The people wen dey protest for Benikrukru community for Gbaramatu Kingdom of Warri South-West Local Government Area don promise say dem go continue to occupy Chevron Nigeria Limited facility wen dey for the area until their Managing Director visit where the oil spillage wen dem say their facilities cause. The protesters wen include women, youths and other indigenes of the area come still talk say d tin wen Chevron Nigeria Ltd dey yarn say the oil spill no be from their Abiteye, Makaraba and Utonana oil fields no be true. Chairmo of Benikrukru community, Mr. Solomon Eri wen reason wit news people on Monday come promise say the people no go rest until d company don do wetin dem want. Mr. Eris come talk say the reason wen go make d protesters comot from the facility na when top management of the company wen their MD dey lead visit the place wen d okamuka for take happen so dat dem go know d level of damage wen the alleged oil spill from CNL don cause d people wen dey long side for d community.
We dey committed to gas revolution-Buhari
President Muhammadu Buhari don talk again say him administration dey committed to gas revolution for the country. Wen oga Buhari dey yarn on Monday during the ministry of petroleum resource and NLNG 10 years of gas development conference, he come talk say Naija must tap into the big gas reserve to solve some of the current challenges. He come hail the make sense relationship wen dey between the different government agencies for the successes wen dem don record for the gas sector.
Truck kill two for Warri
Na one person nia dem don confirm dead after one truck wen carry crates of bottled drinks run enter two keke for Jakpa junction yesterday evening. The okpetu happen after the truck wen dem say belong to the Nigerian Brewery company lost control for Jakpa junction wen dey always dey busy. The Uvwie local government Chairmo Hon Ramson Onoyake wen confirm d report even as he dey yarn wit our news person come talk say dem don arrange security for there to make sure say everything dey well.
Resident doctors threaten to strike
The Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don threaten say dem go fire down wit indefinite strike on April 1, if dem no pay members, d salaries and allowances wen dem dey owe dem. The decision dey for one letter wen NARD drop after their extraordinary national executive council meeting wen shele for Abuja. According to the letter wen Uyilawa Okhuaihesuyi, Jerry Isogun, and Dotun Osikoya, president, secretary general, and social secretary gather body sign, the association say government neva gree address d issues wen dem raise for d ultimatum wen dem drop earlier for January 2021.
Things don dey better for Naija-Adesina
Femi Adesina wen be special adviser to the president on top media and publicity don talk say need dey to hail Naija because things don begin dey better for the country. Wen Adesina dey comment on Naija 2020 unemployment figures on Sunday, he come talk say na Nigerians way to dey focus on only the negatives and den pay little attention to the positives. He come talk say some positive things still dey for Naija economy depending on d aspect wen we dey focus on. According to the Q4 unemployment report wen the Nigerian Bureau of Statistics (NBS) release, Naija unemployment rate hit 33.3 percent and dis one na the highest wen dem don ever record.
Insecurity don increase for Naija-Ayokunle
Presido of the Christian Association of Nigeria, Supo Ayokunle don begin complain again about d rate at which insecurity take dey increase for the country, he say government no know wetin to do again. The presido of CAN, when yarn on Sunday come talk say the association convince Christians say make dem no gbege back undermining d rate at which d attacks on them take dey increase. Ayokunle come sha blast the Kwara State Governor, Abdulrahaman Abdulrazaq, concerning the use of Hijab, say him decision dey cause tension and lawlessness.
We go shut down local government areas for Naija-NULGE
Leadership of Nigeria Union of Local Government Employees, NULGE, don threaten to shut down the 774 local government areas for the country, becos of d plan wen dem say the National Assembly get to remove the local government as the third arm of government from the constitution. Presido of NULGE, Comrade Ambali Olatunji wen drop dis tatafo wen he dey raport wit news people for Abuja, come talk say the Union no go waste time to mobilise their members to fire down on mass protest against the move. He come advise the leadership of the National Assembly to organize one discussion forum within two weeks to prevent crisis.
Sell NNPC and refinery-Atiku
Before before vice presido Atiku Abubakar, don tell the federal government again to sell off the Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) and their refineries. Mr Abubakar repeat the statement on Sunday as part of wetin he dey recommend to take reduce Naija high unemployment figures. He make dis statement wen he dey react to one report wen show from Bloomberg Business on Saturday wen say Naija go soon get d highest unemployment rate for planet Earth, with more than 33 percent rate.
Tidi don order demolition of illegal structures for warri
Warri South Local Government Area chairmo Dr. Michael Tidi, don give warning say security agencies go back members of Warri South Council Taskforce on Beautification once dem begin dey destroy illegal structures and other attachee wen dey for along major roads and streets for the Oil City of Warri. Tidi, wen give the warning even as he dey soji the activities of the taskforce and the state environmental sanitation come order people wen dey occupy under the flyover wen wen dey connect Ugbuwangue and Ogunu plus those wen dey sell market for the roundabout wen dey close to Energy Link Road for Ugbuwangue for Warri say make dem vamuss within seven days or make den ready to watch d way wen d government go take scatter their structures. He come advise those wen dey operate illegally say make dem no listen to any community leader wen dey give dem assurance, say he dey more determined to remove illegal structures from Warri wit d collaboration of the relevant state government agencies.
Onoyake send environmental bill give legislative council
As part of the ways to make d environment better, Chairmo of Uvwie Local Government Area, Ramson Onoyake don send one executive bill give the Council legislative chamber and if dem give am pass mark, e go give legal backing to the administrations to tackle those wen dey carry dey throw way dirty anyhow for d local government. Wen Onoyake dey yarn dis past weekend for Effurun, he come talk say he no just like d way the people take dey handle the environment. He come still talk if dem pass d bill, e go address the way wen people take dey drive anyhow against traffic for the LGA plus including other matters.