Relief come the way of some Health care centers for Udu Local Government Area of Delta State yesterday as the wifey of d Executive Chairmo of Udu Local Government Council Mrs. Shirley Brown distribute medical equipment wen worth millions of naira go some Health care centers for Udu. Some of the equipment include hospital beds, lamps wen dem take dey born, pumping machines, lighting equipment, thousands of bed sheets plus including others. Wen Mrs. Brown come dey yarn during the presentation for Otor-Udu, she come talk say she fire down wit the project because most of d Health centers wen she don visit no get wetin e take to meet health needs of the people …… CUT…UDU LGA Wen the Matron of Aladja Health care centre Mrs. Omoraka Omojekovie come dey yarn on behalf of other Health Centers wen benefit from d matter, she come hail Mrs. Brown and d same time and at d same time, she come promise say dem go use the equipment well.
Three people don die because of Kogi election
The police don confirm the death of three people during the governorship election wen shele for Kogi state. Akeem Busari, commissioner of police for Kogi, when confirm the deaths give news people come talk say the command still dey compile d report on the election to really know the actual number of people wen legoo. Busari come still talk say dem arrest 10 people across the state during the election.
Lagos Government don close down religious houses
The Lagos State Government close down eight churches and Mosque for across the state yesterday becos dem go against environmental pollution regulations. Dr. Dolapo Fasawe, General Manager, Lagos State Environmental Protection Agency LASEPA when lead the exercise, come talk say dem close down the facilities in order to save the people from health gbege wen the activities of the centres go fit cause. The LASEPA oga come talk say hiding place no go dey for any religious organisation when fail to operate within the rule of the law, no matter their religion.
David lyon don win Bayelsa governorship election
The Independent National Electoral Commission INEC don declare David Lyon wen be d candidate of the All Progressives Congress (APC) as d winner of the Bayelsa governorship election. Lyon beat Douye Diri wen be d candidate of the Peoples Democratic Party (PDP) for six out of eight local government areas of the state. The APC get 352,552 while PDP get 143,170 votes, wit space of 209,382. This one the first time wen opposition party go win governorship election for the oil-rich state since the return of democracy for d year 1999. Meanwhile, The PDP don reject the Bayelsa state governorship election results. Na the Bauchi state gov. Bala Mohammed nia yarn dis one wen he dey voice wit news people concerning d result of the election. He come talk say the PDP go forward march go the election tribunal
FG nor go change mind about social media cleansing
The Federal Government don talk say dem no go change their mind concerning d cleaning wen dem don plan to do for the social media space. Na d Minister on top Information and Culture Alhaji Lai Mohammed nia yarn dis one for Abuja during one meeting wen he get with online publishers. He come talk say no amount of criticism go stop the government from going ahead with this their plan. Meanwhile Wen Senate Minority leader Eyinnaya Abaribe dey yarn for one interview, he come blast the federal government for d way wen dem take dey continue to dey push the bill. He come talk say dis move go make am look like say na military we dey
Suspend no national identity card no jamb until 2021
The House of Representatives don tell the Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) to suspend dis their “no national identity number NIN, no JAMB” policy until 2021. The house decide dis one based on d motion wen Zainab Gimba (APC-Borno) move. For d month of September, JAMB through Fabian Benjamin wen be their talk talk person clear candidates wen dey reason to write JAMB say the NIN go dey compulsory for the UTME registration for 2020. The lawmakers come say d move make sense becos e go make JAMB fit collabo with the National Identity Management Commission (NIMC) and den make d UTME process dey very transparent. But still dem say make the board delay the process until 2021 so dat d candidates go get more time and better awareness about d matter.
Election tori as he dey hot from kogi and bayelsa
The All Progressives Congress APC don bounce the judgment of the Federal High Court for Yenagoa when give ruling say the party no get candidate for the Bayelsa State governorship election on Saturday. Wen the APC dey yarn for one press briefing yesterday, dem come talk say dem go appeal the judgement say becos their lawyers don already dey work on the processes to first secure stay of execution. On Wednesday, the court order still stop the APC say make dem no bring any other governorship or deputy governorship candidate for the elections. Meanwhile The Deputy Inspector General of Police for Operation, AbdulMajeed Ali don warn those people wen dey plan to snatch ballot boxes during on Saturday elections for Kogi and Bayelsa States say make dem think twice becos the police no go take am easy wit people wen go behave anyhow. Wen Ali dey yarn for one press conference yesterday ahead of on Saturday elections for Kogi and Bayelsa States, he come talk say the Inspector General don push enough personnel wen go police the states well and also deal with anybody wen go do anyhow during the election. The DIG come talk say the police dey determined to create environment wen dey secure and peaceful enough to give confidence to the political actors so dat dem go fit vote well and so dat other political activities go fit go well and also for the citizens to freely exercise their rights.
Kasala burst as gun men shoot bayelsa radio van
Men don shoot one guy wen dey drive van with Bayelsa Radio, simon Onu die dem some others come get injuries for one political rally wen play for Nembe for Bayelsa state. According to reports, the guys wen carry fash burst enter the rally of the Peoples Democratic Party (PDP) on Tuesday even as the event dey go on. Meanwhile, dis one dey happen three days to the governorship election for the state.
We go fashi hate speech bill because of hardship
The senate don talk say dem go fashi the hate speech bill if e go bring about hardship for Nigerians. Na Godiya Akwashiki wen be d vice-chairmo of senate committee on media nia yarn dis one wen he dey voice wit news people for Abuja yesterday. According to am, whether dem go pass or not depend on the effect wen e go get on the lives of Nigerians.
APC for Delta say dem nor support the Executive bill
Delta State All Progressives Congress don talk say dem no support the Executive Bill wen dey before the State House of Assembly wen dem go soon pass wen dey seek for amendment of the law to include one before before Speaker of the State House of Assembly, wen be Acting Governor of the State for a period of less than three months to be beneficiary of the pension law for before before Governors and their Deputies. The APC wen download dis informate give news people through the party Publicity Seceto Barr. Sylvester Imonina come complain about d big retirement benefits of Governors and Deputy Governors wen include; five bedroom duplex for the State and any other State for Naija wen dem furnish well wen worth more than N300,000.000.00 (three hundred million naira), Two motor every two years, wen must not be less the sum of #20,000.000.00 (twenty million naira) for one of d motor, free medical treatment within and outside Naija for the before before Governor, Deputy Governor and members of their immediate families. Imonina come talk say d proposal big pass wetin the Revenue Mobilisation, Allocation and Fiscal Commission (RMAFC) prescribe for before before Governors and their Deputies by far.