President Muhammadu Buhari don appoint Mr. Edward Adamu as the new Chairmo of the Asset Management Corporation of Nigeria AMCON. This tatafo dey for one letter wen oga presido send give the Senate yesterday. For d letter wen carry December 9, 2019 as date wen Presido of the Senate, Ahmad Lawan read for their meeting, dis one dey in accordance with Section 10(1) of the Asset Management Corporation of Nigeria Act, 2010.
Ban for banger and firework still dey in force
The Commissioner of Police for Delta State, CP. Adeleke Adeyinka don announce say d ban wen dem place on top d use of banger and other fireworks still dey in force, he come talk say the Command go use all d laws wen dey against anybody wen go use dem. Wen d CP dey yarn for one release, he come talk say the ban dey important in order to safe-guard public safety and avoid distractions to security operatives, especially during the Christmas season. He come advise Parents/guardians say make dem guide their pikins and wards well say becos dem go deal wit anybody wen dem go gbab according to the law.
Budget padding worst for health & edu. institution
The Independent Corrupt Practices And Other Related Offences Commission (ICPC) don talk say na d health and tertiary education institutions nia the places wen worst pass wen people take dey pad salary budgets. Talk talk person of d ICPC, Rasheedat Okoduwa, wen yarn dis one come talk say the agency launch their System Study Review for Abuja on November 19. Ms. Okoduwa come use the case of the Federal Medical Centre, Bayelsa as example, when she say get more than N900 million as surplus for their salary purse.
House of reps wan investigate DSS unto their stunt
The house of representatives don decide say dem go investigate the way wen the Department of State Services DSS take burst enter the federal high court compound for Abuja. Operatives of the agency burst enter the court when dem dey make attempt to rearrest Omoyele Sowore, leader of the #RevolutionNow movement. The lower legislative chamber make the decision after Ndudi Elumelu, the minority leader raise d motion for their yesterday meeting. Elumelu come talk say the lawmakers need to soji d matter wen according to am na attempt to take overpower the judiciary. Meanwhile Rights Lawyer Anibehe Effiong don talk say d apologize wen the DSS apologize based on d way wen dem take call out enter the Federal High Court for Abuja no dey enough. Wen Effiong dey yarn for one interview, he come talk say need dey to take very serious action so dat dis kind thing no go repeat itself again.
Everybody dey shook mouth for Sowore matter
Like the presidency, the All Progressives Congress (APC) don defend the State Security Service (SSS) based on d way wen dem take treat one activist, Omoyele Sowore leader of #RevolutionNow movement. For the first time wen dem officially talk concerning d way some SSS officials take rearrest Mr. Sowore on Friday for one Abuja Federal High Court, the APC use brain and na so dem no gree condemn the secret police. Instead, the ruling party come dey attack Atiku Abubakar, when like millions of Nigerians don condemn d way wen d SSS take burst enter the court go rearrest d activist. Meanwhile The United States government don talk say dem dey concerned about d way wen the department of state services (DSS) take dey treat Omoyele Sowore. Wen US senator, Cory Booker dey yarn dis past weekend, he come talk say no support d way wen the DSS take rearrest Sowore for court. He come talk say d way wen d state service take arrest Sowore no go well at all say na big injustice.
NCC don put centres for emergency inside Naija
The Nigerian Communication Commission (NCC) don establish den operationalize Emergency Communication Centres (ECC) for across 18 States of the country plus including the Federal Capital Territory (FCT), as part of ways to take tackle the security challenges wen dey carry rise anyhow. Na the Executive Vice Chairmo of NCC, Engr. Umar Garba Danbatta nia yarn dis one for d first Security and Emergency Management Awards (SAEMA) wen shele for Abuja. According to the NCC oga, the commission decide to construct and also operationalize the ECCs across the country in order to provide one universal, toll-free emergency telephone short code (112) wen members of the public for Naija go fit dey use in case yawa gas or for emergency purposes.
We nor go declare Orji Uzor Kalu seat vacant
The Senate don talk say dem no go lai lai declare the seat of their chief whip, Orji Uzor Kalu wen dey guilty of fraud vacant. Wen talk talk person for d senate Godiya Akwashiki dey yarn wit news people for Abuja, he come talk say d declaration of him seat vacant dey against the law. According to am, e no get anywhere for the Nigerian Constitution wen say them dey free to declare d seat of any senator wen dey face prosecution or wen d lower court don say dey guilty, vacant.
Omoyele Sowore and DSS kasala for Obodo Naija
The presidency don finally yarn concerning wetin Omoyele Sowore, leader of #RevolutionNow movement dey pass thru for the hands of the Department of State Services (DSS). E no reach 24 hours after the secret police free am before dem rearrest am again. This one so come make both people wen dey for d country and outside the country dey talk. But wen Garba Shehu, presidential spokesman dey yarn for one statement yesterday, he come talk say Sowore na person wen the secret police get interest in. According to Shehu, Sowore no be ordinary citizen wen dey just dey express him views freely for social media and the internet. Still on still, Supporters of Sowore still dey hold ground say no amount of intimidation or harassment wen go fit do d guy man anything. Deji Adeyanju wen don dey speak against d way wen d DSS take hold d before before presidential aspirant wen come still condemn d way wen d state service take re-arrest am come talk say Naija democracy and rule of law must na something wen we must protect. Meanwhile on top dis same matter, The US Bureau of Democracy, Human Rights and Labor Affairs (DRL) don talk say dem really dey concerned say d DSS rearrest Omoyele Sowore wen be d leader of #RevolutionNow. The bureau dey under the US Department of State, the equivalent of Naija foreign affairs ministry. For one tweet wen show dis past weekend, the office come talk say d principles of democracy nia be respect for the rule of law, judicial Independence, political and media freedom and due process.
Burna Boy wan win Grammy Award come Naija
Burna Boy don talk say he go bring the grammy award come naija. He talk dis one for cardi b concert wey dem do for lagos. Them nominate burna boy for the grammy awards wey dem go do for January 2020. Many Nigerians dey hope say Burna boy go past the nomination stage and even carry the award come house. Meanwhile South African rapper wey dem dey call AKA don congratulate Burna Boy as dem nominate am for the grammy award.
BBNaija Diane don act short film with Iyanya
BB Naija former house mate, Diane Yashim don do collabo with musician wey dem dey call Iyanya to act short film. The name of the film na the therapist. Yashim na the person wey produce the film, she con share the trailer of the movie for her instagram page. The film na Evans Edeha naim direct am, Kenyan actress Lynn Nardia Bently act for the film too. https://www.instagram.com/p/B5xZ_5KndkN/ When Diane dey the big brother house she show her skills small for acting and she con talk say she get passion for acting when Akindele con visit the house mates. Like dis she don take her omomo step for the film industry.