Delta State Independent Electoral Commission don fix March 6, 2021 as date wen dem go take do elections for chairmanship and councillorship positions for the state. Na d chairmo of the Commission, Michael Ogbodu nia make the announcement after he don meet with stakeholders and party chairmo dem on Tuesday for Asaba, the state capital. Ogbodu come talk say dem create additional 34 wards to add to the existing 466 wards for across the 25 local government areas for the state.
Former Senate presido petition President Buhari
Before before Senate Presido Anyim Pius Anyim don petition President Muhammadu Buhari, d Inspector-General of Police Mohammed Adamu and the Department of State Services (DSS) concerning d alleged plan wen he say dem get to kill kpuff am becos he no gree shift comot from the Peoples Democratic Party (PDP) enter the All Progressives Congress (APC). Anyim wen complain d complain for one open letter come talk say na Ebonyi State Governor David Umahi nia dey behind the plan. He say Umahi accuse some leaders for the state for one media briefing on November 27, after one legit State Security Council meeting say dem dey use cultists and members of the Independent People of Biafra (IPOB) wen dem don ban take dey kpuff and dey cause better casala for the state.
Senate tell Buhari say “sack service chiefs”
The Senate don tell President Muhammadu Buhari to sack service chiefs as dem don fail to secure Nigerians. The Senate decision wen be the third wen dem go pass this year show after Senator Kashim Shettima raise d motion based on d way wen boko haram badoo dem take kpuff 43 rice farmers for Borno State. Dem come tell oga Buhari to replace the security chiefs with new ones immediately.
Senate confirm Mahmood Yakubu as INEC chairmo for second term
The Senate don confirm the appointment of Prof. Mahmood Yakubu, as Chairmo of the Independent National Electoral Commission for the second term of five years. The confirmation show after d Senate Committee on INEC don torchlight d report wen Senator Kabiru Gaya lead. The senators, when yarn before Yakubu confirmation come talk say he dey over qualified for the job.
Borno Massacre: We tell dem, dem no do anything
One of those wen survive for the recent attack wen boko haram attack farmers for Borno state don talk say the villagers clear the military about d attack but dem no gree do anything. Authorities don confirm am say na at least 45 farmers nia members of the Boko Haram sect kpuff for Zamarbari area but the UN say kakaka, say the number of those wen denkwes pass 100. Den for inside one report, news people quote Abubakar Salihu, one of the survivors wen say dem get signal about the attack after dem cramp one of the Boko Haram members.
Dem spoil our effort-Army
The coordinator of Defence media operations, Major Gen. John Enenche, say some people wen dey long side for Borno state spoil the efforts of the military, say dem give boko haram badoo dem informate about their movement and activities. Na on Monday nia Enenche take yarn this one wen he dey answer questions wen get to do wit the killing of 45 farmers wen these bad guys dem kpuff. According to aproko wen dem gather from the attack, some of the bad guys don already dey relate well with the villagers before the attack.
Boko haram dey use Naija take shine
Lai Mohammed, d minister on top information and culture don talk say Boko Haram dey use Naija take dey shine because the country no get better weapons to take gbege d badoo dem and dis one after Suspected Boko Haram members legoo nothing less than 45 farmers. According to the United Nations, d attack na “the most violent attack” wen dey targeted at civilians for d year 2020. Wen Mohammed come dey yarn on Monday wen he go visit Samuel Ortom, d governor of Benue state, he come talk say the killings wen happen for Borno state na unfortunate event.
Uroye open empowerment parol for Warri south
The member wen dey represent Warri South Constituency, Hon. Augustine Uroye don empower more than 120 Constituents with financial sums of 11 million naira. The beneficiaries come from the six wards wen make the constituency. Wen Hon. Uroye come dey yarn for the event wen House of Representatives member Thomas Ereyitomi, before before Delta State health commissioner Joseph Otumara and other major stakeholders attend for Waffi, he come talk say dis exercise na part of the electoral promise wen he make give the people and say na efforts to take support the governor Ifeanyi Okowa wealth creation initiative. The Lawmakers come still register 12 youths for oil and gas training program for WAWE International, say once the youths graduate, jobs don already dey dey wait them.
We go bring NIN for vehicle registration come 2021- FRSC
Boboye Oyeyemi, Corps Marshal, Federal Road Safety Corps (FRSC), don talk say the corps go introduce the National Identity Number (NIN) information for vehicle registration by the first quarter of 2021. Mr. Oyeyemi yarn dis one wen e mark present for the News Agency of Nigeria (NAN) Forum for Abuja. The corps marshal come talk say the essence of the NIN na to make sure say d road dey safe through the use of technology. The FRSC boss come still talk say as from December, dem no go dey give driver’s license again without the NIN information.
Super Eagles no get natural offensive midfielders- J.J Okocha
Before before Super Eagles capo Austin Okocha don talk say the current team no get ‘natural’ offensive midfielders. Okocha say he believe say the Eagles need mid-fielders wen go fit get the ball and den pick pass plus deal wit the opposition steadily. Gernot Rohr for the last one year play Alex Iwobi and Joe Aribo for the number 10 role for the Eagles but d two players neva perform well for their recent games. Okocha come still talk say he dey convinced say Rohr don make positive impacts on the national team, considering where he take meet the team when dem hire am four years ago.