Presido of the Senate, Ahmad Lawan, don tell the Committee on Appropriations to lay their report on the 2020 budget on November 26, for torchlighting and passage before the end of the month. Lawan, when yarn dis one for their meeting yesterday come hail d different committees for d way wen dem take round off their budget defence sessions according to the schedule. He come talk say the National Assembly still dey determined to return back to the January-to-December budget cycle.
DSS shoot gun to pursue protesters from their HQ
Operatives of the Department of State Services DSS fire gun shots den dem come use pepper spray take pursue protesters when gather around the service headquarters dey ask for the release of Omoyele Sowore yesterday. The protesters when carry different boards been dey round up their sit out when the matter take play. Wen leader of the protest, Deji Adeyanju dey reason wit news people, he come promise say the protests go continue.
Make dem remove ban from fuel wey near border
The House of Representatives don tell the Nigeria Customs Service to remove d ban wen dem put on top d supply of petroleum products to fuel stations wen dey for the land borders. For their yesterday meeting, the lower legislative chamber say the ban dey seriously dey affect Nigerians, especially those wen dey for border communities. The matter na say d federal government through the customs, give order say make no petroleum products go fuel stations wen dey within 20km of the borders, in order to checkmate smuggling. But telecommunications operators for the country don give warning now say dis one go fit make the network get d way e be.
Make police for delta dey professional and careful
The Delta State Chairmo of d Nigeria Union of Journalists (NUJ), Comrade Michael Ikeogwu don tell the Delta State Police Command say make dem dey learn to dey professional and careful even as dem dey carry out their duty. Ikeogwu yarn dis one wen he dey voice wit news people for Asaba, the state capital. The Chairmo when react to some recent reports of how our olokpa dem take dey oppress news people wen dey on duty, come say make the state commissioner of police, Mr. Adeyinka Adeleke gbab those of dem wen dey responsible for all dis kind behavior and say those wen dey guilty need to face the law. Meanwhile, d state commissioner of police, Adeleke don talk say he no know of any news person wen d police oppress for any part of the state.
File your yearly return or we go remove your name
Corporate Affairs Commission CAC don tell companies wen dey operate for the country say make dem file their yearly returns according to the law or say dem go remove their name from their register. Wen Mr. Moses Adaguusu, Head Public Affairs of d CAC dey yarn wit d News Agency of Nigeria for Abuja, he come talk say dem decide to make d move becos of the need to for the commission to dey aware of companies wen still dey in operation and those wen no dey operate again. The yearly return na compulsory requirement for every enterprise or incorporated trustees must file every year by sending to CAC return for the prescribed form wen contain specified matters wen relate to the organisation in accordance with Companies and Allied Matters Act (CAMA).
Naija dey export some kind materials go China
About two-thirds of Naija mineral exports for 2017 enter China, and dis one na according to one recent report on solid minerals wen show. The audit report wen the Nigeria Extractive Industries Transparency Initiative (NEITI) drop come still show say three of the 26 minerals wen dem export for d year 2017 account for 73.81 per cent of total exports. The three commodities nia be Zinc ores and concentrate, Lead ores and concentrate, and Silica Sands and Quartz.
2020 budget go cover many road for Oyo State
Abdulfatai Buhari, d senator wen dey represent Oyo north senatorial district don talk say the 2020 budget go fit only cover 500 roads out of the 3,800 wen dem don identify say need attention for across the nation. Buhari, when be still the chairmo for d senate committee on land transport, come talk say Babatunde Fashola, d minister on top works and housing, present the list of 3,800 roads to him committee. Although the ministry get the highest figure for the 2020 budget proposal with N262 billion wen dem allocate to am, and the senator don talk say na only 500 roads nia d dough go fit cover .
FG need to sustain border closure pass two years
One member of the House of Representatives, Simon Atigwe wen dey represent PDP-Enugu, don tell the Federal Government to sustain the closure of land borders pass two years so dat Nigerians go fit reap the benefits. Atigwe, when yarn dis one for one interview wen he get with news people for Abuja, come talk say d border wen President Muhammadu Buhari close na d best policy so far wen he don put in place. The lawmaker come talk say apart from say d border wen dem close dey helep to checkmate the rate at which fash dem take dey enter d country wen don make dia issue of insecurity plenty, he come talk say e go still force Nigerians to go back to agriculture.
Warri South LGA don release more fishing boats
As part of moves to take increase Agro-economy for coastal communities, Authorities of Warri South Local Government Area don donate six fishing boats with engines plus including fishing nets give Co-operative Societies for the local government area. Wen chairmo of Warri South LGA, Hon. Michael Tidi dey yarn, he come talk say he gather belief say this move go helep to create jobs with their positive multiplier effects. Wen the lawmaker wen dey represent Warri South Constituency 1 for Delta State House of Assembly, Dr. Augustine Uroye dey yarn, he come talk say dis one na d first of other economically beneficial programmes for the state
I ready to face trial if you assure me safety
Nnamdi Kanu, leader of the Indigenous People of Biafra don tell the Federal High Court for Abuja say he dey ready to face trial if only d court go guarantee him safety. Kanu when yarn through him lawyer, Ifeanyi Ejiofor, come tell the court say dem been file the application to take restore him bail so that he go fit face him trial on April 1st. Wen Justice Binta Nyako come dey deliver d ruling, she come adjourn the matter till Jan. 16, den he come still talk say the only way wen he go fit take guarantee Kanu safety na to keep am for prison. She come talk say even judges no dey safe again for the country.