BBNaija 2019 winner wey dem dey call Mercy Eke don come out come talk say celebrity life don tire am, She say she wan go back to her old life. She say now she nor fit sleep and wake as she want because of many activities wey dey her calendar, this one dey make her nor dey free. She say for social media people nor dey see am o, for people mind everything dey fine. She yarn dis one for Instagram for one live chat with her fans. Watch the video to hear wetin she talk https://www.instagram.com/p/B5XIYZMHm1M/?utm_source=ig_embed&utm_campaign=embed_video_watch_again
EFCC don arrest prison controller wey dey corrupt
The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don arrest Emmanuel Oluwaniyi, controller of Kirikiri Maximum Prison, for d way wen he take allow Hope Aroke wen dey serve 22 year jail term becos he dey guilty of internet wayo wayo matters receive treatment for outside the prison. According to the commission, Aroke, wen dem dey call “H.Money”, don lead one mega scam of more than $1 million from prison wit d help of some other people. The EFCC come talk say investigation wen dem carry put show say Aroke dey get access to the internet and mobile phone even for inside prison.
High court for Abuja fix date for Olisa Metuh case
One federal high court for Abuja don fix February 25, 2020, for judgement concerning the case of Olisa Metuh, one before before spokesman of the Peoples Democratic Party (PDP). Okon Abang wen be the judge fix the date yesterday after lawyers for the matter adopt their final written addresses. The matter na say for d month of January, 2016, the Economic and Financial Crimes Commission(EFCC) carry Metuh and Destra Investment Ltd wen be him company go court on top seven-count charge of money laundering wen involve N400m. Sponsor of the hate speech bill for the national assembly Senator Sabi Abdulahi don tell Nigerians say make dem no worry say the bill go go thorough process. Wen senator Sabi dey yarn during one television interview yesterday, he come talk say dem must make efforts to end d gbege wen hate speech dey cause
Presido don send budget for NDDC to senate
President Muhammadu Buhari don finally send the 2019/2020 budget for the Niger Delta Development Commission (NDDC) go the national assembly for passage. Oga presido present the 2019 and 2020 appropriations bills of the agency give both the senate and house of representatives for separate letters wen dem read during their yesterday meeting. Oga Buhari letter no give the estimates of the budget when come about four months after the 2018 fiscal year don end. Meanwhile, he say d delay na becos of the crisis concerning the inauguration of one new governing board of the agency.
Kasala go soon burst between state and federal govt
E clear say State governors and the Federal Government go get clash becos of the way wen d federal government take dey delay to refund d money wen state governments spend on top federal roads. Wen some governors dey yarn for separate interviews, dem come talk say d delay wen d federal government dey delay to refund the money dey worry mind. Meanwhile, d Minister on top Works and Housing, Hakeem Bello don talk say the delay na becos of the verification wen the federal agencies dey do.
Price of rice don increase including local ones
With less than four weeks before Christmas, the Price of rice don rise by more than 29 per cent since June. The price of the item wen before now na N17,000 per 50-kilogramme don rise reach between N22, 000 and N30, 000. Meanwhile, the price of local rice wen suppose replace foreign ones since dem close border don still increase too.
We go sack officers wen dey do kurukere matters
The Nigeria Customs Service (NCS) don promise say dem go sack officers when no go fit live wit d salary wen dem dey receive wen dey put hand for kurukere matters. Na the comptroller-General of d NCS Hameed Ali, wen be retired colonel nia give the warning wen he dey decorate some officers of the service wen dem newly promote for Abuja. He come give warning say make no officer wen dey for the service live above his or her salary if them desire to remain for service. Ibrahim Magu wen be d acting chairmo of the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don talk say Naija and South Africa dey make plans to reach agreement on assets recovery and repatriation. Na wen Magu dey yarn for the closing ceremony of the two-week capacity-building and mentorship programme for 10 officials of the Liberian Anti-Corruption Commission (LACC) wen shele for the EFCC Academy for Abuja nia he for take download dis informate. Under the agreement, d South African government go return assets wen men gbanskele comot from d country go that way and na so we go return their own wen dey here too.
Make national assembly hold hearing for hate speech
The Nigeria Governors’ Forum (NGF) don advise the National Assembly to hold public hearing concerning the hate speech bill wen dey before dem to make sure say d views of Nigerians dey captured for the passage of the bill. Na d NGF Vice Chairmo and Governor of Sokoto State, Aminu Tambuwal nia give the advice wen he dey answer questions from news people after the forum meeting wen hold on Wednesday night for Abuja. He come advise the federal lawmakers to respect the views of Nigerians as regards the bill
PDP nor get issues with former Presido Jonathan
The Peoples Democratic Party (PDP) don talk say dem no get any issues with before before Presido Goodluck Jonathan becos the party lose for the Bayelsa governorship election. Na Kola Ologbondiyan wen be PDP national publicity seceto nia yarn this one during one interview wen he get with news people after one meeting wen the party national working committee (NWC) hold on Wednesday for Abuja. Reports don dey play say oga Jona go fit face disciplinary action becos he support David Lyon wen be d candidate of the APC for the election. But Ologbodiyan come talk say dem no even talk about Jonathan for the meeting.
Na revenge make dem burn the woman leader of pdp
The Kogi police command say Salome Abuh, woman leader of the Peoples Democratic Party (PDP) for Wada Aro, Ochadamu Ward wen dey for Ofu local government area of the state wen suspected jaguda burn na based on revenge. Wen William Aya, their public relations officer dey yarn, he come talk say quanta been dey between one Awolu Zekeri wen be member of the All Progressives Congress (APC) and one Gowon Simeon wen be member of the PDP and d two both of dem na from Ochadamu ward. He come talk say some youths wen no get joy come mobilise themselves dey go Simeon home for revenge and na so dem come take kpuff lee Abuh.