The acting Chairmo of the Economic and Financial Crimes Commission EFCC, Ibrahim Magu don begin complain say d mumsi dem of all these Yahoo boys don begin dey organise themselves for one association. Magu, when yarn wit news people for Lasgidi come talk say d parents of these yahoo boys dey always dey give excuse for wetin their pikins dey do, say dem dey support the families wen get irresponsible parents or those wen their papa dem wen don kpai. He come talk say the EFCC no just get interest to arrest dem, but say dem dey hope to see say these children change their ways.
Senate say dem go probe NDDC because of projects
The senate don settle say dem go probe the Niger Delta Development Commission NDDC. Na d Senator wen dey represent Delta north senatorial district Peter Nwoboshi nia download dis informate give news people for Abuja. He come talk say d projects wen d commission don abandon don too much undermining the plenty osusu wen don enter the commission.
Supreme Court don throway Atiku Abubakar appeal
The Supreme Court don throw way the appeal wen Atiku Abubakar, presidential candidate of the Peoples Democratic Party (PDP) file against President Muhammadu Buhari based on d result of d February 23rd presidential election. The apex court dismiss the appeal yesterday after dem don hear Atiku suit against Buhari victory for the presidential election petition tribunal. D seven-man panel of the court come talk say dem go give the reasons for the judgement later later. Meanwhile APC chairmo wen be Adams Oshomole don hail the judges den he come say make Nigerians support the current administration and also helep to move the nation forward. Whereas Peter Obi vice wen be presidential candidate of the PDP during the election don thank Nigerians, he come still talk say the whole electoral process dey all about Naija and the future.
National assembly don send new bill for pass mark
The national assembly don send the bill wen dey seek to amend the deep offshore and inland basin production sharing contract (DOIBPSC) act go give President Muhammadu Buhari for pass mark. The legislative chamber push the amendment bill give the president yesterday mor mor and dis one na less than 24 hours after them pass am. On Tuesday, the house of representatives pass the bill when dey seek to amend the act after dem don soji the sharing formula in order to get more benefits for the federal government. The lower legislative chamber come agree with the senate on the different provisions of the bill as them don already pass am.
Trailers for roundabouts,D.S.C and P.T.I vamus fast
Authorities of Uvwie LG Council don give owners and drivers of trailers wen dem dey pack from Effurun roundabout go reach DSC round about plus including PTI road 7days ultimatum to remove dem. Wen chairmo of the council Hon. Ramson Onoyake dey yarn for one interview, he come talk say the trucks no dey only dey make d area wor wor but say he still dey block d view of people wen dey use d road and dis one so dey increase d chances of serious accident for the area. Even as Onoyake say d news wen dey play say the truck drivers dey pay money give the government no be true, he come tell business owners wen get the trailers to sure say dem pack dem within their compound say becos the council no go lai lai tolerate all dis their yeye parking again.
Contractor wey nor do road well go repair am himsef
As part of ways to take get value for d tax wen Deltans dey pay wen dey go on top road construction, Delta State Government don talk say any contractor wen do road wen no good go repair am with him own money for three years. Na the state Commissioner for Works, Chief James Augoye nia yarn dis one for one meeting wen he get with contractors and other stakeholders wen dey handle government projects for Asaba wen be the state capital. Chief Augoye come dey complain say undermining d big amount of money wen the state government dey pump put for road construction, taxpayers no dey get value for their money. Meanwhile, the Commissioner for Justice Barr Peter Mrakpor don talk say d roads wen don caput for state no dey speak well of the state government, he come talk say from now onwards dem go begin deal with engineers when approve those kind roads. Wen the state Sector Commander of Federal Road Safety Corps (FRSC), Delta State, Mr. Ocheja Ameh come dey yarn, he come beg contractors to dey involve the agency during work construction for the state so dat both human beings and motor go fit dey move well…
FG dey borrow money to tidy some kind budgets
Senate Presido Ahmad Lawan don talk say the federal government dey borrow to tidy budgets because many agencies wen dey make money for the federal govt. don begin dey perform below expectation. Wen Ezrel Tabiowo, special assistant (press) to the senate presido dey yarn, he come talk say na wen Lawan dey yarn for the third University of Benin/National Institute for legislative and Democratic Studies (NILDS) convocation ceremony nia him for take talk dis one. The senate presido come talk say d national assembly go senior up for their function and den point their torch put for revenue-generating agencies wen no dey perform well so dat dem go fit gbab those agencies wen dey error.
Wrong idea dey make us nor get support from abroad
The Minister on top Information and Culture, Lai Mohammed don talk say d wrong idea wen people for abroad get about Naija dey prevent the country from getting external support on top security matters. Na wen Lai Mohammed dey yarn for one interview wen he get with news people for Abuja nia he for take talk dis one. He come talk say need dey for Nigerians to join the government as dem dey make effort to improve the country image.
Agreement between FG and labour nor concern us
The Nigeria Governors Forum (NGF) don talk say the agreement between the federal government and organised labour concerning the new minimum wage no get anything to do with state governments. Na Kayode Fayemi wen be d governor of Ekiti state wen be d chairmo of the forum nia yarn dis one wen he dey voice wit news people after d the end of one meeting wen the 36 governors hold for Abuja. After some meetings between the federal government and labour leaders last week, dem come reach agreement concerning the implementation of the new minimum wage. Fayemi come talk say while the state governments don accept the N30,000 new minimum wage, he say each of d state governments go negotiate with their workers on the implementation and the consequential adjustments.
Fire don catch FIRS building wey dey Abuja
Fire catch for the headquarters of the Federal Inland Revenue Service (FIRS) for Abuja. According to one statement wen Wahab Gbadamosi, talk talk person of the agency drop yesterday, na on Saturday nia the fire outbreak for take happen. He come talk say d matter affect the store, where dem for take keep old files and na the annex building of the service nia dem dey.