One Police Inspector, wen e name be Effiong Bassey, go gaga on Sunday and na so he come begin dey shoot anyhow, in the process, he kpuff one civilian wen dem dey call Mrs. Ijoema Obot den he come injure two others for Calabar, Cross River State capital. According to report, d matter so happen at about 6a.m. when the policeman wen go for night duty for one Microfinance Bank for Calabar South return back to the Atakpa Divisional Police station and den he come begin dey behave strangely. Findings show say when the policeman return from his shift, he no come gree return the AK 47 wen he use for the night duty, but instead he come cock the rifle den he come threaten to shoot him colleagues.
Make una respect human rights – IGP
Kayode Egbetokun, the inspector-general of police, don give warning to members of the police force on respect for fundamental human rights. For one statement on Sunday, Muyiwa Adejobi, talk talk person for the police, say the IGP tell officers to obey detention periods wen dey states legally after arrests. Egbetokun caution against practices wen go fit lead to unlawful or prolonged detentions, wen go fit undermine public trust and confidence wen people get for the police. He come talk say any officer wen dem gbab dey go against these principles go face serious consequences.
Another explosion don nack pipeline for Rivers State
Barely one week after one major explosion happen for the Trans-Niger pipeline for Bodo, for Gokana local government area of Rivers State, report say another explosion don happen again for the Soku oil facility for Akuku Toru LGA of the state. The Youths and Environmental Advocacy Centre (YEAC-Nigeria), one grassroots non-governmental organization wen get strong presence for communities for across the Niger Delta region wen raise the alarm on the latest development confirm am say dem receive information for the early hours of Sunday about explosion for Soku oil facility for Akuku Toru Local Government Area, wen d Nigeria Liquefied Natural Gas, NLNG Limited dey operate. For one statement wen the Executive Director, Dr Fyneface Dumnamene Fyneface sign for Port Harcourt, the group say dem confirm the explosion through their youth volunteers network for the area.
Children Party Stampede: Oyo State Govimet Free Queen Naomi, Others
Di teree pesin wey dey face 18 count charges for Oyo State cus of di stampede wey hapun for December 2024 and kill more than 35 children, court don free dem Di charges wey di state govimet for Oyo State put against Queen Naomi Silekunola, wey be di foma wife of Ooni of Ife; Alhaji Oriyomi Hamzat, owner of Agidigbo FM; and Abdullahi Fasasi, di principal of Islamic High School, Bashorun, Ibadan, were dem wan take do di children party bifor wahala come hapun nai dem don free so. For di court session di teree pipo show face but start to dey smile afta di state govimet say dem nor want case again and all di charges against dem head don komot. Afta do court case nai di Oyo State Attorney General, Abiodun Aikomo, come still confam di update for briefing say dem just get to follow di law process to makes sure say no bodi dey guilty of di blame wey make di children kpai.
Bring Democracy Back To Rivers State, NLC Warn Tinubu
As President Bola Tinubu don swear in retired Vice Admiral Ibokette Ibas as di sole administrator of River state today so many tok don full every ground. Pipo don dey vex say wetin President do na against democracy and even Nigeria Labor Congress and Trade Union Congress don put mouth too. Di president of NLC Joe Ajaero and Festus Osifo of TUC say di way Tinubu komot Govinor Simi Fubura hin deputy and di State House of Assembly nor just make sense cus na disgrace to democracy. Nai dem draw ear dey give Tinubu say make he behave well and beta work with wetin di constitution tok and bring back democracy cus wetin he do for Rivers State nor be democracy at all.
President action no fair – Joe Warisenibo
The Rivers State Government don express shock over President Bola Ahmed Tinubu decision to remove Governor Siminalayi Fubara whereas he no touch d Minister on top the Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, wen dem say nia be d toot cause of the state political crisis. For one statement wen the Rivers State Commissioner for Information and Communications, Warisenibo Joe Johnson tender, the government describe say the president action no dey fair, say Governor Fubara don remain committed to constitutional order, peace, and good governance undermining the political gnege wen dey for the state. Johnson come talk say since wen Fubara enter office, he don prioritize the protection of lives and property while ensuring the progress of Rivers State.
New PM For Canada Go Enta On Friday
Na almost 10 years nai Justin Trudeau sitdon for position as Prime Minister for Canada bifor he tok for January say seat don tire am, nai dem do election wey di new Prime Minister don come now, Mark Carney. Carney don bin work as Manager for Canada Central Bank and England Central Bank bifor he go find place for politics and e come favour am, cus I’m Friday him and he cabinet go sitdon wella for leadership position. Na from di Govinor general office on Wednesday nai dem take say so 59 years man go be prime minister afta he don win 86 percent of di vote wey pipo vote. As e dey tok for di speech on Wednesday nai Carney say afta he don sitdon for di seat, he go follow US President Donald Trump tok make dem know way forward concerning di problem of 25 percent level wey US stake sama Canada and Canada too give dem own bomb.
No try impeach Fubara, if not… -INC
The Ijaw National Congress (INC) don give warning say any attempt to impeach Rivers State Governor Siminalayi Fubara go lead to economic consequences for Nigeria. This statement show after dem block the Rivers State House of Assembly Complex, and dis one so come make Governor Fubara no fit present the 2025 budget based on d order wen the Supreme Court give. The INC come still condemn the actions of Federal Capital Territory (FCT) Minister, Nyesom Wike, say he no go fit dey drag the Ikwerre and Ijaw ethnic groups into tribal war through him comments and political maneuvers.
Heaven no go fall if dem impeach Fubara – Wike
Nyesom Wike, d minister on top the federal capital territory (FCT), don talk say make Siminalayi Fubara, d governor of Rivers state, face impeachment if he go against the constitution. Wen Wike dey yarn for one media chat for my Abuja on Wednesday, he come talk say dem no need to take politics lightly and say removing the governor no go be criminal offence. Even as he dey defend him commitment to legal procedures and fairness, Wike come talk say he dey wonder how legislators wen no reach anything go pass laws and expect them to dey recognised as authentic.
Akpabio no fit appear before Inter-Parliamentary Union
The camp of Senate President Godswill Akpabio don dismiss the authority of the Inter-Parliamentary Union to force am to appear before their panel becos of the suspension of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan from the National Assembly. Akpabio media aide, Eseme Eyiboh, yarn dis one during one ogbonge interview with news people on Wednesday. The matter na say Akpoti-Uduaghan, when dey serve six-month suspension accuse Akpabio of sexual harassment and abuse of power.