Naija for now dey for 131 position globally for the World Bank Ease of Doing Business ranking and dem move up by 15 places from their 2019 spot. Na the Bretton Wood institution nia release the report dis early mor mor. Na one comparison of business regulation wen dem carry out for 190 countries across the world nia form the basis of the ranking.
Banks say make telecom charge pipo directly for USSD
Nigerian banks don tell telecom companies to charge customers directly for USSD services, and dis one na according to one memo wen news people see. This one so dey against wetin bank CEOs talk on Monday as dem take say dem no get hand for d matter. For one letter wen the Body of Banks’ Chief Executive Officers (BOBCEO) send go give the Association of Licensed Telecommunications Operators of Nigeria (ALTON) wen carry September 16, 2019 as date, the bank MDs been propose one “orderly implementation” of end-user billing for bank customers, and dis one “align with the standard practice for USSD billing.” Them say the decision “on whether, and which amount, to charge any customer wen use USSD na totally that of the telco company, the same way wen dem take dey bill customer for calls, SMS and data”.
Corruption still boku for naija even as we dey fight
The Acting Chairmo of the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), Ibrahim Magu, don begin complain say corruption for Naija still dey much undermining d efforts wen dem dey put in to make sure say e end. Na for Abuja nia Magu for take yarn dis one for the EFCC-National Judicial Institute (NJI) capacity building workshop for justices and judges. He come still talk say need dey to review d proposal for d establishment of special courts wen go help to make our justice system dey deliver judgement sharp sharp.
National Assembly need to approve more osusu package
The Minister on top Labour, Employment and Productivity, Chris Ngige, don tell the National Assembly to approve more osusu for the ministry. Ngige make the request when he mark present before the Joint Senate and House of Representatives Committee on top Employment, Labour and Productivity on Monday. The minister come talk say increment for d allocation go helep to meet the ministry their operational needs.
Gracious David West don plead guilty to murder
Serial killer, Gracious David West, surprise many people for the Rivers State High Court yesterday when he plead guilty say he true true kpuff nine young women for different hotels. Dem finally carry West go court yesterday after he first appear before Justice Adolphus Enebeli on Monday without any lawyer wen stand for am. Meanwhile, during him parade for d month of September after him arrest, he confess say he don kpuff young women for Lagos, Owerri, and Rivers State.
Four nigerians don wonjur for xenophobic attack
Na four Nigerians nia don wunjor for fresh xenophobic attacks for South Africa. Na Adetola Olubajo, presido of the Nigerian Union South Africa (NUSA) nia confirm the attacks when happen for d Witbank area of Mpumalanga province, on Tuesday. Meanwhile, one week back, bad guys kpuff one Ikenna Otugo wen be Nigerian entrepreneur for Empangeni wen dey for the Kwazulu Natal province of South Africa.
90 billion pounds don enter UK hand for kukere waka
The United Kingdom (UK) dey receive about £90 billion wen people dey use kurukere way take dey move comot from Naija, Africa and countries for third world every year, and dis one na according to report wen show from Christian Erikson and Lionel Faull, anti-corruption advocates. The advocates drop dis tatafo for one joint paper even as dem collabo with The Corner House; MacArthur Foundation and the Open Society Initiative for West Africa (OSIWA) run d matter. Them say most of the pepper wen men dey move come dat way na from the third world, including Nigeria. According to them, 87,000 illegal assets wen dey for the UK wen companies wen dem no know get dey for tax havens, while the values of properties wen people secretly get for the UK dey between 56 to 100 billion pounds, with 40 percent of these properties for the city of London.
We nor direct MTN Nigeria to charge for USSD usage
Chief executive officers of deposit money banks for the country don talk say dem no direct MTN Nigeria to charge customers wen dey use unstructured supplementary service data (USSD) channels. For one joint statement wen dem release yesterday, the bankers say the charges on top financial transactions neva change. The CEOs come still talk say d tin wen MTN yarn say na the banks nia call for the charges no be true.
Make dem inaugurate new board for NDDC sharp sharp
As President Muhammadu Buhari give order for d forensic auditing of the Niger Delta Development Commission NDDC, before before Niger-Delta Militant, Gen. Akpodoro Israel don talk say need dey to sharp sharp inaugurate new board wen go take over the commission activities so dat d audit go fit go well. Gen. Akpodoro wen talk say he dey satisfied wit the type of people wen oga Presido don already appoint to take over the task of the region development, come beg for their inauguration to take over the affairs of the Commission.
Meeting dey hold because of fresh attack inside SA
Nigeria Consul General for South Africa don meet with the Police Command concerning the fresh wave of attacks on Nigerians for South Africa. This one happen based on d report wen show yesterday mor mor say dem don begin fresh attacks again on Nigerians wen dey long side for South Africa. According to reliable sources, the attack happen for Mpumalamga.