President buhari don talk say naija need the money wen dem don borrow for e regime. He say the country need the money for things like road,electricity and rail projects. He yarn this one for the Economic Advisory council meeting wen dem host for internet. Garba Shehu, the senior man wen dey advise presido for media mata con yarn wetin presido talk for the meeting. According to presido “ We get so many wahala with our property” “We just need to borrow so we fit do roads,rail and electricity so investors fit come invest their money for our country.” As e be now,the money wen naija dey owe, both states and federal government don reach about N13trn.
Chinese man don get chieftaincy title
One Ghana community don sama Chinese man chieftaincy title. The Chinese man, Sun Qiang become chief of development for Kwahu-Abetifi community. Dem give am the title “Nkosuohene” of Kwahu-Abetifi. Dem sama am this title after he dash them $5,000 make dem take build new school. Based on their tradition, dem con give am new name, Barima Kofi Ayeboafo. The name “Ayeboafo” mean “person wen do something make other people benefit”. This matter don cause katakata for internet as many people don shook mouth put for the mata. Based on,how you see this mata? Put your comment for the comment section.
Eat wetin we get
President buhari don talk say make naija people Eat wetin we dey produce for naija here. He yarn say as e be so, dem no go reopen border now. Presido for the meeting wen him and Ghana presido,Nana Akufo-Addo attend for london con clear mattas say when some motor dey carry rice and other food products enter naija,dem dey shook small weapons and hard drugs for inside and this no good for any country.
Delta state government don carry curfew from 10pm go 12am
The Delta state government don change curfew time. Na the state commissioner for information, Mr. Charles Aniagwu yarn this one for one press conference for Asaba. He talk say based on the directive from the presidential task force on covid-19, the state government don change curfew time. The new time na 12midnight to 4am. He also talk say the state government go continue to dey transparent for the covid-19 donations as dem don publish names of dose wen contribute money for the pandemic.
Delta State don open youth parliament
The Delta State government don open the first assembly of the state youth parliament. This one take place on Tuesday for the state house of assembly complex. Dr. Ifeanyi Okowa wen Chief Funkekeme Solomon represent for the assembly con talk say this administration dey do everything wen Dem fit do to give youths opportunity through different programs wen go make dem balance. We believe say youths nai be our voice and leaders of tomorrow.
Stop to blame the victim-Osibajo
Vice Presido prof. Yemi Osinbajo don talk say excuse no dey for sexual harassment no matter the victim attitude, the way the person dress or the place when the matter for take happen. Osinbajo download dis informate for one conference wen the Obafemi Awolowo University, Ile Ife organize on Anti-Sexual Harassment. The vice presido come talk say dem need to stop the idea of blaming the victim for every situation.
Dey careful of wayo people- Delta state government
Seceto to the Delta state government, Chiedu Ebie don talk say the state government neva commission any group or people to recruit members enter the joint security taskforce, Operation Delta Hawk wen dem newly form and say dem no get any plan to do so. Ebie make the announcement for one statement wen he release even as he dey clear d air concerning d news wen dey play say some persons and groups dey sell recruitment forms dey give indigenes of Delta Central senatorial district. He come advise the general public, most especially people wen dey long side for Delta Central senatorial district say make dem dey careful of wayo wrists.
Demand and supply nai go determine fuel price- Saidu
From now on, the Federal Government no go dey release guiding price bands for the sale of petrol for filling stations. Na the Petroleum Products Pricing Regulatory Agency PPPRA Executive Seceto Abdulkadir Saidu, nia yarn dis one wen he dey answer questions from news people during one briefing for Abuja, he say the downstream arm of the oil and gas sector don dey fully deregulated. According to am, na the forces of demand and supply and the international cost of crude oil nia go determine d Price of fuel. He come sha talk say the role of the agency go be to make sure say oil marketers no over charge as every petrol dealer go come dey free to source for product and den fix their price.
Naija Languages fit loss-Ado Yahuza
The Executive Seceto for the National Institute for Cultural Orientation (NICO), Ado Yahuza don talk say some Nigerian Languages fit loss if dem no take urgent measures to change things. Na for d 2nd edition of the Nigerian Indigenous Language Programme (NILP) wen shele for Abuja nia Yahuza for take download dis one. According to am, some Nigerian languages including Igbo and Yoruba, fit no survive the next 50 years.
We go put mouth for this matter- NLC to Nigerians
Based on the recent increment for light bill and the pump price of petrol, the Nigeria Labor Congress NLC don tell Nigerians say dem go soon shook mouth put for the matter. Wen NLC presido Ayuba Wabba dey today from Port-Harcort, the rivers state capital, he come talk say the recent move wen the federal government make dey affect workers and business owners, say need dey to review d matter. Wen Ayuba Wabba dey react to the comments wen the presidency make say dem no fit reverse the recent increment, he come talk say the government must dey flexible in the midst of the current economic realities.