The Chief of Army Staff, Lt.-Gen. Tukur Buratai don talk say na the boldness and sacrifice of soldiers nia dey make any nation. For one message wen Buratai drop to take honour those heroes wen don legoo on the occasion of the 2019 Armed Forces Remembrance Day, he say “ Dem born Every man as a hero and say e take a hero to be soldier. He come salute dem for their courage den he come appreciate both retired and serving members of the Nigerian army for their commitment and loyalty.
Uduaghan Inspects Warri Stadium
The Delta South Senatorial Candidate of the All Progressives Congress, APC, Dr. Emmanuel Ewetan Uduaghan inspect the Warri Township Stadium yesterday ahead of President Muhammadu Buahri visit to Delta State for the flagging off of the APC Campaign Organization. The before before Delta State Governor dey for the Stadium early yesterday for the inspection. Dr. Uduaghan wen yarn just after the inspection come talk say dem go engage youths for the area for local security to protect the facilities for the Stadium. Even as he dey talk say dem go host oga presido for the Stadium on Thursday, he come tell the people say make dem mobilize and den support the President.
Quality Healthcare for Delta
As part of ways to continue to make sure say quality healthcare delivery dey go fine fine through the contributory health insurance scheme, Delta State government don sign one Memorandum of Understanding and one Renovate, Operate and Transfer ROT agreement with one association of medical service providers under the body Pharmaccess. For d event wen shele yesterday for Asaba, Governor Okowa come talk say the MoU and the ROT dey necessary say becos e go helep people wen need medical care for both d rural/urban environment. According to the governor wen yarn through the Chairmo for Delta State Contributory Health Commission, Dr. Isaac Akpoveta, he say with the agreements, medical facilities of international standards go dey available for different rural localities of the state…….. Cut (Dr. Isaac) The Director-General of the DSCHC, Dr. Ben Nkechika, come talk say d innovation wen lead to the signing of the agreement dey very important to achieve the desired result. He say with the agreements, the private sector go get access to money for one single digit interest loan from the Bank of Industry to fix and run the abandoned 25 health centres across the state. Chairmo for d Association of Local Government Of Nigeria, Delta State, Hon. Itiako Ikpokpo come hail Governor Okowa administration for their commitment to providing affordable health care for Deltans, den he come say the governor don first approve d renovation of 107 health centres for across the state.
Lokosa don join Esperance
Top Tunisian club Esperance say dem don sign Kano Pillars striker Junior Lokosa on top two and half year contract. Esperance announce the signing of NPFL goal King for last season for their Twitter handle. Lokosa don join one long list of top Nigeria internationals wen don feature for ‘The Blood and Gold’ like Julius Aghahowa, Michael Eneramo, Gabriel Okolosi and Garba Lawal. The striker score 19 goals before them call off d league after 24 rounds of matches last year.
Nigeria fit face instability
John Nwodo, president general of Ohanaeze Ndigbo, don talk say the country fit face political instability with the prosecution of Walter Onnoghen, chief justice of Nigeria. The federal government file charges of non-declaration of assets against the CJN. Wen Nwodo come dey yarn, he come talk say Ohaneze receive the news of the decision of the federal government to prosecute the CJN “with shock and disappointment”. Even as he dey say need no dey for dat kind action, he come say make the government no make d country boil.
Man Utd don dey smile
Manchester United prove yesterday say their recovery under Ole Gunnar Solskjaer na follow come unto say na Marcus Rashford nia down d goal wen dem take beat Tottenham 1 kondo. The two sides hold their side strong wit enof chances but United goalee David de Gea prove the difference unto say he make correct correct make sense saves. United present manago Solskjaer put Rashford as him number one striker and true true he see d result unto say na the 21-year – old nia score the only goal of d game for the 44th minute.
Naija must survive
The Vice Presidential Candidate of the Peoples Democratic Party, Mr. Peter Obi , don talk say the 2019 elections na all about the survival of Naija. Obi yarn dis one yesterday for one interview wen he get with news people for Amichi for Nnewi South Local Government Area of Anambra wen he dey talk on the state of the nation under the three-and- half – year rule of the All Progressives Congress APC. According to am, President Buhari don show say he no go fit rule d country, he come talk say example of wetin he dey talk na d plenty economic and security challenges wen dey face Naija since wen the APC administration start.
PDP dey support corruption
The All Progressives Congress (APC) say the Peoples Democratic Party (PDP) dey support corruption. The ruling party yarn dis one wen dem dey react to one statement wen the PDP make. The opposition party talk say the allegations wen dey against Walter Onnoghen, chief justice of Nigeria (CJN), na move wen the APC government wan take cause constitutional crisis” and den put fear for judicial officers their body so dat dem go do wetin dem want. But wen Lanre Issa-Onilu, APC spokesman dey yarn yesterday, he come talk say the gbege against corruption remain one of d main promises wen him party make give Nigerians.
Forbes Report
Aliko Dangote na Africa richest man for the eighth time back to back — although him wealth drop by $2 billion from $12.2 billion for January 2018 go $10 billion for 2019. This one na according to Forbes’ Africa Billionaires List wen dem release yesterday. Mike Adenuga, d chief executive officer of Globacom with interests for oil exploration and real estate come move go up to be Africa second richest man. The American magazine come talk say Adenuga net worth increase anyhow from $5.3 billion go $9.2 billion.
I go industralize Nigeria
Obiageli Ezekwesili, the presidential candidate of the Allied Congress Party of Nigeria (ACPN), don promise say she go industrialize Naija if she dey elected for d year 2019. She say she go encourage marketers and entrepreneurs to achieve dis one. Mrs. Ezekwesili make the promise when she dey launch her campaign for the Mararaba and Nyanya markets for the FCT yesterday. According to her, ACPN dey positioned to promote economic and educational policies wen go better the lives of ordinary Nigerians, especially the marketers and entrepreneurs.