Na about 393 children nia involve for accidents towards the end of the year 2018. For d release wen the Federal Road Safety Corps FRSC drop dis past weekend, dem say 29 of the children kpuff on top d matter. In total, the FRSC say 275 persons nia kpuff during the end of year special […]
Darmian wan buy waka
Manchester United full-back Matteo Darmian go soon buy waka comot from the club and den he go come join Juventus on loan. E clear say the 29-year-old go sign for the Old Lady for £3 million and the short-term deal go fit dey permanent next summer as him contract for United go surely expire. Darmian […]
Lottery win palava
One 27 year-old man wen him name na Emmanuel Okachi don lose one eye even as he dey find spiritual powers so dat he go fit dey win lottery games wen we dey popularly dey call ‘Baba Ijebu.’ Okachi go meet one babalawo for Ishiagu village, near Ogwashi-Uku for Delta State to help am so […]
Obasanjo Blast Buhari
Before before Presido Olusegun Obasanjo blast President Muhammadu Buhari yesterday den he come say Buhari administration na d same tin as the era of the late before before Head of state, Gen. Sani Abacha. Obasanjo yarn dis one for him 16-page statement wen he title Points for concern and action, wen he release give news […]
Minimum wage still under consultations
The Federal Government don set to present the N30,000 new National Minimum Wage proposal give the National Economic Council by tomorrow for more consultations. This one nia be d koko wen dem agree on for one extraordinary meeting wen the Federal Executive Council hold wen end yesterday night for Abuja. Na State governors, the Central […]
Kane Injury take style serious
Harry Kane go miss nothing less than 6 games based on say he get ankle ligament injury. Yesterday, d Spurs confirm am say their star man no go return to training until the beginning of March after one scan show say he get injury for him ligament after one last-minute challenge from Phil Jones for […]
EFCC nor raid my house
The Chief Justice of Nigeria, CJN, Justice Walter Onnoghen, don talk say d news wen dey play say operatives of the Economic and Financial Crimes Commission, EFCC raid him house yesterday no be true. Wen Senior Special Adviser to the CJN on media, Mr. Awassam Bassey, dey react to the report wen dey play for […]
Make PDP work together to win
With about 30 days to d Presidential elections, Delta state Governor Dr. Ifeanyi Okowa don tell members of the Peoples Democratic Party (PDP) say make dem work together so dat dem go fit win for d elections. The governor yarn dis one during PDP campaign rallies wen shele for Issele-Uku, Akwukwu-Igbo and Asaba. The governor […]
Cech retiring na big loss to football
Jose Mourinho don talk say four-time Premier League winning goalkeeper Petr Cech go be “big loss” to football. The before before Manchester United and Chelsea oga say he dey proud as he take manage one of the modern game best goalkeepers, when announce yesterday say he go retire by the end of this season. Mourinho […]
BBN: naija na the host
The organizers of Big Brother Naija (BBNaija) don talk say na for Naija nia d number four edition of d show go for take hold. During the second season of the show, Alhaji Lai Mohammed, d minister on top information and culture direct the National Broadcasting Commission (NBC) to investigate why e be say na […]