The Senate don tell oga Presido Muhammadu Buhari again to declare state of emergency on security without any more delay. The red chamber make d call after Senator Sani Musa wen dey represent APC, Niger East raise d motion based on the way wen bad guys take kidnap students and staff of the Government Science Secondary School for Kagara, Niger State on Wednesday early mor mor. Musa wen talk say the winchi winchi dem wen kidnap d people nod military uniforms come talk say dem no know d actual number of students wen d bad guys dem kidnap say the school get more than 1000 students.
We go do everything possible make dem release d victims-Lai Mohammed
The federal Government say measures don already dey in place to make sure say them release the students, some staff and members of their families wen bad guys kidnap for Government Science College Kagara. Na d Minister on top Information and Culture Alhaji Lai Mohammed nia yarn this one when he lead the Federal Government group go the State to go get firsthand information about wetin really happen. Mohammed come talk say dem go do everything possible to make sure say all d kidnapped victims return safely. Wen one security expert Oyekachi Adekoya come dey yarn on top d matter, he come talk say need dey to review d current security situation for the country. He come talk say some bandit groups don transform enter terrorist organizations.
1 Bitcoin don jam $50,000
The price of Bitcoin don hit $50,000 for the first time in history. The cryptocurrency don dey for the spotlight recently; after e receive endorsements from Elon Musk, Tesla CEO, and Mastercard. This one so dey happen after the Central Bank of Nigeria of recent direct banks and other financial institutions to close accounts of people or groups wen get anything to do with cryptocurrency transactions.
Naija Army don dey accept applications
The Nigerian Army don begin dey accept applications for their 81 regular recruits intake for trades/non tradesmen and women. The registration site open on Monday, d 15th of February. Meanwhile, the Nigerian Air Force (NAF) don make announcement say registration for their Airmen/Airwomen recruitment exercise (BMTC) go start on March 2, 2021. Dem come advise applicants to apply once, say becos dem go disqualify plenty online applications and dis application dey close on March 30.
Herdsmen learn kidnapping from Niger Delta militants
Ahmad Gumi, one ogbonge Islamic cleric don talk say herdsmen learn kidnapping from Niger Delta militants. Wen Gumi dey yarn on Tuesday during one interview, he come talk say na just about 10 percent of Fulani herdsmen nia be criminals. He say if the government yarn wit d herdsmen, them go assist go flush out the criminals wen dey among them. Meanwhile, Gumi so don dey press for amnesty for bandits.
FG scrap charges ontop human rights filing
The federal high court don scrap all charges wen dey attached to filing cases wen get to do wit fundamental human rights. Them drop dis notice for one circular wen Jane Egbo, assistant chief registrar (litigation) sign, den dem come paste am around the Abuja court premises on Tuesday. The development so mean say change don dey for the enforcement of human rights for Naija unto say e go help d country courts dey fit dey prosecute more cases.
Federal government go put CCTV for Highways- Dingyadi
Muhammad Dingyadi, d minister on top police affairs don talk say the federal government go put closed circuit television (CCTV) cameras for major highways for across the country to end all dis cases of kidnapping wen dey carry dey increase for d country. Wen Dingyadi dey voice on Tuesday for Abuja, he come talk say President Muhammadu Buhari dey revive all the abandoned CCTV project in order to address the security challenges wen dey play for the country say the federal government don enter one agreement with NPS technology company to refix the abandoned project. He come still talk say people go fit share ideas wit the police and say dem dey open to partnerships wen go increase intelligence for the service.
Delta state: Robbers fail as dem wele bank
The attempt wen suspected armed robbers make to attack one new generation bank for along the Market Road for Ughelli, Delta State, on Monday no work. The matter wen come make gunshots dey cry for the area happen less than 24 hours after one gang of gunmen kpuff one police inspector for the Oviri-Ogor road axis of the town and na so dem carry him rifle take. All banks wen dey operate for within Ughelli axis wen close by 2pm becos of d way wen insecurity take dey increase for the town come still shut down operations becos of d matter wen play.
Oya investigate the mata- Sanwo-Olu tell police commissioner
Lagos State Governor, Mr. Babajide Sanwo-Olu don direct the state Commissioner of Police, Hakeem Odumosu to start investigation concerning the harassment of some protesters when our olokpa dem arrest during last Saturday protest for the Lekki Tollgate wen get K-leg. Na the Commissioner for Information and Strategy, Mr. Gbenga Omotoso nia yarn this one on Monday for one media briefing wen the Management of Lekki Concession Company, LCC organize to clear the air concerning some reports wen dey play for the media as regards the protest. Na some group of people wen dey parasid nia carry out d protest wen no see front becos d judicial panel of inquiry wen dey soji the #EndSars protest of October 20, 2020 and other alleged police brutality for the state give d go ahead for the reopening of the toll gate. You go remember say d kpokpo dem arrest 40 protesters, including star comedian, Debo Adebayo wen area know as Mr. Macaroni and na so dem carry the protesters go one Lagos Mobile Court, within the premises of Criminal Investigation Department CID, Panti before dem come give dem bail.
Criminal herdsmen dey face trial-FG
Based on d plenty talks wen dey go on say President Muhammadu Buhari no dey handle the farmers/herders’ gbege for the country well, the Presidency don talk say many criminal herdsmen dey face trial for across the country. The presidency come still dey challenge d Force Headquarters to publish names of herders wen dem dey prosecute so that Nigerians go really dey convinced say dem dey make efforts to deal with the problems wen the herders dey cause. Meanwhile on top dis tin wen the Presidency yarn, the Nigerian Bar Association, NBA, the Pan-Yoruba socio-political organisation, Afenifere, the Pan-Niger Delta Forum, PANDEF don talk say no be true. While the Northern Elders Forum, NEF, say dem no know anything about d trial of criminal herdsmen for anywhere for the country, the Middle Belt Belt Forum, MBF, and Benue tribal leaders come tell the Presidency to start with the trial of Miyetti Allah leadership to really convince Nigerians say dem dey serious about dealing with the criminal herdsmen.