Governors of the 36 states of the Naija don tell Mohammed Adamu, the inspector-general of police, to bring out the policemen wen dey responsible for the deaths of protesters for across the country. Na since nia Nigerians don dey protest becos of the yeye way wen dem say the special anti-robbery squad (SARS) dey behave. Protesters ball enter the streets dey demand for end to police brutality, meanwhile some of the protesters come clash with security operatives and dis one so come lead to the loss of lives. Amnesty International say d people wen don kpuff don reach ten (10). For one teleconference wen the Nigeria Governors’ Forum (NGF) hold on Thursday, them come talk say the IGP must produce the olokpa dem wen attack the protesters
Police don release #EndSARS protesters for Delta State
The fourteen #EndSARS protesters wen our olokpa dem arrest for the alleged killing of one police corporal, Stanley Etaga, for Ughelli, Delta State, last week don dey free. According to reports, dem release the protesters wen dem been arrest on Thursday after Delta state Governor, Dr. Ifeanyi Okowa shook mouth put for the matter. For another side, gbege come burst out amongst the #Endsars protesters for Asaba becos of the pepper wen Gov Ifeanyi Okowa drop. According to the tori, the protesters just to cheat their colleagues come grab one large portion of the money, jump thru the Government House fence and na so he come take kawa
Federal Government don Open NYIF portal
The Federal Government say dem don open the portal for Nigerians to apply for their N75 billion youth investment fund. On July 22, Sunday Dare, the minister of youth and sports development, announce say the federal executive council approve the establishment of NYIF to the tune of N75 billion. The NYIF dey dedicated to invest for the innovative ideas, skills, talents and enterprise of the Nigerian youth with the aim of turning them to entrepreneurs
Omo-Agege don call Oil Companies to come the region
The deputy Senate presido Sen. Ovie Omo-Agege don talk say na peace we need for Naija so dat the country go fit achieve their target for the 2020 Budget. Omo-Agege, when yarn on Wednesday during their meeting come dey complain about the way wen the government take dey fashi the Niger Delta especially communities wen dey host multinational companies. He come talk say make the headquarters of multinational oil companies come back to the region. Meanwhile, the deputy senate presido don talk say he no support the reports wen dey play say the Zamfara state government sell one bar of gold give the Central Bank of Nigeria (CBN) for N5 billion. Wen Omo-Agege dey contribute to one debate on the 2021 Appropriations Bill for yesterday Senate meeting, he come talk say the gold wen dem sell dey act against the laws presently wen dey guide the exploitation of mineral resources for the country. He come talk say him constituents and other Niger Delta people dey worried about the matter, since all the pepper wen dey come from oil for their territory dey go the Federation Account.
I no support the shooting for protest- Seyi Makinde
Based on d way wen dem take kpuff protesters for Oyo state, the Governor, Seyi Makinde don talk say he no support the way wen our olokpa dem take dey shoot for #ENDSARS rallies. Wen Gov. Makinde dey yarn during one address for Ibadan, he come talk say the citizens get the right to protest peacefully. He come talk say need dey for other security agencies to take charge of protecting protesters in order to avoid more shootings. Meanwhile, Lagos state Governor Babajide Sanwolu after he no fit convince protesters to leave the street of Lagos, he come las las join d youths wen dey protest.
President Buhari don appoint INEC Commissioner of Delta State
President Muhammadu Buhari don tell the Senate to confirm the appointment of one of him media aides, Lauretta Onochie, as one National Commissioner of the Independent National Electoral Commission wen dey represent Delta State. Na Presido of the Senate, Ahmad Lawan nia read d letter for the floor of the Senate on Tuesday. Onochie until her latest appointment nia be the Special Assistant to the President on Social Media.
We go rub mind for Urhobo governor
The Chairmo for the House Committee on Trade and Investment for Delta State House of Assembly, Hon. Matthew Poko Opuoru, don tell members of Urhobo Youth Leaders Association, UYLA, say he go rub mind with him colleagues dem for the State House of Assembly onto their demand say make the next governor of Delta State come from the Urhobo Nation. Hon. Opuoru, when dey represent Warri South Constituency II, give them assurance on Monday when he host members of UYLA for Warri. The lawmaker come hail Governor Ifeanyi Okowa, for the way wen he take dey steadily dey work towards sustaining peace for every part of the state.
Bad guys nack Surulere police station
Bad guys don nack Surulere kporkpor yard for Lagos. At least three kporkpor don collect bullet. The otota of the Lagos state police, Muyiwa Adejobi nai yarn this one wen him dey talk with news people. “Dem shoot three police men today. I no knowweda dem shoot protesters. The kporkpor wen dem shoot dey for LASUTH as we dey talk so, dem dey receive special treatment. Na this one I know” “Dem be anti-kidnapping men and dem dey on mufti. I no go know if dem shoot anybody sha, maybe the protesters because dem carry weapon wen police carry.”
#EndSARS:Two Protesters kpai for Lagos
Two protesters don kpai for Surulere area for Lagos based on the #End SARS protest. Other protesters wen share the video of the dead person say na kporkpor shoot the protesters wen no carry any weapon. Reports yarn say stray bullet kpuff one kporkpor too as the shooting dey go on.
IGP don Scrap SARS
The Inspector-General of Police, Mohammed Adamu don make announcement say dem don quench the police unit, Special Anti Robbery Squad (SARS or FSARS). The IGP, when dey report directly to the Nigerian presido make the announcement on Sunday afternoon for one press conference wen shele for the Police headquarters. The police oga come still announce major police changes one na say dem dey form one group wen go dey investigate, the group go include civil society and human right groups, sake of say dem wan torchlight d alleged cases of yeye behavior of the police. For one side, Barrister Robinson Ariyo wen be rights lawyer don call for sharp sharp assessment of the SARS unit wen the IGP con cancel. Wen Ariyo dey yarn on Sunday during one telephone conversation, he come talk say the step go helep the force to avoid repeating the same mistakes. Still on the mata, after the IGP Adamu Mohammed announce the end of SARS, people come burst enter social media dey say make president Muhammadu Buhari talk to Nigerians on top dis same matter. The announcement show after different #EndSARS protests take place for across the country and some parts of the world. The Nigerian Police Force come promise say very soon dem go announce one new policing arrangement wen go address some contour wen go dey for the force even as dem don cancel SARS.