One Magistrate Court for Wuse Zone 2, Abuja don order the arrest and detaining of Sahara Reporters Publisher, Omoyele Sowore, and four other activists for Kuje Correctional Centre until the hearing of their bail applications. Sowore and d other activists appear on Monday for court on top three charges of criminal conspiracy, unlawful assembly, and attempt to ginger others. The activists sha deny the charges. The matter na say earlier, security operatives arrest dem becos dem hold one protest against bad governance on New Year Eve for Abuja. Meanwhile, dem go hear their formal bail applications today Tuesday, January 5, 2021.
Government no get plan for fresh lockdown-Lai Mohammed
As Naija dey battle the second wave of the corona virus okpetu, Information minister Alhaji Lai Mohammed don talk say the Federal Government no get any plan to put fresh lockdown for d country. Mohammed, wen voice for one conference for Lagos on Monday, come beg Nigerians say make dem follow all d protocols wen the Presidential Task Force on COVID-19 don give. He come talk say d Federal Government no dey happy at all say Nigerians no dey obey the basic Covid-19 protocols of wearing face masks, say dem no dey practice social distancing, dem no dey gree wash hands, and say dem no dey avoid large gatherings.
Security mata for Naija don better- Femi Adesina
With d insecurity wen dey swell up anyhow for d country, the presidency still dey hold ground say d security situation for Naija don better well well now. Femi Adesina, d Special Adviser on top Media and Publicity to President Muhammadu Buhari wen yarn for one interview on Sunday come talk say while d nation still get some way to go for d gbege against insecurity, he say dem don make better progress especially for the North East where boko haram badoo dem been hold strong. Den concerning d steps wen dem dey talk based on d End SARS protest, Adesina say d president Muhammadu Buhari dey address all d demands wen d youths dem make. He come talk say e go fit take a while to achieve their desire.
Delta State: Government go give staff of office to Orosuen of Okere-Urhobo
Okere-Urhobo Kingdom for Warri South Local Government Area dey happy say the Delta State Government don conclude plans to present Staff of Office give the Orosuen of Okere-Urhobo Warri Kingdom, His Royal Majesty, Emmanuel Okumagba, Okumagba ll, on Tuesday January 5th. The event go hold for the Orosuen palace for Warri. His Royal Majesty, Emmanuel Okumagba, Okumagba II nai take over from HRM Prof. Paul Oghenero Okumagba, Idama II wen die for July 2019. Before he die, him be former professor for the Sociology Department for Delta State University, Abraka. Aproko wen dey reach us na say na the Deputy Governor of the state, Deacon Kingsley Otuaro nia go present the Staff of Office give the Urhobo monarch on behalf of Governor Ifeanyi Okowa and say the Deputy Senate President, Senator Ovie Omo-Agege go show for the ceremony.
FRSC: We go make sure say people obey traffic rules
Corps Marshal for d Federal Road Safety Corps (FRSC), Dr. Boboye Oyeyemi don talk say for dis new year, the Corps go make sure say d people dey obey traffic regulations. This informate dey for inside one statement wen the Corps Public Education Officer, Assistant Corps Marshal Bisi Kazeem, drop give news people on Sunday for Abuja. According to Oyeyemi, he say dem dey do dis one becos of d way d road go take busy unto say people wen travel becos of d jollification period go don begin return plus the operational activities wen the FRSC dey review.
Police council fit nominate new IGP for february
The Nigerian Police Council fit nominate one new Inspector-General of Police by February. E neva dey clear if dem go extend the tenure of the current Inspector-General of Police, Mohammed Adamu. The council wen the President dey lead dey made up of the 36 state governors and the Chairmo of the Police Service Commission. Meanwhile, Adamu, when be the 20th indigenous police boss, dey expected to retire next month when he go clock 35 years for service.
I no talk say Orji Kalu go be president-T.B Joshua
Founder of the Synagogue Church of All Nations Prophet T. B. Joshua don talk say he no ever talk say na Senator Orji Kalu nia go be Naija next president. According to reports, Joshua yarn over the weekend during one church service say d person wen go take over from President Muhammadu Buhari go be one before before governor from the southern part of the country wen dem hold for prison. The prophet come talk say he no ever make that comment for one tweet wen he drop early on Monday, say d gist na “fake, say he dey for him prayer mountain since the past five days and say e no get anyhow he take make the statement.
NMA don tell FG to make new Covid-19 policy
As Nigeria dey battle with the second wave of the Covid-19 palava, the Nigerian Medical Association NMA don tell the Federal Government to come up with new policies wen go helep to reduce the spread of the virus. Wen Chairmo of NMA Prof Uja dey yarn for one interview on Monday for Abuja, he come talk say the idea of social distancing for Naija don fail, say we need new approach sharperly. Den concerning the issue of vaccine, he say need dey to test the drugs well before dem begin give Nigerians.
Put more attention for Bill of Quantities-Okowa
Governor Ifeanyi Okowa don tell the Niger Delta Development Commission (NDDC) to put more emphasis on their Bill of Quantities ( BOQ) so dat their road projects go fit dey last. Okowa give the charge on Monday for Aniocha North Local Government Area of the state for d grand reception even as dem dey honour Justice Samuel Oseji based on him promotion as Justice of the Supreme Court. The Governor when dey react based on the way wen d community take beg am to tell d NDDC to complete the Onicha-Uku/Idumuje-Unor Road wen dem award for d year 2012 come talk say most roads wen the NDDC dey construct no dey last because of inappropriate bill of quantities.
Naira go drop more for January-CBN
Na only three days remain for the year to end and the naira dey expected to fall more for January 2021. This one na according to one survey wen the Statistics Department of the Central Bank of Nigeria CBN carry out. The naira experience sharp fall for recent weeks and na so e come reach e lowest on November 30, 2020, when e exchange for N500/$1. Since then, the dollar don dey rigmaro between N460 and N470. Meanwhile as at Friday, one dollar exchange for N465/$ for the parallel market.