One new report wen SBM Intelligence, Naija geopolitical intelligence platform drop, show say 35.9 per cent of Nigerians no dey ready to take the COVID-19 vaccine, while 24.1 per cent neva make up their mind yet, whether dem go take the vaccine or not. According to the report, them carry out d survey for across d 36 states of the country and Abuja. The survey come say na 39.9 per cent of d people nia don agree say dem go take the vaccine.
We no go disagree with presido to please anybody-Lawan
Senate Presido Ahmad Lawan don talk say the national assembly under him leadership no go disagree with President Mohammadu Buhari to please anybody. When Lawan dey yarn wen he receive Abdullahi Liman Tukur, vice-chancellor of Modibbo Adama University, and Aishatu Dahiru Ahmed, d senator wen deh represent Adamawa for Abuja on Tuesday, he come talk say the federal lawmakers go disagree with Buhari if reason dey to do so. The number three citizen come talk say the ninth assembly don achieve plenty things because dem dey united.
Northern governors no pay bandits-IGP
The inspector general of police IGP Mohammed Adamu don talk say d news wen dey play say northern governors dey pay bandits make dem for no attack their states no be true. Adamu wen yarn during one interview on Wednesday for Abuja, come talk say the governors only provide little support for bandits wen don repent. He come still talk say dem dey take steps to reform and strengthen the police so dat dem go fit serve Nigerians better.
FEC approve bill wen go extend teachers retirement age
The Federal Executive Council (FEC) don approve one bill wen dey extend the retirement age for teachers for the country from 60 years to 65 years. For the FEC their first meeting of the year 2021, presided wen President Muhammadu Buhari take charge of on Wednesday, approve the bill and dem go send am go give the National Assembly for torchlighting and possible approval. The bill dey still dey seek to give legal backing to new measures by the current administration to improve the teaching profession for the country. Den if d lawmakers give am pass mark nia be say d retirement age of teachers go come move from 60 years to 65 while the years of service go still move from 35 to 40.
Delta state: Two piple denkwes for tipper and keke accident
The Delta State Police Command don come out come talk about d matter wen play on Wednesday for along PTI Express Way for Effurun for Uvwie LGA of Delta State where one serious motor/keke accident for take happen. The accident involve one Mercedes Tipper with Reg. No. WWR 425 ZR wen dem load with granite, one Toyota Camry car with Reg. No. AKD 403 FM and one keke. Two passengers wen dey for d keke, one woman and one baby girl denkwes on the spot meanwhile other passengers wunjor. The Delta State Police Command come say dem dey sympathize with the families of those wen kpeff plus those wen injure. Wen DSP Onome Onovwakpoyeya, Police Public Relations Officer, Delta State Command, Asaba dey yarn on top d matter, she come talk say dem dey wish to let the general public know say Operation Delta Hawk and Ebrumede patrol vehicle no get anything to do wit d matter. She say d only thing wen d Police officers do na to go rescue the victims before members of the public come go burn the Police patrol motor wen come for the rescue operation. Las las, she come talk say dem go deal wit all d people wen involve for d burning.
Americans dey rush buy guns before Biden Inauguration
Reports wen dey reach us na say Americans don begin dey rush dey buy guns ahead of the inauguration of Joe Biden as president. Forbes report say gun shops dey sell out Glocks and other brands as Americans dey reason say d incoming president go put control measures on guns. Biden dey expected to introduce tighter regulations, unlike outgoing President Donald Trump when no really care about such moves. The Nigerian Stock Exchange NSE say the Federal Government of Nigeria raise more than N2.36tn from the capital market for 2020. Na the Chief Executive Officer of the NSE, Mr. Oscar Onyema nia yarn dis one for the 2020 market recap/2021 outlook on Tuesday. He come talk say the Federal Government issuances amount to 92 per cent of total bond issuances for the market.
Stop to ask for Covid-19 results from students- FG
The Federal Government don tell schools to stop to dey ask for COVID – 19 test results from students wen dey return back to d skool before them go resume. The government for one short statement wen dem drop on Monday thru the Director, Press and Public Relations, Federal Ministry of Education, Ben Goong come warn school authorities say make dem stop to dey ask students or parents to undergo COVID-19 test before dem go resume schools. According to Goong, na only students their temperature dem suppose dey check and any other person wen dey cross any school gate.
NGF to meet to discuss covid-19 mata
Governors of the 36 States of the Federation go hold their 23rd teleconferencing meeting to address the rising cases of COVID-19 infections and work on a better way out. This informate dey for one press statement wen the Head, Media and Public Affairs of the Nigeria Governors Forum NGF, Abdulrazaque Bello-Barkindo sign for Abuja, on Monday. Meanwhile, the meeting when dem schedule to hold online by on Wednesday dey expected to provide platform for the governors to reason and den agree on practical steps to take stop further spread of the disease.
We no get enough freezers-NIMR
The Nigerian Institute of Medical Research (NIMR) don talk say Naija no get enough freezers to take store thousands of doses of Pfizer/BioNTech vaccine once dem land d country. Nigeria go receive 100,000 doses of the Pfizer/BioNTech vaccine die month and e dem go need to store dem for minus 70 degrees Celsius. Wen Babatunde Salako, NIMR director-general come dey yarn for one interview, he come talk say while we get freezers for the country wen dem go fit use take store d vaccines, he say presently, dem dey occupied with other medical supplies wen need low-temperature storage.
NIN dey compulsory for Diplomats-FG
The federal government say the national identity number (NIN) dey compulsory for diplomats wen go long side for the country for more than two years. For inside one statement on Sunday, Femi Adeluyi, technical assistant to Isa Pantami, d minister of communications and digital economy, talk say dem go arrange enrollment centre for the ministry of foreign affairs. The technical assistant come talk say e compulsory for for lawful residents for Naija to get NIN.