Na about 393 children nia involve for accidents towards the end of the year 2018. For d release wen the Federal Road Safety Corps FRSC drop dis past weekend, dem say 29 of the children kpuff on top d matter. In total, the FRSC say 275 persons nia kpuff during the end of year special patrol for 2018
Darmian wan buy waka
Manchester United full-back Matteo Darmian go soon buy waka comot from the club and den he go come join Juventus on loan. E clear say the 29-year-old go sign for the Old Lady for £3 million and the short-term deal go fit dey permanent next summer as him contract for United go surely expire. Darmian addition go still also allow Juve defender Leonardo Spinazzola kawasaki comot for Bologna on loan.
Lottery win palava
One 27 year-old man wen him name na Emmanuel Okachi don lose one eye even as he dey find spiritual powers so dat he go fit dey win lottery games wen we dey popularly dey call ‘Baba Ijebu.’ Okachi go meet one babalawo for Ishiagu village, near Ogwashi-Uku for Delta State to help am so dat he go fit dey see lucky numbers. Osita Uzoka wen be friend of Okachi come clear the News Agency of Nigeria yesterday for Ogwashi-Uku say na on Jan. 12, 2019 nia d matter for take happen.
Obasanjo Blast Buhari
Before before Presido Olusegun Obasanjo blast President Muhammadu Buhari yesterday den he come say Buhari administration na d same tin as the era of the late before before Head of state, Gen. Sani Abacha. Obasanjo yarn dis one for him 16-page statement wen he title Points for concern and action, wen he release give news people for Abeokuta. Obasanjo come talk say dis administration dey use security agencies take dey gbege anybody wen dey attack dem and opponents of the government and say dem still dey cause wahala for our democracy .
Minimum wage still under consultations
The Federal Government don set to present the N30,000 new National Minimum Wage proposal give the National Economic Council by tomorrow for more consultations. This one nia be d koko wen dem agree on for one extraordinary meeting wen the Federal Executive Council hold wen end yesterday night for Abuja. Na State governors, the Central Bank of Nigeria and some major Ministries and Departments and Agencies of government nia make up the NEC. The Central Bank of Nigeria CBN say dem receive information say 36.6 million Nigerians no get access to financial services. For one statement wen d bank release give news people, dem say dem go host one conference for national financial inclusion stakeholders for Naija. The conference wen dey aim to facilitate the 80% financial inclusion target, dey scheduled to hold on Thursday, January 17 and Friday, January 18.
Kane Injury take style serious
Harry Kane go miss nothing less than 6 games based on say he get ankle ligament injury. Yesterday, d Spurs confirm am say their star man no go return to training until the beginning of March after one scan show say he get injury for him ligament after one last-minute challenge from Phil Jones for d game wen Manchester United for take beat dem one kondo on Sunday. This one mean say Kane fit no return to first-team action until mid-March if e too early well well.
EFCC nor raid my house
The Chief Justice of Nigeria, CJN, Justice Walter Onnoghen, don talk say d news wen dey play say operatives of the Economic and Financial Crimes Commission, EFCC raid him house yesterday no be true. Wen Senior Special Adviser to the CJN on media, Mr. Awassam Bassey, dey react to the report wen dey play for different social media platforms, he come talk say d news na fake. Meanwhile, many social media users wen share the story say d post come from the former Minister of Aviation, Chief Femi Fani-Kayode.
Make PDP work together to win
With about 30 days to d Presidential elections, Delta state Governor Dr. Ifeanyi Okowa don tell members of the Peoples Democratic Party (PDP) say make dem work together so dat dem go fit win for d elections. The governor yarn dis one during PDP campaign rallies wen shele for Issele-Uku, Akwukwu-Igbo and Asaba. The governor wen him wifey, Dame Edith, him running mate, the deputy governor and other top politicians escort come talk say with unity and cooperation, the PDP go win for all the elections wen go happen on February 16 and March 2, 2019 For Issele-Uku, he say make leaders and youths work together, say na the turn of Delta North to complete their two terms. For Akwukwu-Igbo, he say make the people no do orukuruku for d elections, say becos chance no go dey for rigging, he come advise the electorate say make dem do better close marking on top the elections because, their votes must count. For Asaba, Okowa come talk say he gather confidence say he go return unopposed say him main opponent go fit even join him campaign train.
Cech retiring na big loss to football
Jose Mourinho don talk say four-time Premier League winning goalkeeper Petr Cech go be “big loss” to football. The before before Manchester United and Chelsea oga say he dey proud as he take manage one of the modern game best goalkeepers, when announce yesterday say he go retire by the end of this season. Mourinho and Cech ball enter Chelsea for the same summer of 2004 – and na so dem win the Premier League title for their first season for England.
BBN: naija na the host
The organizers of Big Brother Naija (BBNaija) don talk say na for Naija nia d number four edition of d show go for take hold. During the second season of the show, Alhaji Lai Mohammed, d minister on top information and culture direct the National Broadcasting Commission (NBC) to investigate why e be say na for South Africa nia d show for dey hold. The minister talk den say make the NBC determine whether Multichoice breach d Nigerian Broadcasting Code even as dem dey shoot the show for South Africa. But during one press conference wen shele yesterday, the organisers say auditions for the fourth season go hold on February 1st and 2nd.