okowa dey committed to complete the project.
Follow the law-Okowa tell DSLCA leaders
Governor, Ifeanyi Okowa don tell authorities of Delta State Local Content Agency to dey transparent and say make dem dey follow d law even as dem carry out their operations so dat dem go fit do wetin dem suppose do. The governor give the charge on Thursday for Asaba when he dey inaugurate the Director-General of the agency, Mr. Morris Idiovwa. Even as he dey tell the director-general to dey transparent and to also focus on the goals of the agency, he come talk say na local content nia be the value wen companies or industries carry go national and sub-national economies.
We no go fit restructure if we no deal with our challenges- Goodluck Jonathan
Before before Presido Goodluck Jonathan don talk say dem no go fit restructure Naija if dem no address the challenges wen dey divide d country. Wen oga Jona dey yarn on Thursday for Abuja, he come talk say the restructuring of Naija into 12 states by Yakubu Gowon after the civil war na to protect Naija make e for no divide. He come talk say Nigerians don senior up wit d calls for restructuring because the federal system of governance wen British handover give Naija no fit accommodate d issues for the nation again.
Joe Biden don remove Naija-US ban
US President Joe Biden don lift ban wen d before presido Donald Trump put on Naija not to enter d country. According to the New York Times, Biden reverse the ban for him first day for office den he come direct the State Department to restart visa processing for people wen be from the affected countries. The matter na say Trump place the ban on immigrant visa on Naija and six other countries after he expand him immigration policies wen don cause plenty talks.
We spend N5.92b,we no produce anything-NNPC
The Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) don talk say their three refineries spend N5.92 billion as expenses for September 2020 and dem no produce any single thing. According to their September 2020 Financial and Operations Report, them no produce anything becos of d on-going repairs wen dey happen for the refineries. The NNPC for update for September 2020, say the three refineries no process any crude and d combined yield efficiency na 0.00% becos of d repairs wen dey go on for the Refineries.
Buhari re-appoint Hadiza Bala Usman as NPA director
President Muhammadu Buhari don reappoint Hadiza Bala Usman as Managing Director of Nigerian Ports Authority, for another five years. Na Femi Adesina wen be the special adviser to the president on top media and publicity nia announce Bala Usman reappointment for inside one statement on Thursday. Meanwhile, dem first appoint Usman as the managing director of the NPA for d year 2016.
No block any line until February 9- Buhari
President Muhammadu Buhari don order telecom operators say make dem no block any subscriber until February 9, 2021. Them for don block subscribers their sim cards on January 19, but dem come beg for more time so dat dem go fit link their SIMs to their National Identity Number, NIN. You go remember say on December 15, 2020, the Federal Government talk say after December 30, 2020, dem go block all SIMs wen no dey registered with valid NINs.