The before before Governor of Anambra State Mr. Peter Obi, don talk say no government go fit exist without securing the lives and properties of the citizens. Mr. Obi wen yarn dis one to take mark Naija 59th Independence Day, say d country need to do something sharp sharp concerning their present security situation. Mr. Obi say one of the major things wen dem need for the country to grow d economy na investment, but still he come talk say he dey wonder whether d nation dey secured for investors. He come talk say security na one major factor wen dey attract foreign investors.
Okowa dey hail Michael Tidi administration
Delta State Governor, Dr. Ifeanyi Okowa, don hail the Dr. Michael Tidi led Administration of Warri South Local Government Area, for d way wen dem take initiate plans to create world-class technology hub and 1000 hectare Oil Palm Plantation for within the local government. The governor yarn dis one through him Chief of Staff, Chief David Edevbie, during the opening ceremony of the second Warri Economic Summit. Okowa come talk say him administration go follow the agenda of the local government leadership…
Results wey play for Tuesday Champions league
Bayern Munich brush Tottenham 7-2 for the UeFA champions league game wen dem play for North London. Before before Arsenal player wen dem dey call Sergio David Gnabry down 4 goals for Bayern, Robert Lewandowski drop two den Joshua Kimmich come drop one. No forget say na Tottenham and Liverpool nia play champions league finals last season. Results For Other Matches Lokomotiv Moscow 0 – 2 Atletico Madrid Red Star Belgrade 3 – 1 Olympiacos Tottenham Hotspur 2 – 7 Bayern Munchen Galatasaray 0 – 1 PSG Juventus 3 – 0 Bayer Leverkusen Real Madrid 2 – 2 Club Brugge Manchester City 2 – 0 Dinamo Zagreb Atalanta 1 – 2 Shakhtar Donetsk
Poor people for Naija plenty pass India and China own
Peter Obi, before before governor of Anambra state don talk say d poor people for Naija here plenty pass d ones wen dey for India and China. Na for The Platform wen be one yearly conference wen d Covenant Christian Centre organize for Lagos nia Obi for take talk dis one. Obi come say na Naija nia be the most stressful country for the world. The vice-presidential candidate of the Peoples Democratic Party (PDP) for the last elections come talk say as Naija na d poverty capital of the world, he say na six people for Naija nia dey fall into poverty every minute.
Weekend maras wey play for premier league
Leicester City kpokpo Newcastle United 5 kondo for d premiere league game wen dem play. Nia Ricardo Pereira, Jamie Vardy, Preat Dummett, and Wilfred Ndidi nia down d goals for Breden Rogger side and dis one so nia be their biggest ever Premier League win and also their fourth victory for five matches for the season.
Kidnappers don release Samson Siasia mama
D kidnappers wen kidnap Ogere Betty, d mumsi of Samson Siasia, one before before Super Eagles player and coachee don free her. The Bayelsa state police command confirm her release yesterday for Yenegoa. You go remember say na since on d 15th of July, nia d badoo dem take kidnap the 76-year old for her Caban for Odoni for Sagbama, Bayelsa state.
100 Candidates don get placement for Nigerian Universities
The Joint Admissions and Matriculation Board JAMB say more than 100,000 candidates when meet admission requirements don get placements for Nigerian universities for the 2019/2020 academic session. Wen Dr. Fabian Benjamin, talk talk person for JAMB dey yarn for Lagos, he come talk say the board dey hope to use 80 to 90 per cent of the available spaces for this year admission. Benjamin come talk say the board projection for this year admission na to make sure say candidates use more available spaces unlike for 2018 where dem no use about 40 per cent of spaces.
Court don send Sowore back to DSS Custody
One federal high court for Abuja don send Omoyele Sowore, leader of RevolutionNow Movement, back to d custody of the Department of State Services (DSS). The activist don dey for detention since August 3 when d DSS take arrest am for Lagos. One court been grant am bail but the secret police no gree release him. Today, he ball enter based on d 7-count charge of felony wen d federal government bring against am and Olawale Bakare, him co-defendant. Ijeoma Ojukwu wen be the presiding judge nia give order for the DSS to still hold Sowore and Bakare till on Friday when she go hear their application for bail.
32 shops don close for Orumaro Community
Authorities of Uvwie LGA seal 32 lockup shops for Orumaro Community wen dey near Jakpa Junction dis past weekend. The authorities lock d shops becos d people wen dey occupy dem no gree clean their surrounding during the monthly environmental sanitation on Saturday. Chairmo of the LGA Hon. Ramson Onoyake when complain say he no like the attitude of traders towards their business environment come talk say from now onwards, he go dey visit business and residential areas for the council without information so dat he go fit dey gbag those wen dey error
Delta state go continue to repair federal roads
Undermining say President Muhammadu Buhari warn state governors say make dem no fix federal roads if dem know say dem go demand for refund becos d federal government no go refund shigbain give dem, Delta State Government don talk say dem go still continue wit d work wen dem dey do for Federal roads wen don caput for across the state. You go remember say the State Government say dem don spend more than one billion naira take arrange federal government roads wen don bad for across the state. The Commissioner for Works for the State, Chief James Augoye come talk say governor Ifeanyi Okowa dey committed to make sure say all d roads dey okay for across the state