The Court of Appeal, Lagos Division fling d appeal wen one before before Senior Advocate of Nigeria, Dr. Joseph Nwobike file yesterday. Nwobike burst enter d court den he come begin challenge him conviction by the Lagos State High Court for d suit wen he file. Dem convict Nwobike for d month of April 2018 becos he try to tamper wit the course of justice unto say he dey bribe court registrars to make sure say him cases go meet d judges wen he want so dat he go fit dey get judgments wen favor am.
Delta dey committed to public school renovation
Delta State Commissioner for Basic and Secondary Education, Chief Patrick Ukah don talk say the Delta State government dey committed to renovate public schools for the state so dat dem go fit meet modern standards. Ukah yarn dis one for Ibusa, when he lead staff of him ministry go visit some Schools. According to am, dem go do everything to make sure say quality teaching and learning process dey for public schools.
James Bond babe,Claudine don kick the bucket
Claudine Auger wey act as Bond babe(Domino) for James Bond film (Thunderball) wey dem act for 1965 don die. She kpai for her home wey dey paris at the age of 78. We neva know wetin kill her. She start her career as model, she rep france for Miss World 1958. For her movie career she don act for English, French and Italian speaking films. picture credit:shuttershocks
Nationwide strike go burst out by January 2020
E clear say the Academic Staff Union of Universities ASUU go start nationwide strike for the month of January becos the Federal Government and the union neva settle their disagreement concerning d Integrated Personnel Payroll Information System IPPIS. The attorney general of d federation AGF office say based on d order wen president Muhammadu Buhari give say all federal employees must enrol for the IPPIS, universities workers must make themselves available for the enrolment during the period. But ASUU no gree, dem say e no go fit make universities’ dey operate freely den dem come say make their members lock up the IPPIS registration…
Make dem pass the 2020 budget sharply sharply
The national assembly don talk say late passage of budget for Naija don really make d development of d country slow. Na Senate presido, Ahmed Lawal nia yarn dis one during one media meeting for Abuja. According to am, d ninth senate decide to take d matter serious den pass d 2020 budget early so that everything go go well for d country
Management team go remain until audit don over
President Muhammadu Buhari don talk say the present management team of the Niger Delta Development Commission (NDDC) go remain until the forensic audit of the agency operations don complete. The new change for the NDDC dey for inside one statement wen the Special Adviser on top Media and Publicity to the President, Mr. Femi Adesina drop today. According to the statement, the supervisory power over the commission go continue to dey with the Minister of Niger Delta Affairs…
High Court don order army to pay 50m damages
The Federal High Court for Warri, Delta State, don award N50m damages against the Nigerian Army for one Mr. Ajayi Oladele wen dem kpuff. According to reports, d soldiers arrest Oladele den dem come beat am till he legoo for Waffi for d year 2017, even as dem dey try to help one businessman recover debt from the guy wen don kpeff. After d guy don legoo, him widow, Esther Oladele, and their three pikins come file the fundamental rights suit against the Nigerian Army and the two officers wen involve for d matter. The judge come still award N100,000 in favour of the family to cover the cost of prosecuting the case…
People wey nor dey pay tax go soon hear word
The Federal Inland Revenue Service (FIRS) go start nationwide tax enforcement exercise on people wen no dey gree pay tax today Wednesday, December 18. For one statement wen Wahab Gbadamosi, FIRS’ head of communication and servicom release, the tax agency advise those wen neva pay their tax say make dem pay up. Abiodun Aina wen be the acting executive chairmo of FIRS come say make those wen neva pay their tax pay up to avoid any inconveniences or disturbance for their operations.
Senate dey ready ground for presido borrowing
The Senate don push President Muhammadu Buhari 2016 – 2018 External Borrowing Plan request give their Committee on Local and Foreign Debts. The house push d President request give the Committee for more legislative work after the Senate Leader, Yahaya Abdullahi present am during their meeting. Meanwhile, the Committee get Senator Clifford Ordia as Chairmo and Senator Bima Mohammed Enagi (APC, Niger South) as Vice Chairmo.
I nor fit sitdon look Presido yamutu our future
Before before Vice-Presido Atiku Abubakar don talk say he no fit just sit down dey watch the government of President Muhammadu Buhari yamutu the future of Nigerians” with him $29.6 billion loan request. D matter na say oga Buhari tell the senate to approve the loan, say becos d money wen d country dey make from oil no dey enough again to take meet the financial needs of the country. But for one article wen Atiku write yesterday, he come dey talk say the loan request na rubbish and say na act of irresponsibility.