Democratic Republic of Congo health ministry say 24 Ebola patients don shalay comot from one Ebola treatment center where dem for take dey receive treatment for Beni yesterday. The patients gats borrow leg after people wen dey protest the cancellation of on Sunday presidential election for the eastern city attack d place. D ministry spokeswoman […]
Serie A inside Pepper Soup
E clear say dem go fit suspend Serie A after one Inter Milan supporter denkwes after he rack with Napoli fans and na so dem stab four people for on top dis same matter. According to reports for Italy, dem rush the 35-year-old Inter fan go hospital after one motor wen Napoli fans dey drive […]
Military Palava
The Nigerian Army don admit say many police officers gbes without official permission from one counter-insurgency training facility for Yobe State. This one no be d same tin wit wetin d police first talk as dem take deny say no officers run wit weapons as dem take report am on Wednesday afternoon. The army say […]
Gov Okowa Don Sign 2019 Bill
Delta State Governor, Dr. Ifeanyi Okowa don sign the 2019 Appropriation Bill of 390.3 billion naira enter law. The governor wen sign the bill yesterday for Asaba come talk say early signing of the bill into law go give him administration enof time to use the dry season take tidy construction works. Meanwhile, the 2019 […]
2019: Money Palava
Zainab Ahmed, d minister on top finance, don talk say owners of expensive boats and private jets go begin dey pay for luxury items that is big items as from 2019. Wen d minister dey yarn for Abuja, he come talk say dem go introduce charges for some areas while dem go come reduce taxes […]
PDP Blast Presido
Buba Galadima, one spokesman for the Peoples Democratic Party (PDP) presidential campaign organisation don talk say Muhammadu Buhari no go be Naija presido come May 29. Na wen Galadima dey voice for one Television programme yesterday nia he for take talk dis one. The PDP campaign spokesman come talk say since Buhari don leave the […]
Police Tear Race
Nothing less than 167 police officers nia gbes comot from one training ground after dem hear say dem dey receive training so dat dem go go gbege Boko Haram badoo dem. The officers wen borrow leg so wen d force don declare wanted dey amongst the 2,000 additional police officers wen d Inspector-General of police […]
BMO vs PDP
The Buhari Media Organisation (BMO) don tell the People’s Democratic Party (PDP) and their Presidential campaign spokesperson, Buba Galadima say make dem get clear understanding of the laws wen dey guide campaign funding before dem make public statement on top d contribution wen people make to the campaign of President Muhammadu Buhari. The Organization blast […]
New Manager New Results
Ole Gunnar Solsk-jaer sharp sharp impact as Manchester United manago for now continue for him first home game unto say dem mama Huddersfield 3-1. After dem win 5-1 victory for Cardiff, for him first game after he take over from Jose Mourinho dis past weekend, Solsk-jaer team don make six points for within a space […]
Super Falcon’s Opponent
African champions, the Super Falcons, go face Belgium, Austria and Slovakia for Group C of the 2019 edition of the Cyprus Cup – one invitational tournament. The Super Falcons go use the Cyprus Cup invitational tournament take fine-tune their strategies ahead of the 2019 Women’s World Cup for France. Super Falcons opponents for the Cyprus […]