Mohammed Buba Marwa, chairmo/CEO of the National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA), don give commanders of the agency for all the states of the federation and special commands marching orders to end all these mago mago drugs for across the country. Marwa give the order during one meeting wen he get with commanders of the 36 states and d federal capital territory (FCT) for the agency headquarters on Monday. He come still talk concerning the plan wen dem get to get government approval to conduct drug tests on new students wen gain admission for Naija kians dem.
President Buhari don sack service chiefs, appoint new ones
President Muhammadu Buhari don sack the Service Chiefs wen Chief of Defence Staff, Gabriel Olonisakin dey lead. Na Presidential otota Femi Adesina nia yarn dis one for one tweet thru him verified handle on Tuesday. According to the tweet, na Leo Irabor nia be the new Chief of Defence Staff, I. Attahiru, Chief of Army Staff, A.Z. Gambo, Chief of Naval Staff, and I.O. Amao, Chief of Air Force. The president decide to sack dem becos Nigerians say dem no want dem again becos dem no dey try and dis issue so don cause wahala well well.
Lampard still be chelsea Icon- Roman Abramovich
Roman Abramovich say Frank Lampard status as Chelsea icon still remain sure undermining say dem sack am, he come thank am for him work for Stamford Bridge for the last two years. Lampard 18-month reign for the Chelsea hot seat end when d club sack am on Monday morning. The 42-year-old carry the Blues enter fourth-place where dem for finish last season undermining say transfer ban disturb dem, but he no come fit build on that platform for the first half of the 2020-21 season.
We no tell herdsmen to vamoose
The Nigeria Governors Forum (NGF) don talk say dem no tell herdsmen for Ondo State or any part of the South West region to vamoose. Na chairmo of NGF and Governor of Ekiti State, Dr. Kayode Fayemi nia yarn dis one for Akure for one meeting wen dem get with the national leadership of the Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria (MACBAN). He come talk say people misunderstand wetin Ondo state Governor, Oluwarotimi Akeredolu, talk , say he only direct government reserve including herdsmen wen wan operate within the reserves to register.
APC: Omo-Agege tell leaders make dem ginger supporters to register
Deputy Presido of the Senate, Sen Ovie Omo-Agege don tell leaders and stakeholders of the All Progressives Congress, APC to mobilize party supporters to register officially as members of the ruling party. Omo-Agege yarn dis one for one press statement wen he release thru him assistant, Aruviere Egharhevwa, and for d statement, he encourage supporters to register fully for d nationwide membership registration exercise wen start on (Monday) 25th of January, 2021 He come still encourage all leaders and major stakeholders of the APC for Delta State and the wider South-South geo-political zone to use this moment to unite in the best interest of the party and our people.
International oil companies warn against PIB
International Oil Companies (IOC) don give waring say if dem by mistakenly pass the Petroleum Industry Bill (PIB) for d current form wen e dey, e go fit reduce Naija global competitiveness. The IOCs wen the Oil Producers Trade Section (OPTS) represent raise the fear during one public hearing on the PIB wen the Senate Joint Committee on Petroleum (Upstream, Downstream and Gas) organize for Abuja. The Chairmo of the OPTS, Mike Sangster, come talk say if them pass d PIB for d current form, e no go meet the government objectives of making Naija the leading destination for oil and gas investment and the recent scarcity of investment – only $3bn out of $70bn (representing 4 per cent) for Africa nia go continue.
Warri South go serve quit notice to Ajamimogha gas plant
The Member wen dey represent Warri South Constituency I for Delta State House of Assembly, Dr. Augustine Uroye, don tell the Acting Chairmo/Director of Personnel Management of Warri South Local Government Council, Dr. (Mrs.) Minnie Igbrude, to sharp sharp serve the owner of one new gas plant wen dem dey build close to one section of the fencing of the Palace of Olu of Warri for along Ajamimogha Road notice of abatement. Dr. Uroye, wen give d order on Monday for Warri not long after he don visit the site of the gas station, come talk say the state government no go allow make dem put gas plants for areas where people dey long side put. Evan as d lawmaker dey talk about the gas explosion wen happen for Agbor, he come talk say plans don already dey on to initiate one bill wen no go dey allow people dey put gas stations for residential areas as a matter of urgency.
Buhari administration na apology-Jega
Attahiru Jega, before before chairmo of the Independent National Electoral Commission (INEC), don talk say the administration of President Muhammadu Buhari na apology. Wen Jega dey voice wit news people for one interview, he come talk say the current administration don perform below wetin plenty Nigerians been dey expect”. Jega when serve as INEC chairmo for Naija from 2010 go reach 2015, remain the only INEC chairmo wen don take charge of two general elections for Naija, that is 2011 and 2015, when president Goodluck Jonathan lost to Buhari, and dis one make oga Jona the first sitting president to lose re-election.
FG na defender of herdsmen- Femi Falana
Femi Falana, one senior advocate of Nigeria (SAN) don talk say the federal government dey show say dem be the “defender of herdsmen” for the country. Falana yarn this one during one interview for Lagos on Sunday. The human rights lawyer wen complain badly about the state of insecurity for the country, come tell the federal government to defend the rights of all Nigerians, not minding their tribe or class.
Delta State: Over peace dey worry us for Omadino
People of Omadino Community for Warri South local government area don talk say d report wen dey play say yawa dey for the community no be true. Wen the Oloraja of Omadino Community Pa Samuel Mene, the Youth Presido Mr. Francis Niro Omaro and other stakeholders dey raport wit news people dis past weekend, dem come talk say over peace dey worry d Community say d people wen dey spread dis fake news na the same people wen dey use military people take dey arrest leaders and dey cause confusion. As regards the boundary issue between Omadino and obodo Communities, the youth PRO, Mr. Joshua Ghereje come talk say the boundary spot wen d Communities agree on in the presence of Warri South council still remain d same, say dem no be part of the move wen one Mr. Armstrong dey make to remove the sign post. He come talk say make state Governor Dr. Ifeanyi Okowa call Mr. Armstrong to order, say becos dis kind move wen he dey wan make so go fit cause better casala between d two Communities. Meanwhile, wen news people visit the community, dem say dem see say everything dey go on fine there unto say indigenes dey go about their day to day lives peacefully while construction work of Omadino Modern Technical College dey go on.