One survey wen the Independent Corrupt Practices and Other Related Offences ICPC carry out show say na estimated N9.4 billion bribes nia exchange hands for the judicial sector between 2018 and 2020. The report say the level of corruption for the justice sector increase becos of the high amounts of money wen lawyers dey offer as bribes give judges wen dey handle high electoral and political cases.” The 84-page survey come still show say na the private sector nia carry second next to the judicial sector for corruption levels, say d corruption for d private business sector contribute much to the national level of corruption.
I no understand why coronavirus no high for Africa-Bill Gates
Bill Gates, co-founder of Microsoft and Bill and Melinda Gates Foundation (BMGF), don talk say he no understand why coronavirus numbers neva still dey high as dem take say e go high for Africa. Gates and him wifey Melinda, talk before now say dead bodies go boku for the streets of Africa if the world not act fast enough. But for Bill Gates end of the year note, he come talk say he dey happy say wetin he predict about Africa neva happen.
Senate don summon defense minister and service chiefs
Based on d way wen insecurity take dey carry dey swell up for the country, the Senate don summon the Minister of Defence, the service chiefs, heads of the Nigerian Police Force plus including the Department of State Service. The house take d decision based on d motion wen Senator Bello Mandiya from Katsina State raise becos on the about 330 students of one secondary school wen bad guys kidnap for the state recently. The red chamber come still tell President Muhammadu Buhari, to fire down wit the report of the Senate Committee on Security challenges without any more delay. Meanwhile, Security expert and Director General of d institute of professional security, Toney Ofoyetan don give warning say our politicians must separate security matters from politics for Naija to fit tackle dis issue of insecurity.
Restructuring for Naija fit dey hard-Uduaghan
Before before governor of Delta state Dr. Emmanuel Uduaghan don talk say to achieve restructuring for Naija fit dey hard becos of d lack of understanding and d different views wen people get about dis restructuring. Uduaghan yarn dis one for one radio interview for Lagos. According to am, the word “restructuring” mean different things to different people depending on their background and he say dis one come make am hard for people to reach one common ground on wetin we really need to restructure.
Delta State government don approve payment of 2019/2020 bursary
The Delta State Government don approve the release of pepper for the payment of the 2019/2020 Students’ Special Assistance Scheme, wen dem dey call bursary, for students wen come from the state for tertiary institutions for across the country. The Commissioner for Information, Mr. Charles Aniagwu wen yarn dis one for inside one statement on Tuesday for Asaba come talk say the payment go start before the end of the week. He say the continuous payment of the bursary to Delta State students even with the economic hardship for the country don show more say Governor Ifeanyi Okowa dey committed to d human capital development of the state.
Carragher, Owen and Ferguson pay tribute give Gerard Hoillier
Jamie Carragher, Michael Owen and Sir Alex Ferguson don lead tributes for French football manager Gerard Houllier, wen kpuff at the age of 73. The before before Liverpool oga wen guide the Reds go the FA Cup, League Cup and UEFA Cup treble for d year 2001 get long history of medical problems den he come kpeff three weeks after he undergo surgery for Paris. Ferguson come hail Houllier say him na ‘true gentleman’ with ‘corrector football knowledge’.
WAEC go block students wen do expo
The West African Examinations Council WAEC don approve say dem go block students wen involve for examination malpractice make dem no take the West African Senior School Certificate Examination. This informate dey for one press release wen dem drop after the 70th Meeting of the Examination Committee of WAEC, when be the highest decision making organ of the council on top examination-related matters. Dem come talk say them go ban d candidates wen d matter affect for some number of years and d matter sef touch some supervisors too.
Katsina kidnap na slap for presido face
The Sultan of Sokoto, Alhaji Muhammad Sa’ad Abubakar d III led Jama’atu Nasril Islam (JNI) don talk say these many students wen some winchi winchi dem kramp from Government Science Secondary School (GSSS) for Kankara, Katsina state na big slap for President Muhammadu Buhari face. The JNI come talk say the way wen d bad guys take gather mind go kidnap d students d same day wen Mr. President take ball enter Katsina State on top one private visit don really show say dem dey tell him Government say na tranga dem dey tranga say dem no reach. For one statement wen d group drop on Monday through their Secretary-General, Dr. Khalid Abubakar Aliyu, dem come tell President Muhammadu Buhari to listen to the voice of Nigerians and den rearrange the security pattern, say make dem no dey do ‘I too know’.
Stop to dey make noise-Maliafia tell Naija Army
Before before Central Bank of Nigeria (CBN) Deputy Governor Dr. Obadiah Mailafia don tell d Nigerian Army make dem stop to dey make noise den make dem do everything possible to release the school boys wen some bad guys kidnap last week Friday from the Government Science Secondary School, Kankara, Katsina State. Dr. Mailafia wen yarn dis one on Monday for one interview come talk say d matter dey very unfortunate, say d government must treat d people wen dey responsible for d kidnap as terrorists because dem be enemies of the state.
Kpokpo arrest Omah Lay and Tems for Uganda
Kpokpo for Uganda don arrest naija musician Omah Lay and Tems for kampala inside Uganda. Omay Lay and Tems sing for one concert for Speke Resort for Kampala on Sunday. According to the kpokpo for Uganda, dem break the covid-19 rules. The Assistant oga of Police and assistant Police toktok person, Kampala Metropolitan Police confirm the gist for twitter yesterday. For one side, Omah Lay con tweet say dem don handcuff am like this with Tems for Uganda.