In order to get a cleaner and Stronger Delta, the State Joint Task Force on Environment don begin seal buildings and offices wen their environment dirty and na so dem still dey remove illegal structures for Asaba, the state capital. The task force wen the Commissioner for Environment, Mr. Chris Onogba, the Director-General, Asaba Capital Territory Development Agency, Evang. Joan Mrakpor and the Chairmo, State Waste Management Board, Mr. Emmanuel Chinye lead come patrol along the major roads for Asaba to make sure say everything go well. The commissioner for environment, Mr. Onogba wen yarn on behalf of the task force, come talk say dem fire down with the exercise in order to motivate Deltans so dat dem go fit take ownership of their environment and also make sure say everywhere dey clean. The commissioner come still talk say dem go continue with the exercise for all parts of Asaba and other parts of the state, and say d government no go rest until dem realize the Cleaner and Stronger Delta Agenda of the Dr. Ifeanyi Okowa government.
Abeg pay us our 14 months salary before December
Naija retired military officers wen dey under the Coalition of Concerned Veterans (CCV) don begin beg for d payment of 14 months salary wen government dey owe dem before 31st of December, 2019. Na talk talk person of d group, Roy Oamien nia beg d beg on behalf of him people for one meeting wen dem get with the Chairmo of Military Pension Board for Abuja. Them come still beg for quick payment of their pension say becos d delays dey make am hard for some of the retirees to take care of their basic needs.
Judge Ijeoma say she dey concern over sowore
Ijeoma Ojukwu wen be the judge wen dey take charge of the case of Omoyele Sowore, leader of #RevolutionNow Movement, don talk say she dey concerned say the activist neva meet the bail conditions wen dem grant am. As she dey give ruling on top the application for variation of the bail conditions, she come talk say e dey so sad say nobody dey willing to stand as him surety on top d terms wen den give am. Meanwhile, the activist don dey for the Department of State Services (DSS) since August 3rd when dem take arrest am for Lagos.
Make FG implement national minimum wage now
Organised labour don demand say make the implement the N30,000 national minimum wage starting from April 18 2019 — the day wen President Mohammadu Buhari take sign am enter law. Na acting chairmo of the Joint National Public Service Negotiating Council (Trade Union Side), Simon Anchaver; and Seceto Alade Lawal nia make the demand for one statement for Abuja, dem come talk say dem dey make dis request in order to prevent “another round of gra gra wen dem say dem go fit avoid.” Labour come talk say dem dey hope say all sides for negotiation wen dem just conclude don learn some lessons wen go help them avoid dis kind same mistakes for future.
Need dey to amend EFCC act for anti-graft war
As part of effort to take strengthen d current anti-graft war, Sen. Utazi Godfrey Chukwuka wen be from Enugu North senatorial district don talk say need dey for d amendment of the Economic and Financial Crimes Commission EFCC act. Wen sen. Utazi dey yarn for the Floor of the national assembly, he come talk say need dey to ensure job security for chairperson of the agency. He come still talk say wit d way wen things dey now for d anti-graft body, some gbolons go fit manipulate any chairmo for the organization.
Make NCC work with service provider to reduce data price
Isa Pantami wen be d minister on top communications don tell the Nigerian Communications Commission (NCC) to work with the telecommunications service providers to reduce the price of data. According to Yusuf Abubakar wen be aide of the minister, Pantami give the regulator d order when he receive one report concerning the implementation of the ministry short-term performance targets. Abubakar come talk say Pantami say undermining the high cost of data, Nigerians no dey still dey enjoy good internet services.
We go arrange committee wey go tackle hate speech
The Minister on top Information and Culture, Alhaji Lai Mohammed say dem don arrange one committee wen go fire down wit the recommendations wen President Muhammadu Buhari approve wen go tackle hate speech and fake news. Mr. Mohammed wen yarn dis one during one meeting wen he get with online publishers for Lagos come talk say d hate speech and fake news na twins of evil wen join together and say no responsible government go just sit down den allow that kind tin to continue to dey play. He come say make online publishers support the national campaign and say make dem helep to gbege dis okamuka wen he say dey worse everyday.
Government need to provide enof security for people of Delta
Human Right Activist, Victor Orji don tell Federal and State governments plus including Security Agencies to provide enof security for the people of Issele – Azagba wen dey for Aniocha North Local government area of Delta State becos of d way wen Fulani Herdsmen take attack dem of recent and dis one so lead to the death of two persons and d kidnapping of one principal for one school for the town. Orji yarn dis one wen he dey react to the okamuka wen lead to the death of some people wen don still make life hard for the people of d town. Orji come talk say all these yeye killings need urgent attention from government for all levels.
Airtel network go fit remove Globacom from their network
The Nigerian Communications Commission (NCC) don give Airtel Networks Limited d go ahead to partially disconnect Globacom from their network. The regulatory agency say dem give the approval because Globacom no fit settle interconnect debts. The partial disconnection go make am hard for Glo subscribers to make calls go Airtel network but dem go fit receive calls from the network, where as the disconnection go start from October 28.
President Buhari don set keep meeting with Vladimir Putin
President Muhammadu Buhari go meet with Valdimir Putin, him Russian counterpart, within the week. Na Garba Shehu wen be presidential spokesman nia yarn dis one for inside one statement. Shehu say the Nigerian leader go buy waka comot from Abuja today go attend one three-day Russia-Africa summit for Sochi, Russia. Shehu come talk say the meeting with the Russian president go strengthen relations for security d more, trade and investment, and also build partnership wen go increase Naija gas potential, based on say Russia don make better success for gas exportation matters.