The Federal Government and labour for inside yesterday don finally agree for the percentage increase adjustment for workers’ salaries wen dey follow, the new minimum wage of N30,000 naira. Wen the meeting don go far the Minister of State for Labour and Employment, wen be Festus Keyamo tweet from the venue say the two parties don reach agreement. And for inside one statement, the Presido of the Trade Union Congress, TUC, wen be Quadri Olaleye, and the Secreto-General, wen be Musa-Lawal Ozigi confirm am say, both parties don agree on, 23.2 percentage increase, for workers wen dey grade-level 07, 20 per cent for those wen dey grade level 08,19 per cent for workers wen dey grade level 09, 16 per cent for those wen dey level 10 to 14, and 14 per cent for workers wen dey grade level 15 to 17.
More videos dey come out against Elisha Abbo
The police don bring out another CCTV video against Elisha Abbo wey be the senator, wen dey represent Adamawa North. Remember say dem be arrest Abbo for one magistrate court wen dey Zuba base on one-count charge onto say him beat one woman for one sex toy shop for Abuja. Wen dem start to sodji the mata again on Thursday, James Idachaba wen be the lawyer wen dey handle the case come informate the court say dem don collect another CCTV video wen carry the complete gist of how the mata take happen. He say dem go use am as additional proof of evidence, against the senator. He come inform the court say the second witness done already balance court, to testify.
Make NDDC drop report of their activities from 2001
Oga presido, Muhammadu Buhari don order say make dem give full report on how the Niger Delta Development Commission (NDDC) take operate from the year 2001 to 2019. Oga presido give dis order when he receive governors from the Niger Delta region for the presidential villa for Abuja on Thursday. Buhari come say he need to give order sake of the way wen people take dey criticize how NDDC dey run matas.
Yahoo yahoo boiz fit helep naija beta for future
The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don yarn say dem dey consider to find way to take teach Yahoo-Yahoo boys so dat dem go change their ways for the better. Ibrahim Magu wen be acting chairmo of the agency naim yarn dis one wen he dey deliver one paper for the Chartered Institute of Administration Conference, wen shele for Lagos. He say e dey see am say yahoo yahoo boys go dey useful to the agency for the future, naim make dem won teach dem so dat dem change their ways for good.
Alarm dey ring for the death of one local politician
The wicked way wen dem take kpuff one grassroot politician, wen be Taylor William Ogofugha, for inside Delta State, don begin to raise plenty dust for the State. Na for inside him house last weekend naim unknown gunmen take leggo am, for Warri South-West Local Government Area, of the state. Before dem kpuff am, him na the Chairmo of African Democratic Congress (ADC) for Warri South-West Local Government Area. He still be candidate of the political party for the 2019 House of Assembly election, for Warri South-West Constituency. As e be so, the state Commissioner of Police wen be Adeyinka Adeleke don explain say dem still dey investigate the mata. But wen the Senior Special Assistant, to Governor Ifeanyi Okowa ontop security matters wen be Ezekiel Daniel dey yarn about the mata, he call for peace and say make dem allow the police to carry on with their findings.
Lacazette don rotate from injury con give Arsenal boost
Alexandre Lacazette don returned to full training and he fit make him Arsenal comeback as early as on Monday’s to Sheffield United. Lacazette wen be striker don missed Arsenal’s last seven games base on say him wonjor. The 28-year-old done dey struggle with the issues for plenty weeks before Arsenal come confirm the matta for the middle of September say them need to take am comot from the firing line.
JAMB go use national identity number as from next year
The Joint Admission and Matriculation Board don say them nor go register students wen wan write their exam, the Unified Tertiary Matriculation Examination, if them never get their National Identity Number (NIN). JAMB yarn this matta for tweeter on top their verified Twitter handle wen be @JAMBHQ. Them come talk say if person not get NIN, make e nor apply at all. This one so go start with the next year JAMB, for 2020.
We go find way put people informate for one place
The Nigerian Immigration Service say dem don dey find way to put everybody informate for one place. Na the Comptroller-General ontop immigration, wen be Muhammad Babandede nia talk dis one wen im dey yarn about the immigration budget with the Senate Committee wen siddon ontop Interior matter, for Abuja. He come say the service don make sure say passport now, go dey carry the National Identity Number (NIN),and Bank Verification Number (BVN) of the person wen apply for am…
FG go soon add levy ontop made in naija goods
Zainab Ahmed, wen be the minister of finance, says the federal government dey consider to introduce levy ontop soft drinks. The minister yarn this matta when she dey address news people for one meeting wey Oyinbo and bank people attend. This levy so na money wen them one put ontop the goods wey dem go produce and sell locally.
FG go take care of soldier wey kpai against boko, family
Oga presido Muhammadu Buhari don yarn say the Federal Government go do everything possible to take care of the families of the soldier wen leggo for the fight against the boko haram jaguda. Oga Presido yarn dis one wen he dey launch the 2020 Armed Forces Remembrance Day logo and appeal fund for Abuja. He come say na the duty of the government to make sure say the families of the soldiers wen delete nor go hunger and suffer.