Before before vice presido Atiku Abubakar don blast the federal government for the way wen dem no take dey push money dey enter d education sector. Wen Atiku dey yarn yesterday for Abuja, he come talk say he dey wonder why d federal government no dey make efforts to invest better money for the sector. According to am, the current state of education for the country no go fit continue to dey sustain the population of Naija.
DSS don rearrest Omoyele Sowore for inside court
The Department of State Services DSS don rearrest Sahara Reporters publisher, Omoyele Sowore, and him co-defendant, Olawale Bakare, after today proceedings for the Federal High Court for Abuja. According to reports, operatives of the DSS burst enter the courtroom go arrest am. Dem rearrest am after the close of today proceedings when the judge, Justice Ijeoma Ojukwu, been adjourn till February 11.
Me and Cardi B record new Fall music for Feb
One video don show face wey Cardi B dey dance to Davido “Fall” music. For the video Cardi B dey dance to verse wey be like say she sing for the song. This video go viral on December 4, 2019. Unto say some naija pipo dey talk say the version na cover of the original song, OBO don come out talk say the song both of them sing am but them never release the song. Not a cover we recorded this last feb … just never dropped https://t.co/Njt0y6TwSn — Davido (@davido) December 6, 2019 OBO talk dis one for e twitter page. Cardi B go perform for Eko Hotels and Suites on Saturday December 7, 2019.
Electricity companies don loss about 931bn naira
Electricity distribution companies for the country post total loss of N931bn from 2014 to 2017, and dis one na according to PwC Nigeria. Partner and Chief Economist, PwC Nigeria, Dr. Andrew Nevin, say the Discos don continue to dey report losses, and say d Discos need nothing less than N1tn make things for balance well. According to am, at tariff charge of N80/Kilowatthour, Naija electricity tariff still dey below most developed industrialised countries…
Some ASUU members don go against union orders
E clear say some members of the Academic Staff Union of Universities ASUU don dey enroll for the Integrated Personnel Payroll Integrated System IPPIS and dis one dey against d order of the union. According to investigations wen news people carry out, kians wen lecturers for take dey register for the IPPIS include the University of Calabar and the University of Nigeria, Nsukka. Last month, ASUU say dem no go lai lai enroll for the IPPIS undermining d order wen the Federal Government give say any worker wen no register no go get December salary…
FG dey concern about importation of metal products
The Federal Government don talk say dem dey concerned about the importation of metal products. The Permanent Seceto for d Ministry of Mines and Steel Development, Dr. Abdukadir Muazu, wen yarn for Jos for one workshop wen dem organise for stakeholders for Plateau, Benue and Nasarawa States, come talk say dis situation don really affect Naija foreign exchange bad bad. But Muazu come talk say the federal government dey make efforts to assist local steel producers so dat dem go fit dey compete well with other imported products… The House of Representatives dey call for more efforts to take end d level of unemployment for the country. This one na according to one motion wen Muhammed Kazaure Gudaji d member wen dey represent the Roni/Gwiwa Constituency for Jigawa state drop… According to am, poor planning wen he say nia be the main reason for the situation na something wen dem must address
Fine Boi Jim Iyke don come back to film acting
Jim Iyke don give reason why he come back to acting. He talk say one nollywood production wey dem dey call Seven and A Half Dates bring am come back to the movie industry as he soji the script of the movie. He talk dis one after the news come out say the movie go soon show for Netflix. The movie go join other nollywood movie wey Netflix go show. Meanwhile for Cinema the movie don make about 33 million naira. Dem release the movie for cinema on August 3, 2018. People wey act for inside na: Mercy Johnson, Sola Sobowale, Toyin Abraham, Bayray Mcnwizu, Frank Donga, Ali Nuhu, Akin Lewis, Jim Iyke, and Fathia Williams.
Statistic don come out unto janting things
Na about 1,044 Nigerians nia d Federal Government stop from leaving the country for d year 2018. Nobody really know the reason wen make the government take d decision, but according to reports, the action still affect 22,889 foreigners when dem no gree allow enter the country. Na so dem still deport 17,616 Nigerians from other countries last year while dem repatriate 339 others from different countries.
Fuel nor go scarce during christmas celebrations
The Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) don talk say fuel no go scarce during the Christmas celebrations. Na Mele Kyari wen be group managing director (GMD) of the NNPC, nia yarn dis one during one meeting wen stakeholders for the oil and gas sector hold for the presidential villa, Abuja. For d month of December 2017, na so fuel scarce anyhow for the country becos of d shortfall for the supply of petroleum products and na d same thing nia still happen for d year 2018.
DSS dey find why group wan gbege for naija
The Department of State Services (DSS) say dem don find out d plan wen some groups get to cause gbege for the country. Wen Peter Afunanya, talk talk person for the DSS dey yarn for one statement yesterday, he come talk say the groups don plan to cause protests, mass action and violence with d aim to cause lawlessness and commotion for the country. The DSS come warn those people wen dey involved for d matter say make dem stop, den dem come still tell parents to warn their children say make dem no allow anybody use dem take cause trouble.