To confam di tok wey dey waka say Nigerian National Petroleum Company Limited nor go get di right to dey karey fuel from Dangote Refinery, Federal Govimet just tok am today for statement. Minister of Finance and Chairman of Naira-crude sale implementation committee, Wale Edun, nai tok say marketers fit karey dem tanker now to Dangote go buy fuel and nor need permission NNPC. All dis one dey come afta di last meeting wey dem just do yesterdag to llo di crude oil selling with Nigeria moni. According to Edun, dis tin wey dem start so na Nigerians and the whole market nai go come benefit am dey smile later.
Court of Appeal Bring Back Martins Amaewhule As Rivers Speaker
Di speaker wey dey get problem for Rivers State Martins Amaewhule nai court of appeal don stamp say nai him be di confam speaker for di Assembly and make govimet pay N500,000. Dem bin karey Amaewhule’s leadership go court nai court say any moni and budget wey Govinor Siminalayi Fubura don spend for di back of di speaker, make he return am. Court discharge di case say he nor get head and tail then say dem nor like the way di govinor nor dey obey wetin court tok and karey Edison Ehie as di speaker.
P.Diddy Lawyers Put Trial For April or May
54 years Sean Combs, aka P.Diddy wey police arrest and dey for custody since September, dey face charges of abuse of women, blackmail, kidnapping, and some other kind bad tin but he don enta not guilty plea. Wey dem go court on Wednesday, Diddy’s lawyers come say dem want make di trial dey for April or May and even on Thursday dem go enta Manhattan Federal Court make Diddy go proof say he dey innocent. While di prosecutors for one side write joint letter say dem don get evidence against Diddy from icloud and some other places of bad tins wey he do.
Nor Be We Increase Fuel Price, FG
Di new price of fuel wey don jump go N1,030 for Abuja N998 for Lagos don make pipo dey wonder where di kontri dey really dey drive to even as NLC dey ask Govimet and dem say their hand nor dey for di increase. Federal Govimet on dem own don tom thru di mouth of di Minister of Information and National Orientation, say dem hand nor dey for fuel price as na NNPCL dey do am base on di gbege wey dey middle east nai make di price rise like ijegbu garri. Mohammed Idris come say Govimet hand nor dey for dis new price mata as na NNPCL dey do am with Petroleum Industry Act, PIA, wey dey in ground He come dey beg Nigerian make dem dey patient with NNPCL say price go soon come down, cus afta di subsidy wey dem remove, NNPC bin dey pay some kind moni but dem no come fit again cus of gbese.
Pilot Wey Dey Fly Turkey Areoplane Die For Air
One pilot wey dey work with Turkish Airline, Ilcehin Pehlivan nai dem say he die for plane as he dey fly pipo from Seattle dey go Istanbul on Tuesday evening. Di 59 years man dey with he co pilot and nai so di second pilot sharply call for quick landing wey dem do for New York, according to di tokpesin of Turkish Airline, Yahya Ustun. Dem say bifor dem land dem try their best to give di man first aid but he nor fit so anytin as di pilot die bifor dem even reach ground. Info say di Pehlivan don dey work with di Airline since 2007 and just March here he do test wey show say he nor get any healt problem.
Fear As Sapele Pipo Shurkin Cus Of Explosion Sound
Panic full Sapele on Tuesday nite afta explosion just burst for Mission road one side wey dem take dey keep condemn iron, kill one pesin and wound some Na around 6 for evening mak pipo wey see say di tin take hapun afta one of di iron condemn boys karey wetin fit bomb enta di site. Di pesin wey die, dem say he bodi finish for di blast and di other two pesin wey wound dey still take treatment. Whole one senior police man say he never get di right to tok with media pipo, say wetin dem dey suspect na either gas cylinder or fire extinguisher cylinder wey one of di iron condemn karey enta di place and nor know how di tin be nai cus di blast but dem dey do investigation for di mata.
Govinor Aiyedatiwa Don sack Aide Cus Of N30m Bribe From Wood Sellers
One bribe audio wey Govinor Lucky Aiyedatiwa, of Ondo State don find way to di Govinor afta di Special Assistant on Forestry (Central Senatorial District) dey tell wood sellers make dem bribe am. Adeboye Taofiq Ewenla, nai be SSA aide on Forestry, to di Govinor but he come tell timber sellers to pay am N30 million or dem go porchu dem komot from di forest and say na di state govinor nai give di order. As di wood dealers hear di demand and di way Ewenla take dey threaten dem, nai dem say dem must protest di mata come outside. As mata fly reach Govinor ear, nai he send him Chief Press Secretary, Ebenezer Adeniyan, on Wednesday to investigate di mata but sharply sack Enwela and put anoda pesin. Then all di others wey dey for di forest reserve na to still check dem ways too.
Youths For Port Harcourt Ask NNPC Wetin Dey Delay Refinery Production
Kwestun don dey plenty about how stakeholders wey dey involve for Port Harcourt refinery and Nigeria National Petroleum Company Limited, NNPCL, nor dey do anytin to start production for di refinery. As Niger Delta Youth Network, NDYN, dey tok how e be dem for mind, dem say cabal nai dey behind di whole mata and wan just chop clean mouth to make di region suffer for notin. For statement wey NDYN group tok thru dem convener, Dakuku Francis nai dey ask make NNPCL come tok wetin really dey hapun cus dem don dey hear mata say stakeholders dey plan to wan use Port Harcourt refinery as blending company. Nai di youth come tell Mele Kyari di Oga of NNPC to tok mata now cus dem wey dey for di region nor fit dey suffer for wetin dem get as mata don dey waka upandan.
Children Go Spoil Finish, Parents Condemn JSS 3 Abortion Book
One secondary skool textbook wey be Classic Basic Science and Technology for Junior Secondary School 3, don cause problem between teachers, parents and even ordinary pipo wey hear mata say make dem ban am. One page for di book wey really cus di problem explain how to do D&C abortion finish, the time to do di abortion, wetin dem dey use do am and even D&E wey di pikin don already grow for di belle. Di information wey full di book just dey wonder pipo as one pesin nai first post am for X say di book dey tell small children how to use medicine afta sex to avoid abortion. But why some pipo say dem nor like wetin dey do boom others say notin bad inside as na for JSS 3 and SS 1 students wey don reach 13 and above age, plus some of dem don know sex early so di book go epp dem. However, di National Presido of the All Nigeria Conference of Principals of Public Schools and Parents Teachers Association, Musa Ibrahim, say dem go investigate the book.
My Oga Allow Me Govern Well — Fubara Beg Wike
Since Govinor Siminalayi Fubara enta office take power from Nyesom Wike, dem two don dey get problem since and di gbege don dey tear everywhere. Wey Govinor Simi come Channels TV program nai he come dey beg Wike make he nor scatter di state, so that dem nor go destroy di kontri as he don dey. If na election dem fit fight but nor be now. Di Gov come say he remember wey Wike dey as Govinor, pipo dey envy di state but say make dem nor scatter di state as he time na either four years or eight years anoda pesin go enta. Dis one come join di wahala wey come up bifor and afta di LGA election wey dem burn secretariat and pipo even die put.