Henry Nwosu don tell Nigeria national team coachee Gernot Rohr to win the 2022 Africa Cup of Nations title for Cameroon if he want make dem regard am as one of the best tacticians for the continent. The three-time Africa champions cement their place for the continental competition with two games to spare after Lesotho and Sierra Leone play draw for matchday five. Under Rohr, Naija don qualify for two Africa Cup of Nations tournaments back to back since them fail to reach the competition for 2017.
Oil Spill: Ugeh-Gbene community para follow Chevron
The people for community of Ugeh-Gbene for Kokodiagbene town, Gbaramatu Kingdom wen dey for Warri South-West Local Government Area wen oil spillage don affect bad bad don talk say dem no like d way wen Chevron Nigeria Limited take dey handle d mattee of the oil spillage from their Utonana flow station when happen since 18 February 2021. For one letter wen d Chairmo of the community, Engr. Johnbull Tortor; their Seceto Engr. Gabriel Ukuli sign, the people come dey complain about the way wen dis matter don take affect their livelihood and health. Them come still complain about d I don’t care attitude of Chevron Nigeria Limited towards wetin dem dey pass thru. Other communities wen d matter still affect too alongside Ugeh-Gbene include Ede-uba,, Igho-suogbene, Jones Creek and some others for Gbaramatu Kingdom and like dis Chevron Nigeria Limited neva gree compensate the people.
#EndSARS: We no fit confam weda people die for lekki tollgate-US
US Department of States don talk say dem no fit confirm if #EndSARS protesters kpeff on October 20, 2020 for the Lekki tollgate. The US department yarn dis one for one report wen dem tag ‘2020 Country Reports on Human Rights Practices: Nigeria’. The report say although soldiers release bullets enter air to pursue d protesters, dem say dem no fit really verify the number of people wen denkwes.
Committee don summon Ehanire and Adebayo
The Senate joint committees on Health and Industry Trade and Investment, don summon the Ministers of Health and Trade and Investment – Osagie Ehanire and Niyi Adebayo becos of d syringes and needles wen d country dey export from China and India undermining d policy guidelines wen dey against am for Naija. The committees don still summon the Director-General of the National Agency for Food and Drug Administration (NAFDAC), Mojisola Adeyeye. The Senate for inside d month of February, complain say majority of the imported syringe dem and needles dey below standard and say all dis syringe na wetin dem dey rewash from the Asian continent, and na all these things dem dey import dey enter the country make we dey use.
Relax,petrol go boku for Easter-Paul Osu
The Department for Petroleum Resources (DPR) don tell Nigerians say make dem kpror make dem no dey tensh say enof supply of petroleum products go dey before, during and even after the Easter. Na Paul Osu, d Head, Public Affairs, DPR nia drop dis yarnings for inside one statement wen he tender on Wednesday for Lagos. Mr Osu wen talk say product boku for d whole country, come advise marketers say make dem no dey hide d product come dey make am look like say e dey scarce.
Lagos police go use Body Cam- Sanwo-Olu
Babajide Sanwo-Olu wen be d governor of Lagos state don roll out the plan for law enforcement officers for the state to dey use body cameras. The governor announce the plan to train the law enforcement officers on Tuesday.According to am, na d Lagos state Law Enforcement Training Institute (LETI) nia go train d officers.
Na d plenty guns for Naija nai make insecurity dey worse-Ishmeel Ahmeed
Senior special assistant to the president on intervention, Ishmeel Ahmeed don talk say d current insecurity wen dey play for the country na as a result of d plenty fash dem wen don dey for d country for over the years. Wen Ahmed dey yarn on Wednesday for Abuja during one interview, he come talk say he gather d belief say security outfits for the country go soon tidy the situation but he come still talk say d work no go easy sha. He come still blast senate minority leader Eyinaya Abaribe wen talk say president Muhammadu Buhari no go fit handle the security challenges wen dey play for d country.
Our recruitment dey follow federal character-Army
The Nigerian Army don talk say dem dey strictly dey follow the federal character principles for their recruitments. The army yarn this one on Wednesday for one statement thru their talk talk person, Mohammed Yerima, wen be brigadier general. He make d statement wen he dey react to one online newspaper publication wen talk say na d north nia dem dey always dey favour against the south during recruitments. Mr. Yerima come talk say dem give all the 36 states d same number of slots except for states when their candidates no meet the requirements.
Bayelsa give MACBAN two weeks quit notice
The Bayelsa State Livestock Management Committee don give two weeks ultimatum to the Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria (MACBAN) and other operators to remove their nama nama comot from Yenagoa, the state capital, and around. Na Chairmo of the committee and Commissioner for Agriculture and Natural Resources, David Alagoa nia yarn dis one for one interview wen he get with news people after one meeting between the committee and some South-south chapters of the MACBAN on Monday. Alagoa come give warning say if d time wen dem give MACBAN don expire, he say d committee go seize their malu dem becos dem no go tolerate their movement wit leg either for night or for the day for the state.
Make una get faith for better Naija- Buhari
President Muhammadu Buhari don tell Nigerians to keep d faith for the promise of a great Nigeria. Mr Buhari yarn dis one on Monday wen he dey yarn for Bola Tinubu gbedumentation. Oga Bubu come tell leaders, policy makers and individuals wen mark present for d occasion to begin to develop ways to contribute to the development of the country.