The troops from Operation Hadin Kai kpuff 60 terrorists for Bita for Borno state for one overnight joint land and air operation. One reliable military source when confirm this informate give the News Agency of Nigeria NAN for Maiduguri say d troops overpower d terrorists during one serious gbege around 1:09 a.m. on Friday. According to the source, the coordinated offensive wen involve troops under the 26 Task Force Brigade of Sector 1 and the Nigerian Air Force (NAF), take place after one attempted assault by the terrorists on one military position.
Gunmen Attack WAEC Students For Benue
Wetin for turn to anoda set of problem for di kontri nai police don epp push away on Thursday for one Govimet Skool.wey dey for Odugbo inside Benue State. Some men wey karey gun nai rush di skool student wey dey write dem Senior Secondary School West Africa Examination Council (WAEC) exam around 1:20 for afternoon. Tori get am say di men wey karey gun na herdsmen and naso dem dey shoot everywhere, wey make di students and teachers start to dey run forforty. Dem sha say na with di epp of 80 man Patrol Team for Benue State Civilian Joint Task Force wey dey for Odugbo nai sharply run down start to chase di gunmen, naso dem run enta bush.
NAPTIP Don Call Speed Darlington Wey Sleep With 15 Years Girl
Singer Darlington Okoye, aka Speed Darlington, wey run mouth say he sleep with one small girl for hotel, National Agency for di Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) don call am to come ansa mata in pesin. Na Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency nai karey di mata go put for NAPTIP ear afta Speed Darlington dey tok for Instagram Live say he sleep with one 15 years girl for hotel. Wey he dey even do di Live pipo don already dey vex for am for di word he tok and others come go dig out anoda video wey pipo dey drag am say he sleep with dem 16 years pikin. As tok don dey waka too much for Speed Darlington nai he quickly do anoda video deg beg pipo say wetin he tok na lie, he just dey use am take one promote he new song wey dey come and make pipo forgive am for wetin he don cus with him mouth. But that one nor still end mata as on Thursday nai NAPTIP confam for two pages letter say make he come dey office and if he nor come dem nor go take am easy with am.
Chelsea knack Real Betis, win UEFA conference league
Chelsea come from back knack real betis 4-1 for the EUFA conference league finals wen dem play on Wednesday night. Two goals for five minutes change the music of the game, with man-of-the-match Cole Palmer wen create both openings for Enzo Fernandez and Nicolas Jackson. Like dis, dem don become the first club to claim all four major European trophies.
Emefiele don petition appeal court ontop Abuja estate mata
Before before Central Bank of Nigeria Governor, Godwin Emefiele, don petition the Court of Appeal for Abuja to do aback turn on top one judgment wen grant the government full control of one large estate for Abuja wen contain 753 housing units. The Economic and Financial Crimes Commission before now obtain one court order to seize the estate, wen dey for the Lokogoma district of Abuja. At first, the estate been dey linked to another before before government official wen no get name but however, Emefiele, through him lawyer A.M. Kotoye, come dey talk say dem suppose involve him client for the proceedings, as d property concern am. Like dis, Emefiele don begin dey seek the Appeal Court’s reversal of the lower court ruling.
We don empower 266,737 Deltans – Gov. Sheriff
Delta State Governor, Rt. Hon. Sheriff Oborevwori say him administration don empower a total of 266,737 Deltans through different social intervention and empowerment programmes for across the state. Governor Oborevwori yarn dis one wen he dey deliver the State of the State address to members of the Delta State House of Assembly for the Assembly Complex. He come talk say him administration dey deliberate, intentional, and proactive wen e come to providing a safety net for groups wen need assistance through well-targeted social protection initiatives, particularly now wen things be as e get for the country. He say dem empower the 266,737 beneficiaries through different programmes, including the Delta CARES (D-CARES) Programme, Women Empowerment and Skill Acquisition Programme (WESAP), Working Fingers Initiative, MORE Grants Scheme, MORE Biz-Up Programme, and the Widows Welfare Scheme.
Some bank workers dey tief piple with hackers – EFCC
Ola Olukoyede, chairman of the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don talk says bank employees dey connive with hackers to carry out cyber fraud. Wen Olukoyede dey yarn for one interview, he come talk say hackers don target six banks for coordinated cyber. The EFCC chairman come talk say bank employees dey give access to banking portals wen hackers dey usually dey take advantage of from any part of the world wen dem dey stay.
FG don order exam piple to close miracle centres
The federal government don give directive wen dey mandate examination bodies to close down “miracle centres”. When the Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) dey yarn for one statement on Tuesday, he come talk say Tunji Alausa, the minister on top education don order crackdown on schools or computer-based test centres wen dey conduct mass malpractice. These centers wen dem dey usually dey call miracle centres na facilities wen dem dey use take dey run examination malpractice for the secondary school level.
NDPC don dey investiagate JAMB technical error
The Nigeria Data Protection Commission (NDPC) say dem don start investigation into the technical error wen happen for the 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME). During one press conference on May 14, Ishaq Oloyede, JAMB registrar, admit say na technical error nia affect UTME results for 157 exam centres. Itunu Dosekun, head of the NDPC media unit, say the agency go probe the technical errors of the 2025 UTME. For one statement on Tuesday, he come talk say the probe dey aim to determine the extent to which the personal data of candidates go fit don dey exposed and whether JAMB or their partners break data protection laws.
NAFDAC No Kolet Traders Moni By Trick or Wayo
Di video wey Martin Vincent Otse aka VeryDarkMan do with traders from Onitsha Bridge Head Market wey dem dey protest say dem close dem market and di moni wey National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) kolet from dem, no be true, according to di agency. Di market pipo bin tok say NAFDAC by force kolet N700,000 from dem and VDM come even show one receipt wey di pipo take pay and he say na court nai NAFDAC go see. But on Tuesday nai NAFDAC say wetin VDM dey tok no make sense and just dey use am cus problem wey even dey against cyber crime act. NAFDAC come say di only moni wey dem kolet na penalty for wetin dem do and e follow normal federal govimet law. Di mata start wey NAFDAC go teree open drug markets, shops, warehouses, and stores for Ontisha and see say dem dey go against di law of Good Storage and Distribution Practices.