Atiku Abubakar, before before vice-presido don talk say he no support the decision wen the federal government make to spend the sum of $1.5 billion to take revive the Port Harcourt refinery, Rivers state. You go remember say na na Wednesday nia the Federal Executive Council (FEC) take approve the osusu for the project. Wen Abubakar come dey react thru him twitter handle on Thursday, he come talk say dis move no legit, say e be like some mago mago wan play now. He come talk say d Shell Petroleum Development Company of Nigeria (SPDC) sell one refinery wen dey more valuable wen be the same size wit dis Port Harcourt own for 1.2 billion. He come talk say he just dey wonder if the FEC soji everything well before them approve d pepper.
PPP nai be the way-Osibanjo
Vice Presido, Professor Yemi Osinbajo (SAN), don talk say na d Public-Private Partnership (PPP) arrangement nia be the only way for Naija to fit overcome this their high infrastructure shortage. The Vice Presido yarn dis one on Thursday for the opening of one 2-day retreat of the National Council on Privatization (NCP). Even as oga vice dey use statistics from Nigerian Integrated Infrastructure Masterplan (NIIMP) and the Economic Recovery and Growth Plan (ERGP) 2017-2020 to take push him point, he come talk say Naija go need nothing less than $2.3 trillion for the next 30 years to tidy d matter.
Ammunitions dey enter naija like water-Buhari
President Muhammadu Buhari don talk say undermining land borders wen dem close of recent, he say arms and ammunition still dey continue to dey flow enter d country like water. According to one statement wen oga Buhari Special Adviser on top Media and Publicity, Femi Adesina drop, the President tender dis one for the Presidential Villa for Abuja. He come talk say na d situation for Libya nia cause dis problem, say once the country continue to remain unstable, na so illegal arms and ammunition go continue to flow for the Sahel region of Africa. Buhari come talk say Muammar Gadaffi tanda for power for Libya like say na him birthright for 42 years and say na so he recruit armed guards from different countries, when come las las escape with their weapons when them kpuff d Libyan okogan.
Delta state: Okpokonu community reject their King
The people of Okpokonu community for Burutu LGA of Delta state still dey hold ground say dem no want king Charles Ayemibotu as their traditional leader and dem say as dem take talk am na so e go be. As the people dey run one peaceful protest, dem come accuse the king say he dey collobi all d mende mendes wen suppose dey enter the community from oil companies for him personal use. When King Charles Ayemibotu come dey yarn, he come talk say na big ogbolo nia d people just dey blow on top him head say the protest na washy.
Delta State: 25 injure as bad guys trowe bullet for Oviri-Olomu
No be small tension nia play for Oviri-Olomu for Ughelli South Local Government Area of Delta State as men ratata for air becos of one leadership gbege for the community. According to reports, na more than 25 persons nia don sustain gunshot injuries since the casala start on Monday. Based on d report, the leadership tussle wen don already dey for one law court come worse even as the two parties dey claim leadership control for the oil-rich community after dem arrest some indigenes on Monday mor mor.
ICPC don arrest former JAMB Registrar
THE Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission ICPC don arrest one before before Registrar and Chief Executive Officer of the Joint Admission and Matriculation Board JAMB, Prof. Dibu Ojerinde, becos according to reports, he carry use N900m anyhow. The ICPC operatives arrest Ojerinde on Monday for Abuja becos of d allegations of multiple identities, abuse of office, money laundering, tax evasion and say he make false statements give public officials. The anti graft agency still dey question d JAMB oga for the wayo contracts wen he award give shell companies wen dem no fit trace.
Jealousy join make insecurity worse-Audi
Commandant General of d Nigeria Security and Civil Defence Corps NSCDC, Dr. Ahmed Audi don talk say na d gbege wen dey play within d agency and jealousy nia dey make dis insecurity dey worse for the country Audi wen yarn yesterday for Abuja for the opening of one two-day training workshop on adopting best practices in Law Enforcement, Human Rights, Inter-Agency Collaboration, Leadership and Conflict Management for State Commandants of the Corps, come dey call for more unity among security agencies. He come talk say need dey for everybody to collabo work together so dat we go fit address dis issue of insecurity for d country.
Make Buhari face firing squad if e no keep im promise-Okupe
Before before Senior Special Assistant on top Publicity to before before Presido Goodluck Jonathan, Dr. Doyin Okupe, don tell Nigerians to make am face firing squad if he no keep him presidential promises. He say he get one master plan for the security situation for the country and say if the situation remain the same, he go run for presidency for 2023. Dr Okupe, when still serve under before before Presido Olusegun Obasanjo as Special Assistant on top Media and Public Affairs, come talk say d President Muhammadu Buhari-led government neva try for d area of dealing with d insecurity wen dey play for d country.
Astrazeneca dey very safe-Prof Mojisola
The National Agency for Food and Drug Administration and Control NAFDAC oga wen dem dey call Prof. Mojisola Adeyeye don talk say Covid 19 vaccine Astrazeneca dey very safe. Adeyeye yarn dis one becos some countries for Europe and South America don stop the usage of the vaccine. Wen e dey voice during one interview on Wednesday, he come talk say the drug go thru enof torchlighting and testing before dem give am pass mark. He come still talk say NAFDAC dey committed to protect Nigerians and say dem no go do anything wen go make d people come either kpeme or begin behave like gbeskelemuske
FG approve $1.5b to touch port harcourt refinery
The Federal Executive Council (FEC) don approve the sum of $1.5 billion for the rearrangement of Port Harcourt Refinery for Rivers state. Them announce d approval on Wednesday for the 38th virtual FEC meeting wen President Muhammadu Buhari take charge of for Abuja. Timipre Sylva wen be d minister of state for petroleum come talk say dem go do the workings for three phases of 18, 24 and 44 months. He come say dem award the contract give one Italian company, Technimount SPA, when be lords for anything refinery maintenance.