The National Agency for Food and Drug Administration and Control NAFDAC don blacklist one Indian company Mars Remedies PVT LTD becos dem manufacture fake drugs for one pharmaceutical company wen dey for Lagos. Director-General of NAFDAC, Moji Adeyeye, when make the announcement for one statement wen she drop give news people come talk say the organisation don ban the importation of all d drugs wen the Indian company manufacture. According to the agency, the company illegally manufactured different types of ciprofloxacin tablets, instead of the approved formulation for export to Naija.
Bus drivers protest for Warri South
Some bus drivers for Warri burst enter the streets yesterday dey protest against the way wen the local government take remove the ban wen been dey on the sales of tickets for the local government area. This one dey happen barely 24hrs after the Warri south Local Government Chairmo Michael Tidi, lift the four days ban wen he place on the sales of tickets to commercial drivers after dem hold one stakeholder’s meeting on Sunday. Eyewitness reports come talk say the bus drivers protest for along the NPA expressway go reach the roundabout axis of the highway.
Leicester win Arsenal 1-0
Leicester city blast Arsenal 1 kondo for the premier league game wen dem play for Emirate stadium. This one happen after Jamie Vardy comot from bench come score for the 80th minute for the foxes. Meanwhile dis one nai be d first time wen the gunners dey lose to Leicester city for the Emirate stadium since 1977 and like dis dem dey for
SERAP tell ICPC: Investigate this palliative matter
The Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) don tell the Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) to investigate the circumstances wen surround all the COVID-19 palliatives wen report say our leaders hide for warehouses for different states, wen dem suppose to don share give the poorest and most vulnerable people during the lockdown. For the petition, the organisation come still tell the commission to publish the outcome of any such investigation. Meanwhile, SERAP petition show based on reports say some people don discover and den carry COVID-19 palliatives wen dey store for different warehouse for different states.
Government adjust curfew time for Lagos
Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu don adjust the curfew wen he put for the state again to stop the jigi jigi wen dey for d state becos of #EndSARS protests against police brutality. Sanwo-Olu been reduce the 24-hour curfew on Friday to start from 6pm to 8am. But for one notice wen him Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotoso drop on Sunday evening, the governor say the time for the curfew now na between the hours of 8pm and 6am, meaning say people wen dey long side for Lagos state go fit go out by 6am and return back to their houses before 8pm.
Jaguda burst government food store
Just like for many other states, jaguda people don break enter where government dey store to go kpake food items for Yola, Adamawa State. On Sunday, many people break enter one food storage facility wen dey for Kwanarwaya, near Sangere for along Numan road and na so dem tiff food items. For one video wen trend online, na so many of d people wen go pack the food items dey hala others say make dem rush come collect their share.
Jaguda burst Yakubu Dogara caban
Reports say some jaguda dem attack the caban of Yakubu Dogara, before before talk talk person for the house of representatives, for Jos wen be Plateau state capital. According to the reports, the people attack the bonk wen dey for near Jos University Teaching Hospital yesterday morning. This one so dey happen even with the 24-hour curfew wen the state government announce in order to end the gra gra wen dey spread for the state. The tori wen dey reach us na say the guys wen scatter the house been dey look for COVID-19 palliatives.
Gov. Okowa: Make we start to correct the wrongs
Governor Ifeanyi Okowa don call on all leaders for the country say make dem rally and sharp sharp start d the process of correcting the wrongs for the society. Okowa yarn dis one for one condolence message wen he send give the youths for the country after some security agents shoot EndSARS protesters for Lekki, Lagos on Tuesday. For the message wen he personally sign, the governor say e dey obvious say we no go fit suppress the voice of the Nigerian youth. The governor come still beg the youths to give the Government time to think and den take action on their demands, say dem need “just small space’’.
Bola Tinubu: I no go ever be part of massacre
All Progressives Congress bros Bola Tinubu don talk say he no go ever be part of any massacre. Na today nai the before before Lagos State governor take yarn ds one for one telephone interview. He come talk say dis tin wen the Nigerian Army do so no make sense at all. Tinubu come still talk say he no get any investment for the Lekki Concession Company, the company wen dey manage the tollgate.
Order the soldiers dem arrest- House of Reps
The minority caucus of the House of Representatives don tell President Muhammadu Buhari to order the arrest and prosecution of soldiers when attack #EndSARS protesters for the Lekki Tollgate on Tuesday night. Wen the Minority Leader, Mr. Ndudi Elumelu dey yarn for one statement today, he come talk say he “strongly” condemn d way d security agents take attack “peaceful and unarmed” protesters for Lekki Tollgate and other parts of the country. The soldiers dem attack d protesters wit live ammunition after them remove d Closed Circuit Television Cameras and lights for d area