The Senate don tell the Federal Government to provide enof kush wen dem go use take get and dey give COVID-19 vaccines to Naija piple. The Senate on Thursday say the government don fail as dem no fit produce any plan to take get, distribute and give the vaccine. The senate wen run wit d motion wen Senator Oloriegbe Ibrahim sponsor come still direct their Committee on Health and Primary Health Care to Invite the Federal Ministry of Health, Federal Ministry of Finance, the Presidential Task Force on Covid-19, and other relevant agencies to present details of plan approval, Protocol, Funding, Procurement, Administration and Monitoring of Covid-19 vaccine for Naija.
Army beg Naija piple for the farmers wen boko kill
The Defence Headquarters don beg Nigerians say make dem no dey discouraged becos of d way wen these boko boys take kpuff some rice farmers of recent for Borno State. Coordinator Defence Media Operations, Major General John Enenche, wen beg d beg during the weekly media briefing with Defence Correspondents, come talk say undermining the recent killing of the farmers, the Armed Forces of Nigeria and other security agencies still dey fire down wit their major operations for across the country with all seriousness” He come talk say very soon, the Boko Haram sect and all their wahala go end, say dis one wen dem dey do as dem take dey attack innocent and harmless people na way to take put fear for the mind of d people so dat their moral go dey high.
Buhari say he stand gidigba to create more jobs
President Muhammadu Buhari don talk say he dey committed to create more jobs, he put focus for how to make the private sector strong and den target more on d youths and im eye dey for agriculture, arts, entertainment well well. Buhari yarn dis one for one Presidential Conference wen he get with the Pprople wen show for the Senior Executive Course 42 of the National Institute for Policy and Strategic Studies for the State House, Abuja, on Thursday. He come still talk say him administration don make better progress for to balance the economy and say dem don reduce d rate at which d government take dey depend too much on the oil sector for pepper and foreign exchange money.
Okowa: Clean environment dey helpful to stop yellow fever
Governor Ifeanyi Okowa don talk say vaccination and clean environment na factors wen dey helpful to take stop yellow fever outbreak. Okowa yarn dis one on Thursday wen dem dey open d preventive yellow fever mass vaccination campaign for Asaba. He say the reason of the vaccination na so dat d people go get odeshi against yellow fever and dis one so go help to reduce the risk of transmitting the disease for communities. He come talk say d community and d environment wen d people no dey take care of well na something wen go fit bring about dis yellow fever disease.
UK don form new immigration system
The UK government don introduce one points-based immigration system to take attract the ” brightest and the best from around the world”. According to one statement wen the Home Office and Priti Patel, secretary of state for the Home Department release, dem say the new immigration system go open on January 1, 2021.
UK government don approve Pfizer/BioNTech COVID-19 vaccine
The UK don approve the Pfizer/BioNTech COVID-19 vaccine for public use. This one na the first country to give d go ahead for everybody to use the vaccine. You go remember say na for d month of November nia Pfizer take announce say dem don develop one vaccine wen go fit give 95 percent protection against COVID-19.
House of Reps: Look the salary of health workers again
The House of Representatives don dey complain about the way wen workers for the health sector take dey vamuss comot from d country dem come say make the Federal Government do things wen go make d health workers stop to dey go other countries. On Tuesday, the green chamber come tell the Ministry of Labour, Employment, and Productivity say make dem “review the salary, allowances, and welfare of Nigerian health workers. The House come still tell the Ministry say make dem reason d expansion of the size of the medical practitioners for the country.
Boko haram don claim responsibility for the Borno state killing
Abubakar Shekau, leader of the Boko Haram sect don talk say na deir group nia dey responsible for the farmers wen dem kpuff for Borno state. The farmers denkwes after Boko Haram badoo attack them for Zabarmari community for Jere local government area of the state. Babagana Zulum, governor of the state, say na 43 people nia d winchi winch idem kpuff wen dem dey work for their farmlands but for one video wen show on Tuesday, Shekau say na at least 78 farmers nia dem legoo.
LMC: League no go start this sunday
Talk talk person for League Management Company, Harry Iwuala, don talk say the 2020/2021 Nigerian Professional Football League season no go start off this Sunday. The LMC been propose December 6 as d date wen dem go take resume d league and na so dem still release fixtures for the season to the clubs for one meeting but d toner no be officially according to Iwuala. He come talk say dem go drop one official statement wen dem go let everybody know through the right channel soon.”
FG don release mass transit bus
President Muhammadu Buhari on Tuesday don talk say make dem release of mass transit buses so that the challenges wen Nigerians dey face on top transportation matters go reduce. According to one statement wen him Special Adviser on Media and Publicity, Femi Adesina drop, the President yarn dis one wen he dey open d National Gas Expansion Programme and National Auto-gas Roll-out Initiative for the Presidential Villa, Abuja. The president come still thank Nigerians for their patience even as the nation dey continue to dey experience economic and other challenges. He come still thank members of the organised labour for their “maturity and patriotism.”