President Muhammadu Buhari don tell agencies wen dey involved for agriculture make dem include the youths even as dem dey use modern methods of farming, he come tell all those wen dey interested say dem go get better environment so dat everything go go well. Wen oga Buhari dey yarn on Tuesday for Abuja during the launching of d National Young Farmers Scheme wen the National Agricultural Land Development Authority (NALDA) arrange to take increase youths their interest for farming, he come talk say na agriculture nia still remain the backbone of the Nigerian economy, unto say na him be the largest contributor to Naija Gross Domestic Product (GDP). He come talk say the NALDA wen dem don wake up again go make Naija food boku and say in some few years time we go begin dey make more money from agricultural products wen we go dey export.
Cluster Management Committee don shut down Heritage Energy
THE Cluster Management Committee/President Generals Forum of Oil Mining Lease (OML) 30 for Delta State don shut down operations of Heritage Energy Operational Services Ltd (HEOSL), operators of OML 30. The committee yarn dis one for one letter yesterday wen their Chairmo and Seceto Harrison Obogor and Ibuje Joseph drop after their meeting for Warri. The committee wen represent the 112 host communities to OML 30 for Ughelli North Local Government Area say the shutdown happen after different offences. The statement say the oil company no gree pay their host communities the 2019 and 2020 GMoU funds undermining say dem dey operate for better and peaceful environment. Dem come still accuse the company say dem stop the payment of scholarships to students from the host communities since 2016.
DESIEC reveals budget for 2021 LGA elections
The Delta State Independent Electoral Commission, DESIEC don propose the sum of one billion, One Hundred and Forty Seven million naira for the conduct of the forthcoming local government councils election for the state. Chairmo of the Commission, Chief Mike Ogbodu wen drop dis aproko wen he dey defend the 2021 budget proposal give the State House of Assembly Committee on Establishment, Ethics and Privileges, wen the Minority Leader, Hon Innocent Anidi lead come talk say the election go hold early next year. The DESIEC oga Chief Mike Ogbodu come talk say dem propose nine hundred million naira for the conduct of the elections, while two hundred and forty-seven million naira na for related activities, including legal matters, post election seminars, trainings plus including other matters.
WAEC don reschedule WASSCE to November 30th
The West African Examinations Council (WAEC), Nigeria, don reschedule the second series of the 2020 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) for private candidates go November 30. The examination suppose start on November 14, 2020. For inside one statement wen show on Monday evening, talk talk person of the council, Demianus Ojijeogu come talk say the exams wen suppose begin on Saturday, November 14, 2020 no go hold again on that date becos of matters wen come up.
ASUU don tell FG- Leave IPPIS
The Academic Staff Union of Universities (ASUU) don tell the Federal Government to leave the Integrated Payroll Personnel Information System (IPPIS) as a condition to take call off their ongoing strike for the country. Na ASUU Presido Biodun Ogunyemi nia yarn dis one for one statement on Sunday for Abuja. He say the ongoing strike go fit continue if the government no gree meet their demand. He come talk say the government dey punish university teachers because them reject d IPPIS wen dem force on the universities against the provisions of the law on autonomy and universal practices.
FG: We go deal with dem
The Presidency come talk say dem go deal with those people wen allow the recent #EndSARS protests lead to the destruction of lives and properties for the country. Na Garba Shehu, Senior Special Assistant on Media and Publicity to the President nia yarn dis one on Sunday during one television interview. He come talk say make some politicians when promote the #EndSARS demonstrations plus those wen dey for the People’s Democratic Party talk publicly say dem no get hand for the destruction. Wen Human rights lawyer Barr. Robinson Ariyo come dey react to wetin the presidency yarn, he come talk say na the duty of security agencies to make sure say any protest remain peaceful just as na the right of the people to protest against any coma wen dey for the contract wen dem get with the government. Den concerning the issue of the freezing of the bank accounts of EndSARs protest promoters by the central bank of Nigeria and the restriction of travel wen d Nigeria Immigration place on some EndSARS protesters, he come talk say the government agencies take the action without fair hearing.
Naija youths don frustrate-Buhari
President Muhammadu Buhari don talk say the demonstration against police brutality dey show say the youths for the country dey frustrated. You go remember say for the month of October, many Nigerians burst enter the streets dey call for reformation of the police. Wen Buhari wen Ibrahim Gambari, him chief of staff represent come dey yarn for one event wen south-west governors host for Lagos on Sunday, he come promise say dem go address the root causes of the demonstration.
1.3bn no reach for Villa clinic
The Permanent Seceto for the State House, Tijani Umar don talk say the N1.3bn wen dem approve for Villa clinic too shengele. Tijani yarn dis one for one interview wen he get with news people on Thursday after he don defend d 2021 budget estimate before the Senate Committee on Federal Character and Intergovernmental Affairs State. The Senate clear officials of the State House say make dem discourage the President Muhammadu Buhari make he no dey travel go abroad for medical treatment so dat the State House clinic go fit dey function well.
We no get plan to increase VAT-Zainab Ahmed
The federal government don talk say dem no get any plan to increase Value Added Tax (VAT) again and dis one so na according to the Minister of Finance, Zainab Ahmed. She make dis statement wen she mark present before the Senate committee on finance on Thursday. Meanwhile, them come still query the minister say why she no provide enof osusu for key agencies and parastatals under her ministry including the Office of the Accountant General of the Federation.
We no get way to monitor revenue-Ahmed Idris
The Office of the Accountant General of the Federation don talk say dem no get any means of monitoring the revenues wen dey enter the country through the Treasury Single Account (TSA). For one meeting wen the Accountant General of the Federation, Ahmed Idris get with the Senate Committee on Finance on Thursday, he come talk say undermining say dem don advance for technology, him office no get any way of knowing wetin dey enter the account for real-time. Meanwhile, the TSA na centralised bank account wen d government agencies dey use take dey receive revenues.