One kidnaper wey police karey go hospital nai dokitors confam say don kpuf cus of gun wey touch am for shooting battle. Wetin Delta State Police Command tokpesin, SP Bright Edafe, tok be say wey dem get di info,nai CP Special Assignment Team enta Ohoror community for Ughelli-Patani Road, but as di kidnaper see dem nai dem start to shoot naso di gun fight take start. As dem...
Skool principal don karey 13 years girl go meet police to deal with di 32 years step fada wey give her belle come even wan remove am after he don dey sleep with her even bifor her period start As di mata reach police hand nai dem go arrest di step fada cus di principal say she dey see changes for di girl bodi, bifor she come open...
Ugborikoko skool don para follow di Senior Prefect of 2000 set, Mr Peterson Ebialade Okpomu, wey be dem president as he gi chop N914,000 charity moni wey dem bin wan use take do work for di skool dis December. Di investigation wey di Disciplinary Committee do show say Okpomu karey di association check, come go lie to di Treasurer, Ms. Oke Dick Kandy, say make she sign blank...
Police don go arrest Habeeb Hamzat, aka Peller make he go rest for station as na to kill hinsef dey hungry am for di live stream wey he dom on Sunday. Na on Tuesday nai di Lagos PPRO, SP Ambibola Adebisi say afta dem arrest Peller, police detain am cus wetin he do na very foolish tin wey fit even cus accident for oda pipo wey dey di...
Benin police don arrest di Chabi Yayi di son of di foma president, Thomas Boni Yayi, one week afta coup wey fail. Early morning on Sunday nai hand touch Chabi Yayi for he haux but why authorities go catch am, no bodi know. One member for Democratic Party, wey be di main opposition part wey Yayi dey lead, nai confam say hand really touch Yayi but even dem...
Nigeria don go epp Benin Republic fight with jet for air and soldiers for ground afta di coup wey bin wan hapun on Sunday as some sojas for Benin don already take over di state television come say na dem don take power from President Patrice Talon. As di sojas dey annonce for live TV oda loyal sojas block dem down and now hand don touch like 12...
About Us
Make E beta for you
Contact Us
Advertise with Us
© 2026 KpokoFM