Lanre Issa-Onilu, spokesman for the All Progressives Congress (APC) don talk say d year 2018 dey tough for the ruling party because dem really see pepper. Wen Issa-Onilu dey yarn yesterday, he come talk some kind winchi winchi find their way enter the APC wen dem merge for the year 2014 but dem come dive enter the Peoples Democratic Party (PDP) after dem don cause enof okamuka for the party. He come talk say these people so wen comot from the party arrange themselves as stumbling-block for the APC administration.
FG Don Submit Budget
Federal government don budget a total of N160bn this year wen dem go use take tidy adjustments wen go fit come up as a result of the planned increment for d minimum wage. The amount so dey for the 2019 budget proposal wen President Muhammadu Buhari submit give the National Assembly. The 2019 budget wen be estimate of N8.83tn dey made up of N4.04tn for recurrent expenditure, N2.03tn for capital expenditure and N2.14tn for debt servicing, plus including others.
Strike Go Benefit Us
The Academic Staff Union of Universities ASUU don talk say d strike wen dey fire down wit na something wen go profit d nation. Wen the National Presido of ASUU, Prof. Biodun Ogunyemi dey yarn for one interview ahead of their meeting wen dem go get with the Independent National Electoral Commission INEC on Friday, he come talk say nobody get sole control of national interest. He come talk say dem no go call off the strike until the Federal Government do wetin d union day ask for. Meanwhile, different people don tell ASUU to end the strike so dat university students go fit go back to kians and so dat the National Youth Service Corps members go fit work as ad hoc electoral officers during the February and March general elections.
Pulisic Wan Buy Waka Come Chelsea
Christian Pulisic go join Chelsea for the summer for £58million and dis one so na according to him club Borussia Dortmund. According to reports, the American midfielder agree to go Stamford Bridge for the month of November unto say Dortmund accept say dem go hail am. Based on the confirmation of the move, the USA international talk say body dey sweet am about the new challenge.
Transaction charge don comot
Diamond Bank Plc don talk say all their customers for across the world go fit begin use their bank cards now for Access Bank ATM without d payment of N65 for every transaction. The bank make dis statement yesterday wen dem dey wish their customers happy new year. The bank presently dey merge with Access Bank and dem dey expected to be the biggest bank for naija wen d deal don finish.
Chelsea wan hummels
Chelsea go need to pay £30million to take sign Bayern Munich Mats Hummels for d month of January even as them dey find defensive reinforcements. The Germany international wen win 70 caps for him country, no be first choice for him club again and e clear say he go ready to move to get regular game time. Chelsea oga Maurizio Sarri don talk say him defence na area wen need to improve so dat him club go fit dey finish work wella.
Rice Farm on Fire
Some suspected herdsmen don set fire for more than 20,000 hectares of rice farm wen belong to Benue State Governor Samuel Ortom for Guma Local Government Area of d state. Wen the governor dey yarn wit news people for one telephone, he come talk say he neva harvest him rice farm, before the suspected herdsmen set fire put. According to reports, dis one na the fourth time wen dem dey attack Ortom farms.
Police Palava
The Nigeria Police Force don talk say their operatives wen dem send to go arrest Senator Dino Melaye for him bonk no go comot from there until the Senator surrender himself for arrest and investigation. The Police wen download dis informate yesterday come talk say Senator Dino Melaye dey wanted by the Police becos he jump comot from their motor becos he wan dodge arrest and also becos him and him jaguda dem shoot one Sergeant Danjuma Saliu for the month of July, 2018. Wen d force’ Public Relations Officer, Jimoh Moshood come dey yarn for d Force Headquarters for Abuja, he come talk say dem no go comot from there until Melaye surrender himself for arrest and investigation. One Washington-based group, International Strategic Studies Association ISSA, don talk say the death of one before before chief of Air Staff, Air Chief Marshal Alex Badeh, and one before before Chief of Administration of the Nigerian Army, Maj.-Gen. Idris Alkali, no be something wen just happen like dat. According to reports, na one gang of youths wen dey protest for along Jos-Bauchi Road nia kpuff Alkali on September 3, while some badoo dem come kpuff Badeh for along the Abuja-Keffi Road on December 18. ISSA, wen be one non-governmental organization wen dey involve for national and international security and strategic policy, talk for one special report dis past weekend say dem kpuff the two men to hide wetin dem describe as the pattern of corruption for the current military leadership for Naija.
PDP vs APC
Festus Keyamo, spokesman for President Muhammadu Buhari Campaign Organisation don tell Atiku Abubakar, presidential candidate of the Peoples Democratic Party (PDP), say make he stop to dey lie against Buhari if he no get evidence. Keyamo yarn dis one wen he dey react to the demand wen Atiku make say make security agencies probe Buhari family concerning d ownership of substantial shares for Etisalat Nigeria and Keystone Bank. Wen the senior advocate of Nigeria (SAN) come dey yarn yesterday, he come accuse the PDP say dem dey spread fake news, and say their candidate no gree issue personal statement up till this minute wen carry details of him record of serious corruption and abuse of office”.
Action Against Presido
Coalition of United Political Parties don file legal action against President Muhammadu Buhari and the Police Service Commission becos of wetin dem call plot to extend the tenure of the Inspector General of Police, Ibrahim Idris, by six months. For one press conference wen shele for Owerri yesterday, the CUPP spokesperson, Ikenga Ugochinyere talk say the opposition parties get am for good authority say the president wan extend the IG tenure wen suppose retire on January 15, 2019. Ugochinyere come accuse the National chairmo of the All Progressives Congress APC Adams Oshiomhole and other APC big gbogons dem say na dem nia dey lead the campaign for d extension of the IG tenure.