The Lekki Concession Company (LCC) don submit one video recording wen their surveillance cameras dub on October 20, 2020 give the Lagos judicial panel on #EndSARS. Abayomi Omomu-wansa, managing director of LCC wen submit d video give the panel on Tuesday, come talk say the cameras stop to dey work from 8pm for the night wen the shooting take happen for the Lekki tollgate. The shooting according to reports start around 7pm. The company come still talk say light no dey on that night of d shooting because dem withdraw their staff from office locations and so dem no come fit switch on backup generators wen light go off.
NECO don talk new date for SSCE exam
National Examinations Council (NECO) don announce the new date for the Senior Secondary School Examination (SSCE). The exam go start from Monday 9th 2020. NECO bin postpone the exam for October based on the gbege wen follow the #ENDSARS protest for some parts of the Country. For one statement wen Azeez Sani, the NECO Head of Information and Public Relation Division sign talk say “Based on say every every don normalize for naija states and FCT,the examination go continue now with new time table from on Monday 9th November 2020 to Saturday 28th November 2020. “This new timetable go dey available to everybody, schools and the students wen wan write the exam from on Wednesday 4th November 2020. “The timetable go dey very easy to download from the NECO official website wen be www.neco.gov.ng. “The Council dey thank everybody and those wen wan write exam based on say dem dey patient and understanding during the period wen SSCE take chop suspension. NECO dey give everybody assurance say we go deliver wella.
I no order Army to kpuff people-Wike
Nyesom Wike, the governor of Rivers state don talk say he no order the military to kpuff people wen dey long side for Oyigbo local government area of the state. Wike declare 24-hour curfew for Oyigbo on October 21 after gbege burst out from the EndSARS protest wen lead to the killing of some members of the army and the police. Meanwhile, people dom accuse the soldiers say dem kpuff peaceful protesters and say dem abuse human rights. Then tori wen come dey play na say Wike come give security agents say make dem dey go from house to house dey delete people. But wen Wike come dey yarn on Monday, he come talk say dis matter wen dey against am so no dey correct at all at all.
Delta State Panel of Inquiry don start hearings
Delta State Judicial Panel for police brutality and extra-judicial killings don start hearings from victims of police brutality and harassment for the state for their inaugural meeting on Monday. One Christopher Okpuru wen dey mourn on Monday con narrate give the Panel how operatives of the Special Anti-Robbery Squad (SARS) take arrest him son since August 2019 and up till now, dem no know where he dey. For the petition, Okpuru clear the panel say the security operatives arrest him 31-year-old son wen him name na Councillor and na so dem come hold am for the ‘B’ Division Asaba. Meanwhile, wen the chairmo of the Delta Judicial Panel, Justice Celestina Ogisi dey yarn for the inaugural speech, she come talk say “The panel go dey fair to all those when go bring their complain before dem, den she come still talk say she go make sure say Justice go prevail.
Rearrange Niaja security-NDM tell Buhari
The Nigerian Diaspora Movement (NDM) don tell the Federal Government to rearrange Niaja security system with the view to addressing their security challenges. This tatafo dey for one statement wen their chairmo, Prof. Apollos Nwauwa, Director of Publicity, Mr. Kazeem Ojoye, and the Secretary-General, Femi Alofe gather body sign together for inside Abuja. The movement come still talk say dem dey concerned say jaguda dem hijack the #ENDSARS protest and dis one so come lead to the death of some protesters, while others come kpake injuries.
Buhari-I no support wetin dem do
President Muhammadu Buhari don talk say he no support the way wen security officials take attack peaceful protesters. The president make dis statement about two weeks after he address Nigerians and for the broadcast he no condemn the way wen security operatives take attack peaceful protesters. The matter na say, last month, security operatives use force, including live bullets, take call out follow protesters for many Nigerian cities such as Lagos, Abuja, Oyo and Delta.
WAEC don release 2020 SSCE result
The West African Examinations Council don release the results of the 2020 Senior Secondary School Certificate Examination. WAEC bin announce before now say dem go release the results today, November 2, 2020. According to reports wen reach us, dem postpone the release of the results before becos of d gra gra and destruction wen play for the country.
El Rufai: Time to restructure Naija na now
Nasir el-Rufai, the governor of Kaduna don talk say the time to restructure Naija na now so dat the sharing of pepper for the country go dey go well. Wen the Governor dey yarn for one public lecture to take mark the 50th anniversary of Arewa House for Kaduna, he come talk say to restructure the country nai go be the best thing to do to make sure say overall development dey for the country. He come talk say need dey to reorganise the country constitutional framework in order to give states more control over some kind osusu.
Sinach ‘Waymaker’ don win Song of the Year
‘Waymaker’, one song wen Osinachi Joseph, one Nigerian gospel singer wen everybody know as Sinach sing don receive the award as the ‘Song of the Year’ for the 2020 Gospel Music Association (GMA) Dove Awards. GMA wen dey celebrate make sense achievements for the Christian music industry, recently release the list of artiste wen win for different category for the 51st edition of their yearly award show. Among them na Sinach when top 12 other songs from global gospel singers to win the ‘Song of the Year’ prize.
Unknown fever don kill more dan 15 people for Delta State
Na more than 15 people nai don kpeff after the outbreak of one fever wen dem dey suspect say hemorrhagic fever for Ute Okpu and Idumesa communities for the Ika North East LGA of Delta state. Delta state Health Commissioner, Dr. Mordi Ononye wen yarn for Ute Okpu come talk say the state government don arrange one team wen go find out wetin the disease wen don swallow more than 15 people wen dey between18 to 25 years for the past two weeks really be. He come talk say result of the samples wen the Ministry of Health collect go give clear explanation about the disease and determine the next line of action.