Rotimi Amechi wen be d Minister of Transport don talk say any restructuring for Naija must take into account those states wen dey weak financially. Wen Amaechi dey yarn for one interview dis past weekend for Port Harcourt, he come talk say currently some state no dey fit even pay salaries becos of their low monthly allocation. He come talk say addressing that challenge dey very important for the restructuring process.
E nor make sense to accomodate parts of Sharia law
The Christian Association of Nigeria (CAN) don talk say the call wen Ibrahim Muhammad, chief justice of Nigeria(CJN) make for d amendment of the constitution to accommodate certain ‘parts of Shari’a’ dey reckless and say e no make sense. Wen d CJN dey yarn for the 20th annual judges conference for Kano last Wednesday, he come still talk say the language of instruction for Shari’a law for universities suppose be Arabic and not English. But wen Samuel Kwamkur, national director of legal and public affairs for CAN come dey yarn for one statement, he come talk say wetin Muhammad talk no just make sense at all as a public officer, as person wen be expert for law matters and even as the head of Naija judiciary”.
EFCC don make dem convict some wayorists
The Economic and Financial Crimes Commission EFCC don secure the convictions of nine internet wayo wayo people and one Banker before Justice Emeka Nwite wen dey for the Federal high Court for Warri, Delta State. Them carry dem separately go d court for offences wen include impersonation, plan to defraud and failure to disclose suspicious transactions. Those wen dey convicted according to reports include Onomua Victor Ovie, Evans Ikpasa Efe, Abuwa Mavis, Godbless Omamuyovwi, Peter Atolo plus including others.
Davido FC versus WizKid FC match don the sour
Nigerian singer wey dem dey call Davido dey binu for him fans plus Wizkid fans. The binu come base on say one of Wizkid fan talk say he use he mama for ritual. He talk dis one for him twitter account. Davido fc wizkid fc has it gotten to this ! Bull shit disappointed in both my fans and his ! Nonsense https://t.co/JD25r6aPGC — Davido (@davido) December 15, 2019
Court don give order for the arrest of Diezani
One high court for Adamawa don give order for the arrest of Diezani Alison-Madueke, before before minister of petroleum resources, for d way wen she take give bribe of N362 million to Independent National Electoral Commission (INEC) officials make dem for change d result of the 2015 presidential election. Na Nathan Musa wen be the judge nia give this order yesterday wen he dey deliver judgement against Ibrahim Umar and Sahabo Hamman, d two staff of INEC wen collect the bribe from Alison-Madueke. The judge come direct Mohammed Adamu wen be d inspector-general of police (IGP), say make he collabo with the International Police Organisation (INTERPOL) to make sure say dem arrest d before before petroleum minister.
Aisha buhari nor suppose bring family matter out
Kinsmen of the President, Major General Muhammadu Buhari don blast oga presido wife, Aisha becos of wetin she talk on Wednesday as she take accuse Garba Shehu, presidential spokesman say he dey take instructions from Mamman Daura, the president nephew den he come dey belittle her office. Wen the kinsmen dey yarn for Daura for separate exclusive interviews wen dem get with news people, dem come talk say Mrs. Buhari no try for d way wen she take make wetin be purely private family affair, public. Wen people wen dey long side for Daura, the villa of the President come dey yarn on top d matter, dem come talk say the first suppose report the matter give her husband man.
DSS need to remove hand comot from Sowore matter
The Attorney-General of the Federation and Minister of Justice, Abubakar Malami, SAN, don order the Department of State Service, DSS, to remove their hand comot from d prosecution of d leader of #RevolutionNow Protest, Omoyele Sowore wen dem hold since. Wen the AGF dey yarn for one statement wen he drop give news people thru him media aide, Dr. Umar Gwandu today, he come talk say he don direct the security agency to forward the case file of Sowore wen dey before the Federal High Court for Abuja, go him office. Malami come still tell the Federal Ministry of Justice to immediately take over the prosecution of all d charges wen dey against Sowore, in line with the provisions of Sections 150(1) and 174 (1) (a-c) of the 1999 Constitution wen dem don amend.
Okamuka, Emu Akpo inside life inside dis life
One twitter user don put tori for twitter say one girl dump him friend wey dem dey date for five years. Him. The girl so dump the guy wan con go marry another guy wey just from abroad. Dem fix the marriage for December 29th. The guy so wey dem break him heart don take leave from office because the okamuka too much. Read the story: My Guy is fucked up! His babe for 5years is getting married to one foolish IJGB come December 29th and she just told him Yesterday and Man was crying telling me on the Phone! He taking up his leave and travelling out for 1month because he can’t stand it! I did the Link up ????????♂️ — Buchi Laba (@Buchi_Laba) December 13, 2019
Poco dey prove say better pikin fit house wella
One dancer, Iweh Pascal wey dem dey call Poco Lee don share picture of the change of levels wey happen to him mama. Na once Poco Lee burst outside base on say he dance video wey he post for social media enter everybody eye including celeb them. https://www.instagram.com/p/B6AbvDOFQ-3/?utm_source=ig_embed He share one picture of he instagram page, the picture show he before and after picture of he mama. Before Poco Lee mama dey sell bole and potato but now base on the pics na beverage shop naim she get now.
FG need to pay unemployed people for obodo naija
The Senate don tell the federal government to initiate sustainable unemployment fund for d payment of living salary to unemployed Nigerians until those persons get employment. Currently, the millions of Nigerians wen dey unemployed no dey get any kind of benefits from the government. Mr. Ekweremadu wen lead d debate come talk say any country wen get dis number of unemployed, but employable youth population dey only dey sit down on top bullet. Yesterday, the Senate come still say make the federal, state, and local governments declare state of emergency on the provision of employment for Nigerian youth.