The Nigerian Centre for Disease Control (NCDC) don give warning say we go fit get second wave of coronavirus for the country wen go tough well well becos people no dey gree obey d COVID-19 health guidelines. Na one technical adviser for the implementation of NCDC action plan for Adamawa State, Fahad Mohammed, nia drop the hint during the sensitization campaign for Yola. He come talk say the NCDC dey do everything possible so dat dem go fit test more people so dat dis deadly disease no go spread.
Buhari dey arrange Naija- Lai Mohammed
Lai Mohammed wen be d minister of information and culture don talk say the present administration under the leadership of President Muhammadu Buhari dey put the country on a new path of sustainable development. Wen Mohammed dey yarn for one press conference on Thursday to let every know about the activities for the 60th independence celebrations, he come talk say since Naija dey exist, the country don experience civil war, political gbege and many security challenges. The minister come talk say the present administration dey offer “a new beginning”.
Naija Defence:We don kpuff Boko senior men
Naija Defence Headquarters don say their troops of Operation Lafiya Dole don kpuff top Boko Haram commanders during massive clearance operations wen take place for the Lake Chad Basin. Wen defence otota, Major-General John Enenche dey yarn on Thursday for Abuja, he come talk say dem mod the commanders after troops for the Lake Chad Basin, locate their camps and where dem dey shock-in put. Even as Enenche dey hail d security agencies for their efforts, he come talk say the army dey determined to protect the territorial integrity of Naija Major Enenche come still tell Nigerians to dey support the army by to dey report criminal activities for their area.
Court don tell labour to stop their strike
The National Industrial Court don give order wen go stop the Nigeria Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC), their officers, organizations and anybody wen dis matter concern from going ahead wit any strike or stop work from on Monday September, 28 2020. Justice Ibrahim Galadima say d court give the order based on the hearing and determination of the Motion on Notice. Galadima come still give one order wen go stop the unions, their officers and groups make dem no disturb or stop the workers, groups or ordinary Nigerians from getting access to their offices to carry out their duties on the 28th September 2020 or any other date.
Chelsea sama Barnsley 6 kondo
Kai Havertz score hat-trick as Chelsea rotate enter the EFL Cup fourth round as dem kpokpo Barnsley 6 kondo. Havertz been struggle for him first two Premier League games but the before before Bayer Leverkusen star come finish work for d game wen dem play on Wednesday
FG go meet labour today based on strike mata
The Federal Government go meet again with the Nigeria Labour Congress NLC and the Trade Union Congress TUC today based on the threat wen the organized labour make say dem go fire down wit indefinite strike and protest becos of the increment wen the federal government put for light bill and fuel. Na the Deputy Director, Press and Public Relations, Federal Ministry of Labour and Employment, Charles Akpannia drop the meeting date for email on Wednesday. The FG dey expected to talk about d other plans wen dem get during the meeting and na for the Banquet hall for the Presidential Villa, Abuja nai the meeting go for hold. Meanwhile, the federal government don receive ginger to coordinate their recent order on d electricity metering policy. Infrastructure development analyst Onuoha Nnnachi wen yarn dis one on Wednesday for Lagos, come talk say need dey to go beyond the plenty plenty talk, say na action we need now
Delta state government don approve new schools
Delta State Government approve the establishment of six new secondary and three primary schools for different parts of the state yesterday. Na d commissioner for Information, Mr. Charles Aniagwu nia drop dis aproko wen he dey yarn wit news people concerning the key decisions wen dem reach for the online meeting of the State Executive Council wen the state governor, Senator Ifeanyi Okowa take charge of. According to am, the six new secondary schools go dey for Warri South, Ughelli South, Ughelli North, Ika South, Ika North East and Ukwuani Local Government Areas, while the three new primary schools go deyUghelli North, Warri South West and Isoko North Local Government Areas of the state.
Hotel workers wen dem naked for warri don ask for N1 billion
The four employees of the Signatious Hotel for Warri, when reports say d hotel management snap and video their nakedness wen dem come release online becos of d allegations say dem gbanskele money don dey ask for N1 billion naira as compensation and public apology wen go dey published for national newspapers for the yeye treatment wen dem receive. The victims for one letter wen dem send go give the chairmo of the hotel and before before Minister of state for Education, Kenneth Gbagi on Wednesday through their lawyer Bar Kunle Edun come still say make d hotel management remove the pictures and videos from social media and den return all the items and pepper wen dem use force take collect from their accounts wit gun. Bar Kunle Edun when yarn on behalf of the workers come give warning say if d hotel management no do as dem talk nia be say na court dem go see themselves.
Report say oga naked him hotel workers for warri
No be small matter nai play on Tuesday becos of d reports wen rotate come say d management of the Signatious Hotel for Warri, Delta State, treat four of their staffs anyhow. According to d reports, the Chairmo of the hotel and before before Minister of State for Education, Mr. Kenneth Gbagi give order say make dem naked the workers wen be three women and one man kpatakpata. As if that falling hand no reach, d ones wen dey snap dey snap and na so d ones wen dey video dey video too, dem come send d videos and d pictures put for social media. But like dis, activists and social media users don condemn d matter, dem come say make the state Commissioner of Police, Hafiz Inuwa, torchlight the issue and den arrest all d people wen involve for d matter. Meanwhile Egba Ederoghene, the otota of the hotel don talk say him oga no get anything to do with this mata. He come talk say the people wen dey for the picture plan with other politicians to bring him oga down.
INEC don give Obaseki return Certificate
The Independent National Electoral Commission (INEC) don present certificate of return give Godwin Obaseki as the elected governor of Edo state. Obaseki and Philip Shaibu, him deputy wen contest for the state governorship election under the Peoples Democratic Party (PDP) collect the certificate yesterday foe Edo state. May Agbamuche-Mbu, INEC south-south national commissioner when present the certificate give d governor come talk say Obaseki fulfil all the things wen d constitution require to come out as d winner of the election.