The Nigeria police say the ‘operation Puff adder’ wen dem lunch earlier this year don produce positive results. Na d Inspector general of police Mohammed Abubakar Adamu nia download dis informate wen he dey raport wit news people for Abuja. According to am, gallant men of the force don reclaim the public space from bandits when before now been dey in charge.
Court don summon Abubakar Malami and others
One federal high court for Abuja don summon Abubakar Malami, d attorney-general of the federation (AGF), and Yusuf Bichi, director-general of the Department of State Services (DSS), concerning the re-arrest of Omoyele Sowore. Na Inyang Ekwo wen be the judge nia give the order yesterday based on d application wen Marshal Abubakar, one lawyer for Sowore legal team drop where he for take dey seek one order for the release of the activist wen still dey on detention. The court come say make both d AGF and Bichi appear on Monday, December 23, becos of the unlawful arrest and detention of Sowore wen be pro-democracy activist.
FG dey sign bill while senate dey reject new bill
President Muhammadu Buhari don sign the N10.59 trillion 2020 appropriation bill enter law. Oga presido sign the budget when d senate increase by N260 billion from d N10.33 trillion wen dey for the proposal wen oga Buhari submit on October 8th enter law yesterday for Abuja. Meanwhile, this one na the fastest time since Naija return to democracy for d year 1999 wen d dem go submit, pass and den sign d budget before the budget year start. Meanwhile The house of representatives don bounce one bill wen dey seek to provide single term of six years for the president and governors. The house reject d bill wen John Dyegh from Benue state sponsor after dem raise am up for second reading for their yesterday meeting. During d debate concerning the bill, most of the lawmakers say dem no support am say becos nothing dey wrong with the system wen Naija dey currently dey operate.
Senate go approve FG billion dollar loan request
Senate Presido Ahmad Lawan don talk say the upper legislative chamber go grant d multi-billion dollar loan request wen President Muhammadu Buhari make. Lawan wen drop dis informate yesterday wen he dey reason wit news people for one luncheon wen shele for Abuja come talk on the achievements of the ninth senate since wen dem start for d month of June. The senate been bounce d loan request wen dey estimated at $29.960 billion for d year 2016 but the senate presido say dem reject the request den because details no dey wen support am, den he come still talk say “the executive don learn their lesson and say dis time around, the letter come with enough details”.
Army don redeployment 35 generals go one-side
One major shake-up for the Nigerian army don lead to the redeployment of 35 generals. Wen Sagir Musa, army spokesman dey yarn for one statement yesterday, he come talk say Tukur Buratai wen be d chief of army staff approve the redeployment to “rearrange the system so dat dem go fit dey serve better. He come talk say dem get to do the reassignment becos of d recent promotion wen dem give some senior officers.
Payment of 5k a month don start for wafftown
The member wen dey represent Warri South Constituency 2 Hon. Matthew Oporu don start the payment of 5000 naira monthly money give 200 constituents including ten people wen get disabilities, as part of him empowerment scheme. Wen Hon. Oporu dey yarn as dem kick start d ceremony for Warri, he come talk say dis tin wen he dey do so na part of efforts to change the belief wen people get say politicians dey dump d electorates after elections. Wen d Chairmo of Warri South LGA Hon. Michael Tidi dey yarn, he come hail Hon Oporu for dis betalicious tin wen he dey do, meanwhile he come tell other political office holders say make dem imitate am. One of the people wen benefit from d level Fati Onifade come talk say he dey very happy say becos dis na d first time wen dem dey see dis kind tin for the constituency.
We go spend 18 billion to solve flooding problem
Governor Ifeanyi Okowa don talk say the State Government go spend N18 billion take construct six storm drainage projects in order to solve flooding problems for Waffi and Uvwie areas of the state. Na yesterday nia Okowa take yarn dis one wen he dey answer questions from news people for Waff town after he don inspect some projects wen dey go on wen the state government for Warri South, Uvwie and Udu Local Government Areas dey tidy. He come talk say dem don award d contract for two of the projects give CCECC Ltd and Levante Construction Ltd at the sum of N9.5 billion.
Lawmakers don approve N37 billion for renovation
Federal lawmakers don approve d sum of N37 billion for the renovation of the National Assembly complex. On October 8, President Muhammadu Buhari present N10.33trillion budget proposal give the joint session of the national assembly but lawmakers pass N10.594 trillion estimate, wen be increment of N264 billion on December 5. The N37 billion renovation cash na part of the N2.5trillion capital project provision wen the Federal Capital Development Authority (FCDA) go carry out….
Closing of border nor affect free trade agreement
The Minister on top Agriculture and Rural Development, Sabo Nanono don talk say the Nigerian border wen dem close no in any way breach the free trade agreement for the West African sub-region. The minister say dem close d borders in order to protect the country and their citizens from the from all d plenty wuruwur wen dey play for the borders. He say “Free trade no mean say Naija na dumping ground for everything wen others dey import…
The rumour wey dey play say IBB don die na lie
Kassim Afegbua, talk talk person of Ibrahim Badamasi Babangida (IBB) don talk say d news wen dey play say d before before military ruler don denkwes no be true. One rumour blow come say Babangida don kpuff and na so d gist come full everywhere yaganyagan for social media after one online news platform report say d guy don legoo. But wen Afegbua come dey yarn for one statement, he come talk say d the before before head of state dey alive and say he dey bubble well.