President Muhammadu Buhari don sign one executive order to end the rate at which people take dey kaka anyhow for public by 2025. Na yesterday nia oga presido take sign the order wen dem title “The Open Defecation-Free Nigeria by 2025 and Other Related Matters Order”. Wen Femi Adesina, special adviser to the president on media and publicity come dey yarn for one statement, he come talk say the executive order dey take effect immediately.
We nor go partner with Dr Jeremiah Abalaka at all
The Federal Government don talk say dem no go partner wit popular surgeon, Dr. Jeremiah Abalaka, as regards finding cure to HIV because 29 out of 30 of him patients leggo becos of complications during treatment. Na the Director-General of the National Agency for the Control of AIDS, Dr. Gambo Aliyu nia yarn dis one for one event wen dem hold to take mark World AIDS Day with the theme, ‘Communities make the difference.’ For the past 20 years, Abalaka don dey talk say he get cure to HIV but say the western world no dey reason am because the developed countries dey make better osusu from d anti-retroviral drugs wen dem dey sell.
We go kpuff corruption before e kpuff naija
The acting chairmo of the Economic and Financial crimes commission EFCC Ibrahim Magu don talk say the commission go kpuff corruption before e kpuff us. Magu yarn dis one during one recent gathering for Abuja. He come still talk say dem go do everything within the rule of the law
Naija death penalty wahala and social media bill palaver
The Nigeria Governors’ Forum don bounce the proposed death penalty for hate speech bill wen dey for the National Assembly. Na yesterday nia the governors take yarn dis one for the end of their seventh meeting for Abuja wen d Vice-Chiarmo of the NGF and Governor of Sokoto State, Aminu Tambuwal take charge of. Them come still talk say dem dey ready to conclude negotiations with labour unions concerning the implementation of the N30,000 minimum wage before the December 31 deadline. Meanwhile Shehu Sani one before before lawmaker from Kaduna central don talk na go nia our democracy dey so. Sani download dis informate during one recent television program wen he dey yarn concerning the proposed social media bill. He come talk say Nigerians need to stand up against any law wen go silence their opinion Whereas Femi Falana, human rights lawyer don talk say he go drag the federal government go court if them try am pass the bill enter law
Journalists go gain for dis social media regulation
The Minister on top Information and Culture, Alhaji Lai Mohammed don talk say the National Union of Journalists (NUJ), Guild of Editors and their members get more to gain with the Federal Government plan to regulate the social media space. The minister give the assurance yesterday for Abuja when the executive members of the union wen their Presido Chris Isiguzo lead go visit go visit am. He come talk say dis administration no go stop free speech for the country.
Money wey naija use import fuel reach N836.67 billion
Naija spend N836.67 billion take import petrol and other petroleum products for the second quarter of 2019. This one na according to d data wen show from the National Bureau of Statistics, NBS. Data from the NBS show say the amount wen Naija spend take import petrol and other petroleum products rise by 193.98 per cent from d N284.599 billion wen dem spend for the first quarter of 2019. Meanwhile The current open market price for petrol na N163.68 per litre and dis one na according to the Petroleum Products Pricing Regulatory Agency PPPRA. PPPRA talk dis one for their website as at November 15, 2019 and dis one so no rhyme wit the regulated pump price of N145/litre wen dem dey hail d product for filling stations. This one so mean say the Nigerian National Petroleum Corporation NNPC wen currently na d only importer of petrol to Naija go dey pay N18.68/litre as subsidy for d product.
Time don pass wey politicians dey use election play
Adams Oshiomhole wen be d national chairmo of the All Progressives Congress (APC) don talk say d time don pass wen politicians dey use electorates take dey play. Na wen Oshiomhole dey reason wit news people for the presidential villa in Abuja yesterday nia him for take talk dis one. He come talk say most politicians when shift body enter other political party after dem receive the mandate of d people dey face punishment.
Make rape and sexual abuse get tougher law
Deputy Senate Presido Ovie Omo-Agege don call again for tougher laws against rape and sexual abuse for Naija. Na wen dem dey launch the campaign against rape and sexual abuse for Abuja nia Omo-Agege for take talk dis one. He come talk say he no support d rate at which cases of rape take dey increase say rape and sexual harassment na very yeye act wen dem need to remove comot from Naija kpata kpata.
We don increase and distribute electricity for naija
The Niger Delta Power Holding Company (NDPHC) say dem don achieve increment for electricity supply and distribution infrastructure capacity for the country. Wen the company dey yarn for one statement yesterday, dem come talk say dem don build 350 injection substations with combined capacity of about 3540 megawatts (MW). NDPHC come talk say their contribution represent more than 40 percent of power requirement for the grid undermining the big debt wen d electricity market dey owe the company.
Timpre Sylva pay homage to former presido Jonathan
Timipre Sylva wen be d minister of state for petroleum lead some leaders of the All progressives Congress (APC) for Bayelsa state go the bonk of before before Presido Goodluck Jonathan for Yenagoa wen be the state capital yesterday. The group wen Sylva lead visit oga Jona less than 24 hours after the before before presido host some leaders of the ruling party plus including two governors. Wen Sylva come dey yarn during d visit, he talk say the leadership of the APC for Bayelsa decide to visit oga Jona in order to seek him support for the governor-elect. Meanwhile Candidate of the Peoples Democratic Party (PDP) for the Kogi Governorship Election, Engr. Musa Wada don talk say he no accept the conduct and result of the governorship election wen shele on November 16, 2019. Eng. Wada when make the comment for one press conference yesterday for Abuja, come talk say wetin happen for Kogi na organized war against democracy