The federal government don remove some food items comot from the Value Added Tax VAT. This one na according to the 2020 national budget wen President Muhammadu Buhari present yesterday. Some of the items wen people no go take pay VAT, in addition to the pharmaceuticals, educational items, and basic commodities include brown and white bread, cereals, fish of all kinds, flour and starch meals. Others na fruits, vegetables, roots wen include yams and d rest, herbs, salt, milk, meat and water.
No pay for the worker wey nor dey IPPIS
President Muhammadu Buhari don talk say any Federal Government worker wen him name no dey for Integrated Payroll and Personnel Information System IPPIS by October 31st no go get him monthly salary. Oga Buhari yarn dis one wen he dey present the 2020 budget proposal dey give the joint session of the National Assembly for Abuja yesterday. He come talk say this one na part of the Federal Government efforts no manage personnel costs in line with their gbege against corruption.
Pensioners dey protest for their pension money
Pensioners for Delta State don protest about their pension wen dem neva receive for Asaba, the state capital. The pensioners ball enter the Government House for Asaba yesterday for four buses, and na so dem come dey shout say make the governor, Dr. Ifeanyi Okowa pay dem their pension. Wen Chairmo of d Association of Contributory Retirees, Comrade Agbaka Avurakoghene dey yarn wit news people, he come accuse the government say dem need to correct the N7,000 wen dem dey use take dey calculate their terminal benefit when no dey work again say becos d matter no dey help the retirees at all at all.
President Muhammadu Buhari say cold dey catch am
President Muhammadu Buhari don talk say cold dey catch am. Na wen oga Buhari dey present the 2020 Appropriation Bill give d joint session of the National Assembly for Abuja nia he for take yarn dis one. He come talk say he dey sick becos of d too much work wen he dey do as President of the country.
Another angle to the sex harassment scandal
Boniface Igbeneghu, one lecturer for the University of Lagos wen dem cramp for camera wen he dey try run things wit one student wen dey find admission don promise say he no go talk anything concerning the situation. Wen d lecturer dey yarn wit news people, he come talk say he no go fit yarn anything now unto say UNILAG still dey investigate am. Meanwhile, for one 13-minute video, Igbeneghu clear Kiki Mordi, the undercover reporter wen form as d student wen dey find admission of how some lecturers for d kians take dey oppress female students becos of sex. Meanwhile Yaw Gyampo, one professor of political science for the University of Ghana, don promise to sue the BBC becos of one sex-for-mark video documentary. Gyampo hand stain for d 13-minute video documentary wen BBC Africa Eye release yesterday; The professor come talk say the documentary na trap say becos he no involve for the matter.
Nothing dey bad for communication tax
Babatunde Fowler, chairmo of the Federal Inland Revenue Service (FIRS), don talk say nothing dey bad for d communication tax wen dem dey try introduce. Fowler yarn dis one wen he dey voice wit news people for the ongoing Nigerian Economic Summit Group conference wen dey play for Transcorp Hilton for Abuja. At present, lawmakers dey propose 9% charge for people wen dey use telecommunication services in place of 2.2% proposed increase for value-added tax wen the federal executive council (FEC) dey propose.
EFCC say na lie say 900 meter don bad
The Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don talk say d reports wen dey play say about N900 million naira notes wen don bad wen dey for different boxes for EFCC care don turn to paper no be true. The anti-corruption agency say the report na big fat lie and say na serious misrepresentation of facts and dis one dey for inside one statement wen dem drop yesterday even as the commission dey prosecute the people dem wen tamper wit d dough wen dem keep for the CBN office for Ibadan. The commission come talk say e no get any time wen dem take carry the boxes of the bad money go the office of the EFCC…
Nationwide strike dey come because of minimum wage
The Nigeria Labour Congress (NLC) don tell workers for the country and the citizens say make dem ready for a very long nationwide strike say becos the ultimatum wen dem give Federal Government to implement the N30,000 new minimum wage don expire. Them drop d warning yesterday during this year World Decent Work Day celebration for Lagos. For the rally wen dem organize to take mark the celebration, NLC Presido Ayuba Wabba wen the union Deputy General Secretary, Ismail Bello represent come tell the government to agree to d adjustment of the salary wen dey cause issues and den make dem start d payment immediately…
Prof Boniface Igbeneghu harassment story
The University of Lagos (UNILAG) don suspend Boniface Igbeneghu, one lecturer and before before sub-dean of faculty of art for d kians becos of sexual harassment. Na one 13-minute video documentary wen the BBC Africa Eye release nia expose Igbeneghu, when be still head pastor for Foursquare Gospel Church, yesterday. Dem cramp d guy for camera as he take dey try to run things wit one undercover reporter wen form say she dey find admission for d kians. Meanwhile The Foursquare Gospel Church for Nigeria don tell Boniface Igbeneghu to step down from all “ministerial assignments”. Igbeneghu, when be part-time pastor for the church na still lecturer for the University of Lagos. Wen d church come dey yarn for one statement, them come talk say dem no dey in support of wetin d lecturer do at all at a all. Still on still Before before senate Presido Bukola Saraki don tell President Muhammadu Buhari and the National assembly to revisit the sexual harassment bill. The bill plus including others prescribe five-year jail term for any lecturer, educationist or person wen dey in position of authority for any tertiary kians for Naija wen dey found guilty of sexual misconduct. Meanwhile, Mr. Saraki yarn dis one after BBC Africa expose one UNILAG lecturer for one video where one undercover journalist, Kiki Mordi, for take form say she na 17-year-old student wen dey find admission for d school.
Teachers dey beg for allowances and benefits
Teachers wen dey long side for d riverine areas of Delta state don tell d government for all levels to provide allowances and also introduce annual retention benefits in order to attract and sustain them for the rural communities. Some teachers wen yarn concerning the challenges wen dem for rural areas dey pass thru come say make the Federal Government collabo wit the states so dat dem go fit provide better package give teachers, especially for the rural areas in order to encourage young talents pick up the teaching profession.