The Nigerian government don talk say dem dey work on how to take change wetin get to do wit d way wen Nigerian economic take dey drop and dis one na according to the Minister of Finance, Budget and National Development, Zainab Ahmed. Wen Mrs Ahmed come dey respond to the latest gross domestic product figures wen the National Bureau of Statistics NBS release wen show say for now, Naija dey for their second recession for inside five years, she come talk say them go restore d economy for the path of sustainable inclusive growth very soon wit d use of the Nigeria Economic Sustainability Plan. She come talk say the country expectation of quick comoting from recession go really fast because of the different interventions wen the government introduce wen dey work well.
FG go stop fish importation for 2022
The Federal Government don talk say dem get plans to end fish importation for the next two years, say dem don already order fish importers to reason farming and production locally. Na wen d Minister of Agriculture and Rural Development, Sabo Nanono, dey yarn for the 35th Annual Conference of the Fisheries Society of Nigeria foe Abuja on Monday nia he for take talk dis one. He come talk say the regime wen the President, Muhammadu Buhari dey lead dey implement programmes, especially for the agriculture sector to diversify the economy.
Court send Sen. Ndume go jail
One Federal High Court for Abuja don give order say Senator Ali Ndume (Borno South) need to dey for Kuje correctional centre. Na Justice Okon Abang nia make the order on Monday after Ndume fail to produce Abdulrasheed Maina, when dey stand trail before the court on top money laundering charge and na Ndume nia stand as surety for am. Justice Abang come talk say as he no fit produce Maina wen jump bail and wen neva show reason why he bail bond no go turn govt own, come talk say he must meet either of the three conditions before dem go release Ndume
I no know say Army HQ say the Lekki Shootings na fake news- Brig. Gen. Ahmed
Brig. Gen. Ahmed Taiwo, Commander of the 81 Division, Military Intelligence Brigade, Victoria Island don talk say he no know say the Nigerian Army Headquarters describe the shootings wen play for the Lekki Tollgate as “fake news” for Twitter. The News Agency of Nigeria (NAN) report say Taiwo drop dis yarnings dis past weekend wen dem dey ask am questions for the Lagos State Judicial Panel of Inquiry for Restitution for Victims of SARS Related Abuses and Other Matters. Wen Taiwo come dey answer questions from Mr Adeyinka Olumide-Fusika (SAN), the lawyer for some of the #EndSARS protesters, he come talk say he no know say d headquarters of the Nigerian Army deny d matter because he no get twitter account.
Okowa: We go fire down with Orere Bridge
Governor Ifeanyi Okowa don talk say the state government go fire down wit the construction of Orere bridge for Ughelli South Council Area for d year 2021. Okowa when yarn this one on Sunday for one thanksgiving service for Ughelli come talk say dem dey work on plans to construct the bridge, when go link Orere community with other parts of the local government area and the state, and say dem don make provision for am for the 2021 Budget of the state. The governor, when take the first reading for the service come advise Christians say make dem get faith in God if dem know say dem wan achieve anything for dis life.
NNPC: We spend N81.41bn for refinery, we no refine any crude
Latest data wen the Nigerian National Petroleum Corporation NNPC drop show say na a total of N81.41bn nia dem spend on top Naija refineries between January and August this year but the facilities no refine any drop of crude oil all through this period. Kaduna Refining and Petrochemical Company, Port Harcourt Refining Company and Warri Refining and Petrochemical Company post total revenue of N6.54bn during the eight-month period. With revenue of N6.54bn and total expense of N81.41bn, the facilities end up with shortage of N78.87bn, according to figures wen dey for the August 2020 report of the NNPC wen dem just release.
We need to pass petroleum industry bill for naija-Omo Agege
Deputy Presido of the Senate, Ovie Omo-Agege don talk say Naija need to pass the Petroleum Industry Bill (PIB) as soon as possible to make sure say the country get the maximum benefits from their petroleum resources before them dry up. Experts say Crude oil, when dey contribute almost 80 per cent to Naija gross domestic products (GDP), go dry up in the next 30 to 40 years. With breakthrough for technology wen dey help to dey discover cheap and more reliable alternative to crude oil, Mr. Omo-Agege com say the Nigerian government need to move sharp sharp to clear the issues wen dey make am hard for dem to explore, produce and sell their crude oil while the market still dey there.
Women wen husband put for cage over 3 years don dey free
One woman wen born eight children wen her name na Gladys wen her husband, Ame Edjeketa accuse say na winchi winchi come cage her for more than three years don get her freedom for d Orerokpe, Okpe Local Government Area of Delta State. Gladys gain her freedom dis week and she dey receive treatment for one government hospital. According to report wen dey reach us, Gladys husband still dey doke her for where he cage her put and na for that bondage nia she for take born three out of the eight children. Meanwhile, olokpa dem don arrest her husband.
Police arrest taxi driver because he ask for transport money
One taxi driver for Ogun State, Mayowa Ayodele, don narrate how police officers for the state take arrest am illegally for seven months because he ask of transport fare from the officers. Mr. Ayodele narrate wetin he pass thru give the Ogun State Judicial Panel of Inquiry wen dey investigate cases of police brutality for the state capital, Abeokuta, on Wednesday. He say four police officers charter him motor on March 7, 2018, dem no come gree pay. When he come dey ask dem for him money, dem come arrest am and den later charge am to court say he dey burst pipeline. He come talk say the officers wen do dis rubbish nia be Buhari Yusuf, Ehimere Anthony, and two others wen he no fit remember their names.
Delta State Judicial Panel of Inquiry go sit down for Warri on Monday 23rd November
The Delta State Judicial Panel on Police Brutality and Extra-Judicial Killings go start public sitting for Warri from Monday 23rd November 2020. The Seceto of the body, Omamuzo Erebe Esq. wen yarn wit news people for Asaba come talk say the venue na Unity Hall, Governor’s Office Annex Warri and na 10am on d dot dem dey start. Erebe come tell people wen get case and their lawyers say make dem take note of the date and say make dem come the venue of the public sitting with their witnesses. Meanwhile, d panel come still advise members of the public call the secretariat of the panel on the following phone numbers , 09150370329 or 09011307117 for more informate.